TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey ICT na di top contributor to Naija GDP since 2021?
Share
Latest News
CableCheck wins IFCN global fact check fund
Íhé ńgósị́ ébé Peter Obi sékpù àlà n’íhú Tinubu bụ̀ ǹkè é jìrì AI nwóghàrị̀á
Hoton Peter Obi ya durkusa ma Tinubu a Rome na hadi ne
Foto wey show as Peter Obi dey kneel down for Tinubu inside Vatican na photoshop
Peter Obi kò kúnlẹ̀ fún Tinubu ní Rome
FACT CHECK: No, Abia government didn’t block arrest of 59 youths by EFCC
Video wey show ‘bandits’ wit bundles of moni no be from Nigeria
Nàìjíríà kọ ni àwọn jagidijagan ti se àfihàn beeli, beeli owó nínú fídíò ti ṣẹlẹ̀
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey ICT na di top contributor to Naija GDP since 2021?

Claire Mom
By Claire Mom Published February 2, 2025 3 Min Read
Share

Vincent Olatunji, National Commissioner of di Nigeria Data Protection Commission (NDPC), claim sey di information and communication technology (ICT) sector don contribute di most to Nigeria gross domestic product (GDP), dat is a total of 16 to 18 percent ova di past four to five years.

Olatunji tok on Wednesday wen im appear on the Prime Time program on Arise Television.

“For di last 4 or 5 years, di ICT sector don make di highest contribution to di GDP, ranging between 16 and 18 percent,” na so im tok.

“And di target for di next few years, if we cari eye look di $1 trillion economy wey Mr President dey pursue, na to make sure sey di digital economy sector contribution to di GDP reach 20 percent.

“And you fit imagine wetin go hapun if oda sectors bring in dia vision wit clear policy plan, we go definitely improve.

WETIN WE CHECK

CableCheck look di GDP informate from di National Bureau of Statistics (NBS) for 2021 reach di third quarter of 2024.

Di informate show sey for 2021, di agriculture sector naim be di largest contributor to Nigeria GDP, accounting for 25.88 percent, followed by trade at 15.69 percent, and ICT at 15.51 percent.

In 2022, na still agriculture be di top contributor with 25.58 percent, followed by ICT at 16.52 percent, and trade at 16 percent.

In 2023, agriculture remain di leading sector with 25.18 percent, followed by ICT at 17.34 percent, and trade at 15.83 percent.

Di informate for 2024 neva comot. Howeva, di available informate cover Q1 to Q3.

In Q1, di agriculture sector contribute 21.08 percent, ICT contribute 17.88 percent, and trade contribute 15.70 percent to di GDP.

In Q2, agriculture contribute 22.61 percent, ICT contribute 19.77 percent, and trade contribute 16.39 percent.

In Q3, agriculture contribute 28.65 percent, ICT contribute 16.36 percent, and trade contribute 14.78 percent.

FINAL TOK

Based on the confam informate, di claim wey tok sey ICT sector dey always contribute di highest to Nigeria GDP ova di last four years no correct. Agriculture naim don consistently contribute di most for di years wey we check.

TAGGED: ICT, News in pidgin, Nigeria's GDP, Vincent Olatunji

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom February 2, 2025 February 2, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

CableCheck wins IFCN global fact check fund

CableCheck, the fact-checking initiative of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), has been awarded the…

May 30, 2025

Íhé ńgósị́ ébé Peter Obi sékpù àlà n’íhú Tinubu bụ̀ ǹkè é jìrì AI nwóghàrị̀á

Ótù ihe ngosị nke a na-ekesa na soshal midia na-egosị ebe Peter Obi, onye jiri…

May 24, 2025

Hoton Peter Obi ya durkusa ma Tinubu a Rome na hadi ne

Wani hoton da ya yi zagayen a shafukan sada zumunta ya nuna Peter Obi, dan…

May 24, 2025

Foto wey show as Peter Obi dey kneel down for Tinubu inside Vatican na photoshop

One foto wey don waka for social media show as Peter Obi, presidential candidate of…

May 24, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Íhé ńgósị́ ébé Peter Obi sékpù àlà n’íhú Tinubu bụ̀ ǹkè é jìrì AI nwóghàrị̀á

Ótù ihe ngosị nke a na-ekesa na soshal midia na-egosị ebe Peter Obi, onye jiri Labour Party zọ ọkwa onye…

CHECK AM FOR WAZOBIA
May 24, 2025

Hoton Peter Obi ya durkusa ma Tinubu a Rome na hadi ne

Wani hoton da ya yi zagayen a shafukan sada zumunta ya nuna Peter Obi, dan takarar shugaban kasa na jam'iyyar…

CHECK AM FOR WAZOBIA
May 24, 2025

Foto wey show as Peter Obi dey kneel down for Tinubu inside Vatican na photoshop

One foto wey don waka for social media show as Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP) for…

CHECK AM FOR WAZOBIA
May 24, 2025

Peter Obi kò kúnlẹ̀ fún Tinubu ní Rome

Àwọn ènìyàn ti ń pín àwòrán kan kiri lórí ohun ìgbàlódé ibaraẹnise orí ayélujára, tí ó se àfihàn Peter Obi,…

CHECK AM FOR WAZOBIA
May 24, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?