TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, paracetamol no get Machupo virus
Share
Latest News
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, paracetamol no get Machupo virus

Claire Mom
By Claire Mom Published August 21, 2023 4 Min Read
Share

One message wey dey go round WhatsApp don advise pipu sey make dem stop to swallow paracetamol wey dem write P/500 ontop.

Di message warn sey di drug get Machupo virus inside and anybodi wey swallow am go catch infection.

“Shine ya eye make you no go do mistake swallow paracetamol wey dem write P-500 ontop. Na new paracetamol wey dey shine come white wella, doctors advice sey e get “Machupo” virus, one of di most dangerous viruses for di world, wey dey kpai pipu like water,” na so di message tok.

Apart from WhatsApp, di message folo comot for Facebook.

“Abeg share dis message wit all di people for ya contact list togeda wit ya family, make you for save pesin life or plenti pipu own… I don do my own; e remain you … rememba sey God dey help pesin wey dey help oda pipu togeda wit theirself! Send am as you get am,” na dia di message stop.

Di post no tok weda dem folo medical expert or pharmaceutical institution tok before dem make dat kain message.

Paracetamol na drug wey dey reduce pain, dem dey usually use am treat pain wey no too plenti and to reduce fever. Di usual dose wey dem dey give adults na 500 milligrams or 1 gram.

Machupo na zoonotic disease, dat is disease wey fit dey transfered from animal to human being. Anoda name for di virus na black typhus or Bolivian hemorrhagic fever. Dem first discover am in 1959 for Bolivia, and na onli for di South American kontri dem don record some cases.

According to Standford University, di virus dey “spread through small liquid drops, inside food, or direct contact wit di virus particles”.

But na true sey paracetamol tablets get Machupo virus inside?

WETIN WE CHECK

TheCable check see sey di message don dey circulate for internet since 2017 and some news platforms don confam sey di tori no correct.

In 2017, di Malaysian ministry of health bin tok sey di report na fake and make nobodi send am.

Di ministry come add sey e no receive any report from di manufacturer sey paracetamol get Machupo virus.

On May 7, di Zambia Medicines Regulatory Authority, inside one statement tok sey di message wey dey circulate for social media no“correct and no suppose cause concern”. Di regulatory agency add sey dem neva see any case of Machupo virus wey dem fit link to paracetamol.

Nonso Odili, pharmacist and CEO of DrugIT, tell TheCable sey di message na notin but fake news wey dem don tok plenti times.

“Dis tin don old. E get one time a few years ago wen e bin dey circulate. At dat time, dem bin tok sey na fake news. Dat time, WHO and NAFDAC no chuk mouth for di mata, maybe becos no bi somtin wey dey important,” na so im tok.

“E beta make pipu dey only use products wey NAFDAC register.”

Olusayo Akintola, chief informate of di National Agency for Food and Drug Administration (NAFDAC), folo chuk mouth for di mata and e tok sey dis kain claim no get head especially as di post no tok sey dem put di drug for “laboratory test”.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey paracetamol tablets get Machupo virus no correct. Di fake tok don dey appear for different kontris and evritym dem dey tok sey e no correct.

TAGGED: Health disinformation, Machupo virus, Paracetamol

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 August 21, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12

RoundCheck, a fact-checking organisation, is set to host a youth-focused poetry festival on media and…

December 8, 2025

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?