TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Bello el-Rufai do mistake. Hadiza Balarabe no be Naija first elected female deputy govnor
Share
Latest News
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Shin Tinubu ya halarci makaranta daya da Alexander Zingman? Ga abin da muka sani
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Bello el-Rufai do mistake. Hadiza Balarabe no be Naija first elected female deputy govnor

Claire Mom
By Claire Mom Published March 23, 2024 4 Min Read
Share

Bello el-Rufai, lawmaker wey dey represent Kaduna north federal constituency for di house of representatives, claim sey Hadiza Balarabe na Naija first elected female deputy govnor.

Di lawmaker tok for podcast wey Seun Okinbaloye, di broadcast journalist, host.

Di podcast, with 16.3k subscribers, get 94,760 views, 602 comments and 2.9k likes.

Bello na di son of Nasir el-Rufai, former govnor of Kaduna state.

In 2018, Nasir el-Rufai bin select Balarabe as im running mate for di 2019 govnorship election for di state.

Im tok sey di reason why im pick Balarabe na because Barnabas Bantex, im deputy dat time, bin inform am sey im go contest senator.

Before dem select her as el-Rufai running mate, Balarabe na di executive secretary of di Kaduna State Primary Health Care Development Agency.

WETIN WE CHECK

As im dey tok wetin im papa achieve for Kaduna, di lawmaker tok sey im papa, through Balarabe, renovate all di 255 primary healthcare centres for di state.

“Fortunately, one of di tins wey my papa do with im deputy govnor, Dr Hadiza (Balarabe), wey be di first female elected deputy govnor for Nigeria, na to renovate di 255 healthcare primary centres for Kaduna,” na so di lawmaker to

However, TheCable check see sey since civilian rule come back for 1999, Nigeria don get some elected female deputy govnors for different states before Balarabe.

DI ELECTED FEMALE DEPUTY GOVNORS

Lagos na di first state wey elect female deputy govnor. In 1992, during one short civilian rule, na Micheal Otedola dem elect as govnor of Lagos state under di National Republic Convention (NRC) with Sinatu Ojikutu as im running mate.

Ojikutu dey that position till November 1993 wen di military collect power.

In 1999, Nigeria enta civilian rule. Bola Tinubu bin win di Lagos govnorship election under di Alliance for Democracy (AD) party with Kofoworola Akerele-Bucknor as im running mate.

From that time, di likes of Adebisi Sosan, Adejoke Orelope-Adefulire, and Oluranti Adebule get di position of elected female deputy govnors of Lagos between 2007 to 2019.

Ayo Fayose bin appoint Abiodun Olujimi as di first female deputy govnor of Ekiti from September 2005 to 2006. Funmilayo Olayinka come be deputy for Kayode Fayemi from 2010 to 2013 before she die while Modupe Adelabu become deputy govnor for May 2013.

In Ogun state, Salimat Badru bin serve as deputy govnor from 2003-2011, and Yetunde Onanuga chop deputy govnor of di state from 2015 to 2019.

In Osun, Olusola Obada folo be deputy govnor from 2003 to 2010 during di administration of Olagunsoye Oyinlola, while Titilayo Laoye-Tomori become deputy govnor of di state from 2010 to 2018.

Pauline Tallen become di deputy govnor of Plateau state for 2007, and di first woman to be deputy govnor for northern Nigeria while Ipalibo Banigo deputise Nyesom Wike for Rivers from 2015 to 2023.

Cecilia Ezeilo bin serve as deputy govnor to Ifeanyi Ugwuanyi afta im win di state govnorship election for 2015.

Dem elect Noimot Salako-Oyedele togeda with Dapo Abiodun for Ogun state for 2019, di same year wey Balarabe enta office as di first female deputy govnor of Kaduna.

In 2022, dem choose Balarabe as Uba Sani running mate. In March 2023, dem relect her deputy govnor.

FINAL TOK

Di claim wey Bello el-Rufai make sey Balarabe na di first elected female deputy govnor fo Nigeria no incorrect.

Na Sinatu Ojikutu bi Naija first female elected deputy govnor.

TAGGED: Bello el-Rufai, first female deputy governor

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 8, 2024 March 23, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?