TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Dem don divide Oyo state into two?
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Dem don divide Oyo state into two?

Claire Mom
By Claire Mom Published November 2, 2024 3 Min Read
Share

One TikTok user claim sey di bill wey dey seek to divide Oyo state into two don become law.

For di one-minute, 35-second video, di TikTok account —  @Eddieblisshotline — tok sey one new state don comot from Oyo.

Di video don gada ova 46.9K likes, 3,735 comments, and 6,139 shares for TikTok.

Di TikTok user also took sey Ibadan, wey be di capital of Oyo state, go come tanda wit anoda capital — Ibadan town.

She tok sey make residents for di state begin dey tink which one dem go join afta dem create di new one.

“Breaking News, dem don divide Oyo state into two. You know sey normally we get Ibadan and Oyo, wit Ibadan as di capital. Now dem dey tok sey Oyo go remain as si state while Oyo town go be capital,” na so she tok.

“Na di same tin for Ibadan, wey be di original capital of Oyo state wey go come be state on im own, wit Ibadan town as im capital, and dem don pass am into law.”

@edyblisshotline Reps splits Oyo State into 2. #nigerian#endbadgovernanceinnigeria ♬ original sound – Eddie Bliss🎧💎

The claim was also seen on Instagram and Facebook.

DEM DON CREATE ANODA STATE FROM OYO?

On October 22, one bill wey dey seek to create new state from Oyo pass di second reading for di house of representatives.

Di bill sponsored by Akeem Adeyemi, member representing Oyo federal constituency, bin dey try change di 1999 constitution through di creation of di new state.

Adeyemi tok sey di creation of di new state bin dey important sake of di size of di state, wey im describe as di largest in the south-west, wit 33 LGA and population of 5,580,894 people (2006 census).

For bill to become law, e suppose don pass through three readings for both di senate and house of representatives, wit public hearing from pipu wey di tin concine before dem fit pass or reject am. 

Once all these criteria don balance, dem go send di bill give president for signing.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey dem don create new state from Oyo state no correct.

TAGGED: News in pidgin, Oyo new state, Oyo state

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom November 2, 2024 November 2, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?