TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Di viral video wey soldiers hold heavy gun wit plenti knives no bi from Niger Republic
Share
Latest News
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Di viral video wey soldiers hold heavy gun wit plenti knives no bi from Niger Republic

Claire Mom
By Claire Mom Published August 6, 2023 6 Min Read
Share

One video wey don dey waka ontop internet tok sey some soldiers wey dey show dia guns, dey flex dia muscles na army from Niger Republic.

For di TikTok video wey dey evriwhere, you fit see as soldiers wey hold big gun dey move bodi laik sey dem wan go fight war.

Dem come dey march dey sing war song, dey flex bodi with strong face. Na so pipu just dey look – e dey sweet some for bodi, odas dey fear.

👆👉Pray for our soliders for this battle because Niger Republic military are more than ready for face their enemy. Look at this video. Say no to War. Africa fighting Africa. This is what Western people want so that they will sale their weapons 🔪 🔫🔫. Africa why. pic.twitter.com/FWukwR6RP5

— Victor Chuks (@VictorC26525018) August 4, 2023

On Friday, @VictorC26525018, one Twitter user, post di video come tell Nigerian citizens make dem pray for dia own army as dem dey go jam dia mates for Niger wey dey “more dan ready”.

“Pray for our soldiers for dis war because Niger Republic army dey more dan ready to face dia enemy. Look dis video. Say no to War. Africa fighting Africa. Na wetin Western pipu want so dat dem go fit sell dia gun. Africa why,” na so di tweet wey dem don view more dan 100 times tok.

Gbadebo Rhodes-Vivour, Lagos governorship candidate under di Labour Party (LP), folo post di same video for im Twitter account.

Even though Rhodes-Vivour no tok say di soldiers na from Niger, di politician tweet bin focus on di kasala wey dey hapun for di West African country.

“Unlike some pipu, na only one passport I get and my loyalty no dey for any oda kontri. Na only Nigeria I get,” na so im tok.

“To fight with pipu wey bi laik sey dem dey find as dia economy go beta togeda wit how dem go dey free from oyibo pipu hand, no go favour our govment becos pipu dey see us as kontri wey get plenti power. E fit still come affect our security.”

As of di time wen dis tori comot, Rhodes-Vivour tweet bin gada 1,103 replies, 3,217 retweets, 7,801 likes, 416 bookmarks, and dem view am 1.8m times.

Unlike some, i have only one passport and have sworn no allegiance to any other state. Nigeria is all I have.

A war with a people who appear to be uniting around a common interest, seeking economic freedom and a departure from over bearing western influence will have very dire… pic.twitter.com/WJ0tmLThiT

— Gbadebo Rhodes-Vivour (@GRVlagos) August 4, 2023

 

Di video with di same caption still comot for plenti Facebook accounts.

Open Nigeria, one Facebook page wey claim sey na non-profit organisation get am, post di video tok sey Nigeriens no get anything to lose for di war.

“I hope sey Seyi Tinubu, Yusuf Bichi, Umar Ganduje, Hope Uzodimma, Festus Keyamo, Muhamadu Buhari, Femi Gbajabiamila, Tony Elumelu, Aliko Dangote, Akpabio, Orji Uzor Kalu and di children of all di supporters of di darkness go dey di battlefront against Nigeriens wey no get anything to lose for dis Imperial European war against Africa,” na so di post tok.

Di video wey dem share evriwhere na as President Bola Tinubu move bodi laik sey im wan send army go Niger Republic sake of di political katakata wey dey hapun for dia.

Tinubu, wey be chairman of di Economic Community of West African States (ECOWAS), tok sey di union bin gree sey dem go send army for di meeting wey dem hold on Sunday in Abuja.

ECOWAS bin give Niger one week from Sunday to put President Mohamed Bazoum back for power or dem go face more painful punishment.

Howeva, many kontris, including Russia, and oda pipu wey dia hand folo dey inside di mata like di ECOWAS defence chiefs don tok sey make dem use mouth settle di mata instead of to send army.

WETIN WE CHECK

TheCable cari plenti keyframes of di video check for reverse image search to sabi di first time wey di video land internet.

Di results show sey di video bin dey ontop one YouTube page on April 4 – Senegal Independence Day.

Di video wey dem title “April 4: Commandos show | Independence Day Senegal | 2023” show as soldiers dey do one small performance to celebrate di Independence. Na so citizens just dey hail dem.

Di military independence parade na di first one wey dem hold for Dakar, di kontri capital, in four years because of break from di COVID-19 pandemic.

Violent kasala between security pipu and political opposition supporters bin don dey worry di kontri one week before dem celebrate dia 63rd independence anniversary from France.

FINAL TOK

Di posts wey tok sey di soldiers wey dey di viral video na from Niger Republic no correct. Di soldiers wey dey di video na Senegalese army wey dey perform parade to celebrate di kontri independence. Also, di flags for di background na Senegalese flag colours, no bi Nigerien own.

TAGGED: Fact check pidgin, Niger army, Niger crisis, Pidgin news

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 6, 2023 August 6, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12

RoundCheck, a fact-checking organisation, is set to host a youth-focused poetry festival on media and…

December 8, 2025

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?