TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Viral video wey pipu dey shout ontop Kwara govnor na from 2018
Share
Latest News
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Shin Tinubu ya halarci makaranta daya da Alexander Zingman? Ga abin da muka sani
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Viral video wey pipu dey shout ontop Kwara govnor na from 2018

Claire Mom
By Claire Mom Published August 17, 2022 3 Min Read
Share

One video wey pipu dey vex use shout for Abdulrahman Abdulrazaq, govnor of Kwara state, don comot for internet.

Di pipu vex sotey dem call di govnor “Ole”, wetin Yoruba pipu dey call tiff. Na shout dem use comot am from one event.

Pipu wey share di video claim sey di kasala never tey. Dem sey e hapun wen di govnor and some members of di ruling All Progressives Congress (APC) visit Kwara state polytechnic for rally.

Na for Peter Obi Support Group, one Facebook page, dem share di video. Di post get pass 2,600 views.

Anoda page, Nigeria Youth Movement, folo share di video come write: “Pipu wey comot from APC go PDP wey dey sing ‘Sai Buky Bukola Saraki’ don pursue Kwara state govnor.”

Even YouTube, WhatsApp and TikTok carry di video.

E-vibez TV, one YouTube page wey share di video, tok sey Abdulrazaq bin dey try campaign for 2023 re-election. Pipu don watch dat video pass 7,900 times.

Wetin we check

TheCable cari di video check for InVID, di beta internet tool show sey di first time wey di video comot for YouTube na 2018.

Di video first comot for Kwara Gist, one YouTube page, on December 26, 2018. Dem write sey: “Area scata for Ilorin for di 53rd annual apolitical gathering of Ilorin Emirate Progressive Descendant Union (IEPDU), wen pipu wey dey support di Senate President, Dr. Bukola Saraki sscata di event.”

On August 9, di Kwara state govment shake body ontop di video for statement for dia confam Facebook page.

Bashir Adigun, special adviser for political communication to di govnor, sign di statement wey tok sey: “Fake video ontop govnor AbdulRazaq head: Rememba wen Kwara dey pass thru kasala.”

Adigun tok sey di video comot on December 26, 2018, wen agbero and pipu wey dey support Bukola Saraki, former senate president, close eye scata di event wey IEDPU organise.

Adigun tok sey di video na wen Abdulrazaq bin still dey contest for govnor and im attend di event as special guest of im village. 

Im tok sey notin bin hapun for di Kwara polytechnic on August 7, 2022, wey for make di govnor go show for di place.

“All those pipu wey post dat video evriwhere, dia body just dey scratch dem to show sey pipu dey vex for di govnor,” na so Adigun tok.

Final tok

Di video wey dey evriwhere wey pipu dey vex and shout ontop Kwara govnor no get head. Dat video na since 2018, no be new one. 

TAGGED: Abdulrahman Abdulrazaq, APC, bukola saraki, Fact Check, Ilorin, Kwara State University (KWASU)

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 17, 2022 August 17, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?