Kebbi state government don deny one viral AI-generated video wey claim sey dem dey build secret airport for Argungu forest sake of cocaine trafficking from Colombia.
Charly Boy, oga musician, post di cartoon video for im Instagram account on Monday.
However, for press conference on Thursday, Rabiu Sokoto, Kebbi commandant of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA), tok sey investigations no confam di allegations.
“Notin like dat dey hapun for dis state. We don gon where we suppose go, we don investigate, and notin dey like dat,” na so Sokoto tok.
Yakubu Birnin Kebbi, state commissioner for informate and culture, tok sey na di opposition make di video to discredit di govment and scata di state.
“Dis tin dey very very irresponsible, very very criminal, and e mean sey some people no mind, as I tok before, di consequences wey e go bring for di state, dem no care wetin go hapun to di state as long as dem fulfil dia mission,” na so di commissioner tok.
“To clear any doubt, di only Airport wey dey Kebbi state na di Sir Ahmadu Bello International Airport, Birnin Kebbi. Argungu no get, and e no get before, any airport, airstrip, or facility wey resemble am,” na so di state govment tok for separate statement.
“Also, all di names and characters wey dem mention for di video no exist, and di Nigeria Customs Service, di National Drug Law Enforcement Agency, or any other security agency no get any official records or investigations wey dey support dat kain useless claim.”
“Di Kebbi state government dey concerned sey some kain pipu dey deliberately spread dis kain lie to mislead di public and to cause unnecessary fear.”
Di state sey make di public no send di clip.