TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Tinubu speech ontop Trump tariff dey misrepresented as recent comment ontop US watchlist
Share
Latest News
Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?
Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?
Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?
Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́
Maganan Tinubu akan sharhi na baya-bayan nan akan jerin sa ido na Amurka
FACT CHECK: Did Nigerian army use old pictures for recent rescue operation?
FACT CHECK: Tinubu’s speech on Trump’s tariff misrepresented as recent comment on US watchlist
Claim wey tok sey FIFA give Kenya $1.2m to build Talanta stadium no correct
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Tinubu speech ontop Trump tariff dey misrepresented as recent comment ontop US watchlist

Claire Mom
By Claire Mom Published November 5, 2025 4 Min Read
Share

On Sunday, one website — Politics Nigeria — publish one 25-second video for Facebook where President Bola tok sey “we no fear wetin Trump dey do for di oda side”.

Di video don gada pass 200 comments, 660 likes, and 95 reshares..

Many of di Facebook users wey comment for di video join Tinubu comment wit di recent social media posts of United States President Donald Trump ontop di alleged Christian genocide mata for Nigeria.

“Abeg anybodi fit tag Trump for here?…… Abi make I tag am myself 😹😹😹😹,” na so one Facebook user write.

“Dat one beside am seff body dey shake im know wetin dey front 😂😆😂 body go tell dem,” anoda Facebook user write.

“Na you no dey fear, no be us sir. I dey fear because I know wetin USA army fit do wen war start🗡🔫,” anoda Facebook user write.

Last Friday, US President Donald Trump label Nigeria as “country of particular concern (CPC)” sake of claims of Christian genocide for di West African kontri.

Di US leader also warn di Nigerian govment to “beta move fast” or else im go stop all US aid and assistance wey dey enta di kontri.

Later, Trump threaten sey im ask di department of war to prepare to fight di terrorists for Nigeria “wey dey attack our sweet Christians”.

Di comments wey Trump make don trigger plenti tok ontop di implications of possible US military action for Nigeria.

On November 2, Daniel Bwala, special adviser to Tinubu on policy communication, tok sey di Nigerian leader and US President Donald Trump go soon meet “in di coming days” to discuss di claims of Christian genocide for di kontri.

WETIN WE CHECK

For di video wey Politics Nigeria publish, dem paste “Viable TV” for di screen, one platform wey dey publishes short video clips for YouTube.

Wen CableCheck look di YouTube page of Viable TV, we discover sey di video bin comot on September 2, 2025.

Media reports show sey dem bin film di video wen Tinubu receive members of The Buhari Organisation (TBO), led by Tanko Almakura, former Nasarawa governor, for di presidential villa on September 2, 2025.

During di meeting, Tinubu tok sey im administration bin don stabilise the economy, sey di tins wey change for di world — including all di tins wey Trump do — no fit shake Nigeria progress.

“We don meet our revenue target for di year, and we meet am for August. If revenue wey no comot from oil dey go well, then we no suppose fear wetinTrump dey do for di oda side,” na so Tinubu bin tok.

Tinubu bin dey refer to di decision of di Organisation of Petroleum Exporting Countries (OPEC) to increase dia global crude production to reduce oil prices afta Trump apply pressure.

Di US president bin also impose sweeping global tariffs, including 14 percent ontop Nigeria, on all imports into di US.

Di comments wey Tinubu bin make during di meeting for September bin only concern di kontri economic situation.

Tinubu full speech during di event dey Arise Television and Channels Television.

FINAL TOK

Di viral video don tey, and no be Tinubu reaction to di US watchlist.

TAGGED: Christian genocide claims, News in pidgin, Tinubu, Trump

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom November 5, 2025 November 5, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn…

November 5, 2025

Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?

On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official…

November 5, 2025

Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?

A ranar Litinin din da ta gabata ne rundunar sojin Najeriya ta fitar da sanarwa…

November 5, 2025

Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́

Ní ọjọ́ ìsinmi, Politics Nigeria, wẹbusaiti kan fi fídíò tí kò pé ìṣẹ́jú kan síta…

November 5, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn àwòrán lórí àwọn ohun ìgbàlódé…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?

On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official social media platform to announce…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?

A ranar Litinin din da ta gabata ne rundunar sojin Najeriya ta fitar da sanarwa tare da wasu hotuna a…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́

Ní ọjọ́ ìsinmi, Politics Nigeria, wẹbusaiti kan fi fídíò tí kò pé ìṣẹ́jú kan síta lórí Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?