TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show as Nigerian, French army dey offload supplies na from 2013
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show as Nigerian, French army dey offload supplies na from 2013

Claire Mom
By Claire Mom Published December 28, 2024 3 Min Read
Share

One video wey show as Nigerian and French soldiers dey offload supplies with attention don go viral for social media.

Di video comot di same time as pipu dey try understand di real tin wey join France with Nigeria.

Inside statement on Thursday, Mohammed Idris, minister of information and national orientation, deny di claims sey Nigeria don give parts of di kontri to France.

Di minister make di statement afta accusations begin comot sey Nigeria bin dey join head with France to scata Niger Republic wit terrorism.

Some weeks before, Mahdi Shehu, one pesin wey dey comment onto public affairs and politics mata, claim sey plans bin dey to build French military base for di northeast afta Femi Oluyede, chief of army staff (COAS), bin reportedly welcome French soldiers for di kontri.

Howeva, di defense headquarters tok sey di accusations dey “baseless”.

Ontop di statement wey di minister make on Thursday, Shehu tell am sey make im stop dey deny di mata.

For di video wey folo di post wey im don delete, engine bin dey sound for back as Nigerian army bin dey offload sacks of supplies, including bags of rice, from moto, while French soldiers bin dey unload aircraft from one cargo plane.

Vehicles dey pass as uniform pipu bin dey move around wit dia boots for ground.

Two buses, one wit French flag, come later cari di army pipu.

For di video, one Nigerian soldier tok sey di army pipu bin just dey comot from di peacekeeping centre where dem train dem for counterterrorism.

Howeva, TheCable discover sey di video don dey online since January 2013.

Di Associated Press (AP) report sey di troops bi part of military mission from di Economic Community of West African States (ECOWAS) to help di peacekeeping operation for di region.

“Na 156 Nigerians, 100 Togolese, 25 from Benin, and 25 others (from Benin) wey dey come dis night,” one French colonel, according to di AP, tok for di video.

Di troops bin just arrive for di Senou International Airport, Bamako, Mali— one of di kontris wey di peacekeeping mission bin suppose operate.

TAGGED: ECOWAS, France in Nigeria, French army, News in pidgin, Nigerian Army

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom January 3, 2025 December 28, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?