Many many online blogs and social media people don dey claim sey the federal government dey plan remove pockets from di uniforms of dem officers of di Nigeria Police Force (NPF) to tackle bribery.
Dem design di post for tori headline format, con drop am for Facebook, Instagram, and X.
Di post con too dey with one flyer wey show oga police dey hold SPY police uniform, wey be dem supernumerary police officers.
Di flyer carry di inscription sey: “FG TO REMOVE POCKETS FROM POLICE UNIFORMS TO TACKLE BRIBERY, SAYS FG”.
One X user wey be @ekwulu, posted di flyer with caption: “Who is thinking for these guys?”
Di post don get over 90 reposts, 25 quotes, and 236 likes.
“Is it that they don’t know how to tackle the main issue or they just want to distract the populace?” na so one person comment.
“Suppose they decide to deploy POS for instant bribe payment? POS is bigger than all pockets. Hope after removing the pockets they will deploy CCTV cameras in all police officers offices from the rank of ASP to IGP for equity reasons,” another X user write for the post.
A Facebook page wey carry di name “News in Naija” join body post di viral claim.
“You can’t beat Nigeria Police at all as they will get another means for keeping their proceeds from their illegal activities. They can start keeping the bribe in their Shoes or even underwear just to make sure that they are safe,” a Facebook user comment for the post too.
“They’ll still purchase POS machine let’s bet,” a Facebook user con write.
You go see di post for here, here, and here.
Di viral post no mention if na federal government yarn di matter.
CableCheck sef see sey na amateur news platform and social media users share di claim. That kind matter no dey any news platform wey standa, correct police handles, or government agency pages.
CableCheck also discover sey di claim don appear for one post in 2017 wey appear for Nairaland, an online forum where Nigerians discuss social, political, and economic issues. This show sey di claim na a recycle one e be.
Di photo wey dem use dey push di matter na him dem take when dem unveil di correct uniform and kits for SPY police for September 3, 2024.
Di oga police wey dey di picture na Bala Ciroma, deputy inspector-general of police, finance and administration, wey represent Kayode Egbetokun, the IGP, for di unveiling for di SPY police uniforms.
Dem report di tori everywhere for media wey dem sabi well well.
SPY police na some pesin we dem segiment from di police wey dey perform for private organisations or government officials.
Dem fit dey use these SPY police officers teh dey protect public and private facilities or to dey carry out certain functions wey require security.
Inside dem Nigeria Police Act 2020, no be police body dey pay SPY officers, but na by private organisations wey request their services.