TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey Tinubu no sign 2023 peace accord as Kukah claim?
Share
Latest News
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey Tinubu no sign 2023 peace accord as Kukah claim?

Claire Mom
By Claire Mom Published September 24, 2024 4 Min Read
Share

Matthew Kukah, Catholic Bishop of Sokoto diocese, don claim sey President Bola Tinubu no sign di peace accord during di 2023 presidential election.

Kukah tok on Sunday, during di Edo election security town hall meeting for Benin.

“Wetin folo dey interesting be sey di current president, di time im be presidential candidate, no sign am. No be our fault sey di political opposition no take advantage of am,” na so di Catholic Bishop tok.

Di Catholic Bishop claim don gada plenti attention, with some Nigerians wey dey question weda wetin im tok correct.  

PEACE ACCORDS FOR NIGERIA

With different tins wey hapun before di 2015 election, dem establlish di national peace committee (NPC) for 2014 to ensure peaceful and credible elections for di kontri.

Di committee, wit Abdulsalami Abubakar, former head of state, as oga, don carry out different peace pacts for candidates wey dey contest political offices for both state and federal levels.

On September 21, pipu for Edo go enter polling unit cast dia votes for candidates wey dem like.  

Howeva, concerns about di peace and safety of voters don dey rise, afta di Peoples Democratic Party’s no gree sign di peace accord.

Di PDP tok sey na because dem no trust police.

Godwin Obaseki, governor of Edo, accuse di police of working for di All Progressives Congress (APC), afta dem arrest 10 PDP members. Obaseki claim sey police bin no get enough evidence or valid cases against dem.

Ontop di PDP mata, Kukah tok sey no be di first time wey candidate go refuse sign peace pact.

WETIN WE CHECK

TheCable check di 2023 peace pact report wey NPC publish, notice sey dem bin sign two peace accords for  national level, afta di violence wey folo previous elections for di kontri.

Di first pact bin encourage political parties and dia candidates to make sure sey dia goals na confam election campaign strategies instead of misinformation and hate speech. Di candidates sign di pact on September 29, 2022.

Di 2023 presidential candidates gada for di International Conference Centre, Abuja to sign di peace pact for free and credible election for di kontri.

Peter Obi, candidate of di Labour Party (LP); Atiku Abubakar, PDP candidate; Rabiu Kwankwaso, flagbearer of di New Nigeria Peoples Party (NNPP); and Omoyele Sowore, standard bearer of di African Action Congress (AAC) bin all dey di event, except Tinubu, wey dem tok sey bin dey UK.

Na Kashim Shettima, im running mate, bin represent am.

Oda media platforms bin folo report di signing of di first peace pact for 2022, example for here, here and here.

Di second pact, wey dem sign on February 23, 2023, na to make sure sey di candidates go accept di outcome of di election.

Tinubu bin dey di signing of di second pact.

FINAL TOK

Based on confam informate, di claim wey Kukah make sey Tinubu no sign di 2023 election peace pact no correct.

TAGGED: Kukah, local language news, News in pidgin, peace accord, Tinubu

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom September 24, 2024 September 24, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG

A video circulating on social media shows a Facebook user claiming Godwin Emefiele, the former…

July 2, 2025

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?