TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show as ISWAP shoot army general na AI
Share
Latest News
Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school
Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria
Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya
Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà
FACT CHECK: Video of Ghanaian school fire incident falsely described as razed Nigerian church
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show as ISWAP shoot army general na AI

Claire Mom
By Claire Mom Published November 20, 2025 3 Min Read
Share

One viral video don allegedly show di time wey terrorists kill Musa Uba, one brigadier general, for Borno state.

Islamic State West Africa Province (ISWAP) fighters bin allegedlykill Uba afta dem ambush soldiers and operatives of di Civilian Joint Task Force (CJTF) for Borno on Friday.

Afta di ambush, reports begin comot sey dem kidnap Uba.

Howeva, Onyechi Anele, di army chief informate, deny di reports on Saturday, sey di brigadier general battle di “insurgents’ ambush wit beta gun,” force dem scata run.

Uba bin also reportedly release video statement to confam sey im still tanda gidigba.

ISWAP tok sey Anele informate na lie, sey dem kpai di military general afta dem capture am.

On Thursday, President Bola Tinubu later confam sey Uba die.

Afta ISWAP tok sey dem kill di brigadier general, one video begin waka for social media as im alleged last moments.

For di video, di officer dey sidan for ground before dem shoot am for head.

Howeva, CableCheck notice some tins wey resemble artificial intelligence (AI) manipulation.

For di video, afta dem fire di gun, di general no fall down immediately. Instead, small time pass before im fall. Dat kain fall no normal for pesin wey dem stand close shoot.

“You fit see sey im even start to fall before di bullet touch am,” Timothy Avele, one security expert, tell CableCheck.

Also, impact no dey from di supposed bullet. After dem fire di shot, e no shake bodi, blood no comot, or any oda sign wen bullet touch im head. Di physical reaction no be di same wit real gunshot.

If dem shoot pesin for head, blood dey flow immediately, but im head remain di same and di ground wey im fall for clean.

Im cap sef no shift. Real bullet for knock am comot or at least shift am.

We bin also run di video for DOT (Deepfake Offensive Toolkit), one programmable deepfake offensive and detection software solution.

Di results show sey di video na AI.

TAGGED: AI-generated video, army general shooting, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom November 20, 2025 November 20, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school

One TikTok user claim sey jihadists burn church for di northern part of Nigeria. One…

December 12, 2025

Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria

Ótú onye na TikTok ekwuola na ndị jihad a gbaala ụlọ ụka ọkụ na mpaghara…

December 12, 2025

Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya

Wani mai amfani da TikTok ya yi ikirarin cewa mayakan jihadi sun lalata wata Coci…

December 12, 2025

Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà

Ẹnì kan tó ń lo TikTok, ibì kan lórí ayélujára tí áwọn ènìyàn ti máa…

December 12, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school

One TikTok user claim sey jihadists burn church for di northern part of Nigeria. One TikTok user — @WakaWakaplanet —…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria

Ótú onye na TikTok ekwuola na ndị jihad a gbaala ụlọ ụka ọkụ na mpaghara ụ́gwụ́ nke Naịjiria. @WakaWakaplanet jiri…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya

Wani mai amfani da TikTok ya yi ikirarin cewa mayakan jihadi sun lalata wata Coci a yankin arewacin Najeriya. Wani…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà

Ẹnì kan tó ń lo TikTok, ibì kan lórí ayélujára tí áwọn ènìyàn ti máa ń fi àwòrán tàbí fídíò…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?