TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Di Nigerians wey dey Indian prisons pass 1.3m as Ohanaeze claim?
Share
Latest News
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Shin Tinubu ya halarci makaranta daya da Alexander Zingman? Ga abin da muka sani
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Di Nigerians wey dey Indian prisons pass 1.3m as Ohanaeze claim?

Claire Mom
By Claire Mom Published November 24, 2024 3 Min Read
Share

Ohanaeze Ndigbo, one socio-cultural organisation, claim sey over 1.3 million Nigerians dey Indian prisons.

Okechukwu Isiguzoro, di organization secretary-general, make di claim for statement wey dey welcome Narendra Modi, prime minister of India, to Nigeria.

Quoting “confam intelligence”, Isiguzoro tok sey di nomba for India na di highest nomba of Nigerian prisoners globally.

“Di tin wey dey pepper bodi pass na di serious situation wey consign our citizens abroad: over 1.3 million Nigerians currently dey suffer for different prisons across di 28 states of India, di highest concentration of Nigerian prisoners for kontri for di world,” na so im tok. 

“Dis kain kasala need immediate diplomatic engagement.”

Isiguzoro accuse di Indian authorities of detaining innocent Nigerians without reason and im tol sey make di urged Modi and President Bola Tinubu discuss di topic as mata of urgency.

“We dey beg di President make im chuk mouth for dia release and potential state pardon as humanitarian favour wey go reflect our shared values and commitment to justice,” na so im tok.

Isiguzoro tok sey dem bin make di call to protect di rights of pipu wey be victims of systemic challenges and racism – tins wey dey common wit di immigration experience.

NA 1.3m NIGERIANS DEY INDIAN PRISONS?

To confam di claim, TheCable check di National Prisons Information Portal (NPIP), initiative of di Indian govment wey dey calculate and show all di l activities wey consign prison and prisoner management for every jail across di kontri.

According to di website, dem dey update di dashboard every four hours to present accurate informate. Data from di portal show how many inmates dey all di prisons.

TheCable check all di nombas for all di states and we see sey Nigerians dey jail inside 25 states out of 28.

As of November 20, di portal show sey na total of 526,569 inmates dey all di prisons. Inside dis nomba, Nigerians bin get 1,933.

Manipur bin get di highest nomba of imprisoned Nigerians at 1,009 while states like Meghalaya, Andhra Pradesh, Assam, and Puducherry bin get di smallest wit one inmate each. Di total dey slightly increased from di 1,100 Nigerians wey bin dey serve different jail terms in 2015, according to Ajjampur Ghanashyam, then-Indian high commissioner in Nigeria.

Di claim wey Isiguzoro make even pass di total nomba of prisoners wey dey Indian prisons.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey 1.3 million Nigerians dey serve jail terms for India no correct. Informate from di Indian government show sey only 1,933 Nigerian prisoners dey di Asian country.



TAGGED: News in pidgin, Nigerians in Indian prisons, Ohanaeze Ndigbo

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom November 24, 2024 November 24, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?