TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: CHECK AM: Lawan don comot for APC join PDP?
Share
Latest News
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Shin Tinubu ya halarci makaranta daya da Alexander Zingman? Ga abin da muka sani
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

CHECK AM: Lawan don comot for APC join PDP?

Claire Mom
By Claire Mom Published June 22, 2022 3 Min Read
Share

On June 17, one tori tok say Senate President Ahmad Lawan don comot from All Progressives Congress (APC). 

Some tweets bin claim say di senate president don comot di ruling APC go join Peoples Democratic Party (PDP).

Mustapha Kehinde, di pesin wey tweet di post say,” Ahmad Lawan leave APC go PDP because im still wan dey NASS, no be because im wan help im people. E suppose show you say na only money dey dia mind.”

Di tweet get at least 1,448 retweets and 4,508 likes.

One ogbonge Twitter handle wey dey normally post entertainment gist, @GoldMyneTV, follow carry di tori wey say Lawan comot for APC. Di account get pass50,000 followers.

Wetin hapun before

Abdullahi Adamu, di national chairman for APC bin talk say Lawan na di consensus presidential candidate of di party.

He come later contest for di primary election, but na three people beat am. Lawan carry fourth as he gather  152 votes.

Di senate president lose to Bola Tinubu, former govnor for Lagos, who bin get 1,271 votes.

Wetin we check

Wen di news bin dey all ova Twitter, TheCable check see say no beta news site carry di tori wey say di senate president don leave im party.

On Saturday, Ola Awoniyi, Lawan special adviser ontop media mata, share statement wey say di news no correct.

For June 14plenary, di senate president tok say two Kebbi senators don comot for di party.

Yahaya Abdullahi, senator wey dey represent Kebbi North, and Adamu Aliero, senator wey come from Kebbi Central, bin send letters wey tok say dem don comot APC go PDP.

Awoniyi tok say, “Na di video clip wey di senate president dey read Senator Aliero letter na im pipu go touch make e forbe like say na Lawan leave party.”

He come tok say di original video wey Lawan dey read Aliero letter na 3 minutes 30 seconds. But pipu wey wan cause wahala cut am go 26 seconds.

Bad belle pipu dey use di incomplete video deceive di public.

Final Tok

Di tori wey yarn say Senate President Ahmad Lawan don leave APC go PDP na fake news.

 

 

TAGGED: 2023, Ahmad Lawan, APC, elections, PDP, Senate President

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 June 22, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?