TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey dem arrest former Gabon senate president don tey
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey dem arrest former Gabon senate president don tey

Claire Mom
By Claire Mom Published September 9, 2023 4 Min Read
Share

One Facebook video wey show as some officers dey open briefcase wey full wit moni claim sey di former Gabon senate president bin dey try run comot for kontri afta di coup. 

“Breaking News: Dem arrest di former senate president of Gabon wit plenti moni as im dey try escape from im kontri,” na so dem write for di Facebook post.

Di name of di account wey share am na Nigeria News Updates, and e don gada pass 1.5 million views, 3.2k comments and 12k likes.

Di video wey comot evriwhere for different social media platforms like WhatsApp, X, and TikTok show some officers togeda with normal civilians as dem dey try open some briefcases wey full with moni.

Dem write BEAC ontop di bundles of moni, meaning Bank of Central African States.

Dem dey use di BEAC inside six Central African kontris wey be di Economic and Monetary Community of Central Africa. Di kontris na; Cameroon, Gabon, di Central African Republic, Chad, di Republic of the Congo, and Equatorial Guinea.

Di BEAC official currency na Central African franc (CFA).

GABON COUP

Gabon, one of di main kontris for Africa wey dey produce oil, join di Commonwealth in June 2022, even as na France bin colonise dem. About 90 percent of di Central African nation dey covered by forest.

On August 30, army officers for Gabon comot President Ali Bongo for office afta im win im third term re-election.

Di coup d’etat for Gabon end di 55 years wey Bongo and im family don sidan for president office.

Di military for Gabon tok sey na Brice Oligui Nguema, one general, be dia leader. Dem put di president wey dem comot for house arrest, come arrest im son for treason.

“We don decide sey we go put peace for front end di current govment,” na so one of di soldiers tok for Gabon 24, one television channel.

During di national broadcast wey show twelve soldiers, di military announced sey dem go cancel di election result wey di opposition tok sey no correct, come add sey dem go cancel “all the institutions of the republic”.

On September 7, eight days after dem comot Bongo for office, di army release am sake of “im health”. Inside statement wey Ulrich Manfoumbi, chief informant of di military, tok for national television, im sey: “If im want, im fit travel go outside kontri for checkup.”

WETIN WE CHECK

TheCable check different keyframes of di video for reverse image search inside Yandex. Di search show sey dem record di video in 2022.

Dem record di old video wen dem arrest Guy Nzouba-Ndama, former senate president and opposition leader, for di kontri border as e dey come back from Congo with currency wey bin reach around two million euros.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey di video dey shows as Gabon former senate president dey try escape from di kontri sake of di coup no correct. Dem record di video one year before di military takeover.

TAGGED: Fact check pidgin, Gabon, Gabon coup, Pidgin news

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom September 9, 2023 September 9, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?