On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official social media platform to announce di rescue of two kidnapped victims for Kogi state.
For di statement, di army tok sey dem rescue di two kidnapped victims on Sunday, “afta confam intelligence ontop kidnapping activities along di Itobe–Adumu–Ejule axis”.
Di army tok sey dem recover N3.8 million wey dem bin pay as ransom for di victims.
“Troops bin act sharpaly wit di informate and dem send patrol to Achigili Forest to block di bandits. Howeva, as dem dey road to di location, di criminals begin fire di army. As dem dey fire, di gallant soldiers use dia ogbonge gun scata di criminals, na so dem run leave di victims wit di ransom money,” na so di army bin tok.
TROOPS OF 12 BRIGADE RESCUE TWO KIDNAPPED VICTIMS AND RECOVER RANSOM IN KOGI STATE
In a sustained effort to rid Kogi State of criminal activities, troops of 12 Brigade Nigerian Army deployed at Forward Operating Base (FOB) Oguma have successfully rescued two kidnapped victims… pic.twitter.com/mKDOXx5eER
— Nigerian Army (@HQNigerianArmy) November 3, 2025
Hassan Abdullahi, acting assistant director of army public relations of 12 Brigade Nigerian Army, sign di statement.
Di army publish four foto wey show di kidnapped victims with army and local hunters.
WETIN CAUSE WAHALA
E no tey afta di army publish di statement and foto for X, before many users tok sey di rescue operation na old incident.
Di X users wey question weda di rescue operation dey recent post screenshots of Google image search of one of di pictures dey di army post.
You people have rolled back to snatching random pictures from the internet & reporting it as rescue updates.
How are you reporting updates from 9 months ago?
What level of incompetence have you descended to?
God, WHY DID YOU BRING ME HERE? https://t.co/6XXk0Ww3Wzpic.twitter.com/CifW6Xguhe
— 👑S.A.L.A.K.O🕊 (@UnkleAyo) November 3, 2025
Di screenshots of di Google image search comot results wey allegedly show sey one of di foto wey di army publish don dey internet for nine months to 2 years.
One of di image search results show sey one X user identified as Olubunmi Aro (@bummiero) post di foto nine months ago. Anoda result show as di Instagram handle of di Nigerian army post di foto two years ago.
Di screenshots of di Google image search results cause harsh reactions as many X users criticise di army for allegedly using old pictures for recent rescue operation of kidnapped victims.

Some X users claim sey di army using old pictures to show recent events sake of di threat wey United States President Donald Trump make ontop di Christian genocide claim for Nigeria.
Later, one community note appear under di army X post, wey dey based on di sentiments raised by di X users.
WETIN CABLECHECK FIND
To confam weda di pictures wey di army publish on November 3, 2025, don comot for internet before, CableCheck analyse one of di images using Google Lens.
Di “exact matches” section show some results wey suggest sey di foto don dey online before November 2, 2025.
One of the results show sey @bummiero post di foto nine months ago.
Wen CableCheck search di profile and posts of @bummiero on Thursday morning, di post no dey there.
Some moments later, @bummiero post sey im neva publish dat kain foto.

CableCheck also review di second Google image search result, wey show sey di foto comot two years ago. One click for di link show Instagram post ontop di Nigerian army account.
Di post, wey dem publish April 2023, na flyer wey announce inaugural lecture of di Nigerian Army Heritage and Future Centre.
CableCheck review di Instagram handle but no find any foto of di rescue operation.
CableCheck dey always use Google image search to check foto. We don notice sey sometimes, wen Google search engine crawl Meta platforms and oda social media platforms for image searches, e dey pull plenti posts from different pages come show di publication date of those posts as di date of di foto wey you dey try search, even wen notin jam di foto wey you dey search wit di different posts wey comot.
Most of di time, Google image search results no dey 100 percent accurate for face level, as results fit no relate wit wetin you dey search. Google fit show you results wey no make sense as you dey search foto.
FINAL TOK
Since di social media pages wey comot for di Google image search no get di viral foto, evidence no dey enough to prove sey di Nigerian army or any oda entity post di foto for internet before November 3, 2025.