TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Di foto wey show plenti crowd na from Osun PDP rally?
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Di foto wey show plenti crowd na from Osun PDP rally?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 26, 2022 3 Min Read
Share

One foto wey show plenti pipu wey dem claim sey na from di Peoples Democratic Party (PDP) rally for Osun state dey evriwhere for social media.

On Saturday, July 16, PDP bin hold rally for Osun sake of di governorship election.

Abban Atiku, one Twitter user with di handle @abbalala3, share di foto come write, “Osun State no be your mate”.

For di foto, no be small crowd tanda wit trees and moto wey folo dey inside di crowd. Di picture get pass 3, 900 likes, 500 retweets, and 552 comments.

Osun State no be your mate. pic.twitter.com/46lQ8sdRed

— Abban Atiku (@abbalala3) July 13, 2022

As we check im Twitter sharp sharp, we see say di social media user na ogbonge PDP supporter.

Pipu claim sey di foto wey dey evriwhere na sake of sey PDP last rally dey successful.

Some Twitter users wey just follow the foto as dem see am, come dey hail di plenti pipu wey dem think say na from di PDP rally.

“I dey happy if na Osun because I like PDP ten times pass APC wey dey tiff. If LP candidate no fit get am, abeg make PDP dancing senator get am. E go sweet Obidients belle for Adeleke,” na so one comment from one Twitter user tok.

“Free ticket to carry eye see Davido and oda musicians. Why people no go gather? Di dancing senator go show pipu new dance style. I be LP man but if I dey Osun tomorrow, I go make sure say I enjoy well well,” na so anoda Twitter pesin tok.

Dem also share di post for Facebook.

Wetin we check

TheCable carry di foto check for Labnol, one computer tool wey dey check di real place where picture come from.

We see sey dem snap di foto for Ilorin, Kwara. No be Osun as pipu tok. We still check wella come see sey dem snap am for di Eid-el Kabir prayer for Kwara state, and dem first post am on July 9.

Kwara state government post am for dem ogbonge Twitter account, come write: “No be small worshippers comot for Ilorin, di Kwara state capital, on Saturday to do dem Eid-el Kabir prayer. Govnor @RealAARahman dey set di ground so dat pipu go fit calm down, na why im dey tok beta with all di ogas wey come from di oda political party . #EidMubarak.”

TheCable still check see sey anoda Twitter user post different pictures from di Eid-el Kabir prayer wey just finish for Ilorin. Na im mean sey dat picture no comot from Osun as pipu dey claim.

https://twitter.com/TheWorldCamera_/status/1546220740487282690?s=20&t=1r9OOyYdTzYBW0-Oip7yVw

Kwara State Eid Prayers today ❤️ pic.twitter.com/lbUldv0RIV

— Mohammed Jammal (@whitenigerian) July 9, 2022

Final tok

Di foto wey pipu claim sey na from PDP rally no be true na from Ilorin for Kwara state.

TAGGED: Fact Check, Ilorin, kwara, Osun PDP rally

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 26, 2022 July 26, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?