TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Check Am: Gunmen bin attack  Celestial church for Owo?
Share
Latest News
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Shin Tinubu ya halarci makaranta daya da Alexander Zingman? Ga abin da muka sani
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Check Am: Gunmen bin attack  Celestial church for Owo?

Claire Mom
By Claire Mom Published June 24, 2022 4 Min Read
Share

One video wey comot for social media claim say gunmen bin attack one celestial church for 0wo, Ondo state.

Florence Omojesu, one Tiktok user, wey post di video one day after gunmen dem attack di catholic church for the same Owo, write say “My heart dey bleed, even yesterday for Owo, gunmen attack celestial church.”

Di video comot for social media after plenti pipu wey go church die for di Owo attack on Sunday, June 5. 

Ebenezer Anu, wey post anoda tik tok video wey show di Celestial church write say, “Na anoda Fulani attack for celestial church for Akure be dis.” Pipu share am for Whatsapp.

Di 13 second video show one building wey dem paint for white and blue. E still come show women and children wey wear long white gown and cap. 

For di video, one woman wey carry her pikin for waist still hold anoda pikin for hand, just dey run so dem fit hide. 

Na so for background one woman come dey shout for Yoruba say, “We no fit go house o, where we wan hide? Jesus!” Evriwhere just dey scata scata.

For Facebook, di video get pass8,100 views. Dem even post am for Twitter too.

 

Wetin hapun before

On Sunday, June 5, gunmen bin attack St. Francis Catholic Church for Owo LGA, Ondo state.

Plenti pipu die for di accident. Some bin get wound. 

Even children follow die for di pipu wey dem kill for church that day. 

On June 17, dem do one big burial for all di 40 pipu wey die.

 

Wetin we check

TheCable call Fumilayo Odunlami, police public relations officer for Ondo state, to check if true say gunmen attack di Celestial church.

She tok say, “Di Ondo state police command no know about any attack for any celestial church for Owo.”

Our pipu wey dey check if tori true come check di social media of all di Celestial church for Owo. We come follow di pipu wey dey lead both Parish 1 and 2 tok, dem tell us say na for Celestial Church of Christ, Parish 2 dat video comot from. 

But say notin bin hapun.

According to Joseph Oluwasegun, di shepherd of Celestial Church of Christ, Owo, Parish 2, he tok say, “As dem hear di gunshot from St. Francis Catholic Church on Sunday, June 5, 2022, no be small fear catch di church members. Na why dem just dey run evriwhere for dat video.”

Before dem hear di gunshots, dem bin dey celebrate Juvenile Harvest Celebration across all di Celestial churches for di world. He confam say gunmen no attack di church, say all di church members dey okay.

 

Final tok

Di real time wey dem record dat video na June 5. Di claim wey tok say dem attack di church no be true.

TAGGED: celestial church attack, Ondo, Owo attack

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 24, 2022 June 24, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?