TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Dem use AI touch di video wey dem interview Bill Gates about COVID-19 vaccine
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Dem use AI touch di video wey dem interview Bill Gates about COVID-19 vaccine

Claire Mom
By Claire Mom Published April 23, 2023 4 Min Read
Share

Dem don use Artificial intelligence (AI) touch one video wey dem dey interview Bill Gates ontop Australian Broadcasting Corporation (ABC) News to add tins wey no true about vaccine and Microsoft.

Different pipu share di video for Twitter and Instagram.

One user wey im name na @meekystudios post di video come write: “Wow, where dem cari dis woman from wey she clear Bill Gates, former richest man in di world, sotey im no fit open mouth well again?”

Di post get more dan 28, 100 likes, 614 comments, and 1,203 shares.

Anoda user wey im name na @fqryonline folo post di video for Instagram where e gather pass 110k likes, 3,392 shares and 158k shares.

For di video wey dey go round, Sarah Ferguson, one Australian journalist, dey interview  Bill Gates, di pesin wey start Microsoft.

“Mr Gates, make you use your mouth talk am, wetin you don contribute for dis world?” na so e bi like sey she ask for di interview.

“I no sure weda you sabi, but na me create di most popular computer operating system for di world,” na so e bi like sey Gates answer am.

After she accuse am sey im steal di Windows operating system from pesin, she come dey ask am some kain question about COVID-19, wey dey suggest sey im follow benifit ontop di vaccines.

One voice wey bi like sey na di interviewer get am come ask: “You bi one of di main pipu wey dey tok about COVID vaccines during di pandemic, wetin make pesin like you – computer engineer wey no even program im first product by imsef – dey chuk mouth for inside pharmaceutical industry?”

“I don read plenty book about di topic and I don meet with experts for di field from all over di world,” na so di voice wey bi like sey na Gates own ansa.

She come finally ask weda na normal tin for Gates to tiff confam technology wey im no “understand, come sell somtin wey don spoil finish, dey cause wahala so dat im go fit dey benefi.”

WETIN WE CHECK

As we read di comments of di post ontop di different social media wey dem post am, e show sey many viewers no know sey dem don touch di video.

Howeva, one social media user wey don see di original interview start to dey blow whistle. Im sey di real interview no get any discussion about Microsoft and di COVID-19 vaccine.

Using keyword search, TheCable find di original video wey ABC News Australia post on January 31, 2023.

Na Sarah Ferguson, one Australian journalist, interview Bill Gates ontop di ABC News show titled “7.30”.

TheCable still check see sey di original interview no get any part  of di video wey dey circulate for social media.

For di real interview, Ferguson bin tok about climate change, philanthropy, misinformation, if anoda pandemic won come, and di dinners wey Gates regret to get with Jeffrey Epstein.

Anoda check show sey di face and lip movement of di interviewer and Gates for di video wey dey social media no align.

FINAL TOK

Dem don use deepfake technology touch di circulating audio. Wetin dem tok for di original interview no join with di fake one.

TAGGED: AI spreading misinformation, Bill Gates vaccine conspiracy, Fact check pidgin, Pidgin news, TheCable pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 April 23, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?