On Sunday, one website — Politics Nigeria — publish one 25-second video for Facebook where President Bola tok sey “we no fear wetin Trump dey do for di oda side”.
Di video don gada pass 200 comments, 660 likes, and 95 reshares..
Many of di Facebook users wey comment for di video join Tinubu comment wit di recent social media posts of United States President Donald Trump ontop di alleged Christian genocide mata for Nigeria.
“Abeg anybodi fit tag Trump for here?…… Abi make I tag am myself 😹😹😹😹,” na so one Facebook user write.
“Dat one beside am seff body dey shake im know wetin dey front 😂😆😂 body go tell dem,” anoda Facebook user write.
“Na you no dey fear, no be us sir. I dey fear because I know wetin USA army fit do wen war start🗡🔫,” anoda Facebook user write.
Last Friday, US President Donald Trump label Nigeria as “country of particular concern (CPC)” sake of claims of Christian genocide for di West African kontri.
Di US leader also warn di Nigerian govment to “beta move fast” or else im go stop all US aid and assistance wey dey enta di kontri.
Later, Trump threaten sey im ask di department of war to prepare to fight di terrorists for Nigeria “wey dey attack our sweet Christians”.
Di comments wey Trump make don trigger plenti tok ontop di implications of possible US military action for Nigeria.
On November 2, Daniel Bwala, special adviser to Tinubu on policy communication, tok sey di Nigerian leader and US President Donald Trump go soon meet “in di coming days” to discuss di claims of Christian genocide for di kontri.
WETIN WE CHECK
For di video wey Politics Nigeria publish, dem paste “Viable TV” for di screen, one platform wey dey publishes short video clips for YouTube.
Wen CableCheck look di YouTube page of Viable TV, we discover sey di video bin comot on September 2, 2025.
Media reports show sey dem bin film di video wen Tinubu receive members of The Buhari Organisation (TBO), led by Tanko Almakura, former Nasarawa governor, for di presidential villa on September 2, 2025.
During di meeting, Tinubu tok sey im administration bin don stabilise the economy, sey di tins wey change for di world — including all di tins wey Trump do — no fit shake Nigeria progress.
“We don meet our revenue target for di year, and we meet am for August. If revenue wey no comot from oil dey go well, then we no suppose fear wetinTrump dey do for di oda side,” na so Tinubu bin tok.
Tinubu bin dey refer to di decision of di Organisation of Petroleum Exporting Countries (OPEC) to increase dia global crude production to reduce oil prices afta Trump apply pressure.
Di US president bin also impose sweeping global tariffs, including 14 percent ontop Nigeria, on all imports into di US.
Di comments wey Tinubu bin make during di meeting for September bin only concern di kontri economic situation.
Tinubu full speech during di event dey Arise Television and Channels Television.
FINAL TOK
Di viral video don tey, and no be Tinubu reaction to di US watchlist.