TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Herdsman dash Obi cow and land for presidential campaign?
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Herdsman dash Obi cow and land for presidential campaign?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 20, 2022 4 Min Read
Share

One post for Facebook tok sey one herdsman from di north carry 50 cows and three plots of land for Kaduna, dash Peter Obi for im presidential campaign.

“As e dey enter: Hausa man “Danladi” dash Peter Obi 50 cows and 3 plots of land for Kaduna, take support im presidential campaign,” na so di post tok.

Dem add one join join picture wey get two different foto for di post.

For di left hand side, the foto show white cows wey dey for forest . On di right, na mixture of brown and white cow ontop green grass dey di foto.

Also, e get one fair man wey dey di right side of di picture.

“I dey stand kakaraka as na Igbo man wan be our president”, na so di Facebook post, wey dem tok say Danladi, di fair man wey dey di picture tok.

Di name of di Facebook page wey share di post na Obidient. Di post get pass 3,000 likes, 618 comments and 783 shares.

Oda Facebook pages folo cari di tori.

“E dey do me like make I cry. God don do am for dis country,” na so one Facebook user wey tink say the tin wey di post tok na true.

Wetin we check

Yandex, one beta tool for internet, wey we dey use check the original place where picture come from and when the picture first enter internet, show us say di picture wey ‘Danladi’ dey inside, don dey internet since March 2021.

Di result show sey na Daily Trust newspaper post am on March 20, 2021, for one news report wey dem title: “Dauda, From Cow Wey Im Carry To Lecturer For University”.

Who be Adamu Dauda?

Di Daily Trust report tok say di person for that Facebook post na Adamu Dauda Garba, say no be Danladi as di post tok.

The report tok how Adamu wey dem born for October 10, 1985, start to dey carry cow waka for Taraba at 6 years, and how he join am wit im school. 

In 2009, he come get National Certificate of Education (NCE) from Taraba state college of education, Jalingo.

“After I finish school for college of education, l hear sey di federal university for Wukari, been dey find security guards na im l come apply and dem carry me,” na so im tok for di report.

After im work as security guard for 4 years, dem give am admission to read sociology for di same school after im apply. Na so im come later find work for there as graduate assistant after im finish school.

Adamu reaction as e hear di fake news

We see say Twitter don partially block Adamu account for some time.

As we dey check, we see one Tweet wey im don already tok about di tin wey dem post about am.

For di Tweet, im tok sey: “Make evribodi know sey I be Adamu Dauda Garba from Taraba State. No be me give dem permission to use my foto for dat fake news. Make di general public know say na fake tori, sidan wait for wetin court go tok.”

https://twitter.com/ADAMUDaudaGarb2/status/1546909972239368192?ref_src=twsrc%5Etfw%7Ctwcamp%5Etweetembed%7Ctwterm%5E1546909972239368192%7Ctwgr%5E%7Ctwcon%5Es1_&ref_url=https%3A%2F%2Fwww.thecable.ng%2Fwp-admin%2Fpost.php%3Fpost%3D724194action%3Deditclassic-editor

Final tok

Wetin we check show say dat man for the foto na Adamu Dauda Garba, no be Danladi. E no dash Peter Obi 50 cows or 3 plots of land for Kaduna for im presidential campaign. Di tori na fake.

TAGGED: peter obi

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 July 20, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?