On August 9, one pesin wey be Asare Obed carry one video for Facebook wey show people dey use rope dey cross one bridge wey don collapse.
For the video, e get one woman wey dey hold the rope tight and dey use am dey cross, while some men enter water to carry steel storage drums through same water.
The narrator wey dey the video claim sey the matter happen for Naija but hin no mention the specific domot wey e be for the country.
“Here, people risk their lives just to cross this river,” na so dem write for the post.
“This is not a scene from a movie. This is the harsh reality of Nigeria. Every day, people cross this river, risking their lives. There is no bridge, only a weak rope to support them,” na so the narrator talk join.
“The situation is so bad that to get from the village to the city, one must hang onto that rope, which swings between hope and death. If it is a log or something heavy. People themselves get into the river and fight the strong current to take them to the other side.”
The video don generate view wey pass a million views, 1,000 comments, and 2,000 shares.
Another Facebook user wey carry name Halima Kiponda sef carry the video put for hin page.
VERIFICATION
When we for CableCheck carry the video con check for Google Lens, we see sey dem post that kind video for page of one Facebook user wey be Gadara media for September 2024.
For the video caption, dem write am for Arabic, but Facebook con translate am to “The suffering of a man #Darfur in autumn”. Darfur is a region in Sudan.
CableCheck still carry the matter enter Google search to know whether e get bridge wey collapse for Darfur.
One of the results show us one post wey dem publish for the Sudan International Human Rights Organisation (SIHRO) in September 2024 about a collapsed bridge in the region of Sudan.
Dem post am with video wey show people wey dey cross di river with ropes. SIHRO tok sey di bridge na the Morni bridge, wey konet south and middle Darfur in Sudan.
True true one bridge collapse for dere due to heavy flooding. Relief Web also confam the matter.
VERDICT
Di video wey dey show people dey use ropes dey transport themselves on top one river na from Sudan, NO BE Naijiria.