TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Dem don create new state for south-east?
Share
Latest News
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Dem don create new state for south-east?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 5, 2024 3 Min Read
Share

One TikTok video claim sey dem don create new state wey di name na Orlu for di southeastern part of Nigeria.

Di 4-minute video for Igbo language don gada pass 31,000 views, 5,057 comments, and 3,889 shares.

According to di video by @marahchi, now Nigeria don get 37 states instead of 36.

She come start to list di states wey dey affected sake of di new Orlu state wey dem allegedly create.

“Una don wake? Dis tori wey dem tok sey dem pass one bill two days ago, sey instead of 36 states wey we get for Nigeria, now we don get 37 states and capital. So, dem create new state. For una wey no understand English, make I break am down for you. Dem don create new state called Orlu state,” na so she tok.

“Dem create am from parts of Abia state, Imo, and Anambra state wey dem join togeda call am Orlu state.

“If you from Anambra, make you check confam if you dey part of di pipu wey go join di new Orlu state. So, these towns wey I go mention now, una no longer dey come from Anambra state, na Orlu now.

“Towns like Ihiala, Uli, Ozubulu, Akokwa, Umuchu, Umunze, Umuaku, Nwangele, Nkwere, New Ideato North, Nwabosi West, Alaoma, Owerrebiri, Oguta, Isu, Arondizuogu, Ideato north, Ideato south, Njaba, Oru east, Orsu.”

Di claim bin folo dey X and Facebook.

DEM DON CREATE ORLU STATE FOR SOUTH-EAST?

On June 5, one bill wey dey seek to create new state for south-east pass first reading during plenary for house of representatives.

Di bill, sponsored by Ikenga Ugochinyere, member representing Ideato north and Ideato south federal constituency, bin seek di creation of Orlu state.

Di new state go comot from parts of Anambra, Imo and Abia states, according to di draft bill.

Within di six geopolitical zones for di kontri, south-east get only five states, while odas get 6 states with only north-west wey get 7 states.

As kontri wey dey practise bi-cameral legislature (two-chamber legislature), any bill — draft wey suppose be law — go first pass through di two chambers — senate and house of representatives — before dem approve am.

Di bill also suppose pass through three readings by both houses with public contributions from concerned parties before dem go pass or reject am.

After di two chambers pass am, e go reach president table for assent.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey dem don create new state for south-east no correct.

Di bill don only pass di first reading — wey be di introduction into di legislative system.

TAGGED: new state, Orlu state, Pidgin news, southeast

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 5, 2024 July 5, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG

A video circulating on social media shows a Facebook user claiming Godwin Emefiele, the former…

July 2, 2025

FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency

The presidency says reports on George Akume, secretary to the government of the federation (SGF),…

June 29, 2025

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women

In the early hours of April 15, 2025, armed men wielding firearms and cutlasses attacked…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?