TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey ICT na di top contributor to Naija GDP since 2021?
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey ICT na di top contributor to Naija GDP since 2021?

Claire Mom
By Claire Mom Published February 2, 2025 3 Min Read
Share

Vincent Olatunji, National Commissioner of di Nigeria Data Protection Commission (NDPC), claim sey di information and communication technology (ICT) sector don contribute di most to Nigeria gross domestic product (GDP), dat is a total of 16 to 18 percent ova di past four to five years.

Olatunji tok on Wednesday wen im appear on the Prime Time program on Arise Television.

“For di last 4 or 5 years, di ICT sector don make di highest contribution to di GDP, ranging between 16 and 18 percent,” na so im tok.

“And di target for di next few years, if we cari eye look di $1 trillion economy wey Mr President dey pursue, na to make sure sey di digital economy sector contribution to di GDP reach 20 percent.

“And you fit imagine wetin go hapun if oda sectors bring in dia vision wit clear policy plan, we go definitely improve.

WETIN WE CHECK

CableCheck look di GDP informate from di National Bureau of Statistics (NBS) for 2021 reach di third quarter of 2024.

Di informate show sey for 2021, di agriculture sector naim be di largest contributor to Nigeria GDP, accounting for 25.88 percent, followed by trade at 15.69 percent, and ICT at 15.51 percent.

In 2022, na still agriculture be di top contributor with 25.58 percent, followed by ICT at 16.52 percent, and trade at 16 percent.

In 2023, agriculture remain di leading sector with 25.18 percent, followed by ICT at 17.34 percent, and trade at 15.83 percent.

Di informate for 2024 neva comot. Howeva, di available informate cover Q1 to Q3.

In Q1, di agriculture sector contribute 21.08 percent, ICT contribute 17.88 percent, and trade contribute 15.70 percent to di GDP.

In Q2, agriculture contribute 22.61 percent, ICT contribute 19.77 percent, and trade contribute 16.39 percent.

In Q3, agriculture contribute 28.65 percent, ICT contribute 16.36 percent, and trade contribute 14.78 percent.

FINAL TOK

Based on the confam informate, di claim wey tok sey ICT sector dey always contribute di highest to Nigeria GDP ova di last four years no correct. Agriculture naim don consistently contribute di most for di years wey we check.

TAGGED: ICT, News in pidgin, Nigeria's GDP, Vincent Olatunji

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom February 2, 2025 February 2, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?