Nyesom Wike, minister of di Federal Capital Territory (FCT), tok sey Peter Obi, forma govnor of Anambra and 2023 Labour Party presidential candidate, bin no conduct LG elections during im tenure as govnor.
Wike tok am for Abuja on Sunday for St. James Anglican Church inside Asokoro during one thanksgiving service wey dem organise for di “successful completion of inaugurated projects” for FCT.
Di way di minister tok am be like sey im dey yab di opposition figures, sey dem too dey selfish.
“You tok sey Peter Obi go be president. President where? Some of una go dey support pipu wey you no sabi, just because of wetin you feel,” na so Wike tok.
“E do governor for eight years. Im no conduct local government elections — never. Nigerians no vex. E sweet Nigerians sey im no gree conduct local government elections. Eight good years, im be governor. And you call dat one democracy? Only one man be governor of di whole state and all di local governments.”
Di tin wey Wike tok come some days after opposition parties join demselves inside di African Democratic Congress (ADC) to challenge President Bola Tinubu for 2027.
Wike tok restart debate weda Peter Obi conduct local government elections during di time wey im be governor of Anambra.
WETIN HAPUN BEFORE
Before di landmark ruling wey di Supreme Court give ontop local government autonomy in July 2024, state governors bin get full control over local councils.
E bin dey normal for state governments to hold LG money come install caretaker committees instead of elections.
Di apex court bin rule sey make di moni wey di federation account suppose give local governments reach dem directly, instead of to go through di states so dat democratic governance go fit strong for di grassroots.
Peter Obi bin serve as governor of Anambra from March 2006 to March 2014, with some interruptions sake of court rulings and impeachment.
WETIN WE CHECK
CableCheck discova sey on January 11, 2014, just two months before di end of Peter Obi’s tenure, dem bin conduct local government elections aross all 21 LGAs for Anambra.
Na di first local government election wey di state bin take eye see since 1998, breaking di 16-year cycle of caretaker administrations.
At dat time, di All Progressives Grand Alliance (APGA), di ruling party for di state, win 20 out of 21 local government chairmanship seats and 304 of the 326 (327) councillorship positions.
On January 13, 2014, three days after di elections, Obi swear in di newly elected council chairpersons and im tell dem sey make dem work with Willie Obiano, di governor-elect of di state dat time.
CableCheck also discova sey dis claim don dey fact-checked before afta Reno Omokri, former presidential aide, tok di same tin on July 12, 2024.
FINAL TOK
Di claim wey tok sey Peter Obi no conduct local government elections for Anambra no correct.