TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Wike make mistake. Peter Obi conduct LG election as Anambra governor
Share
Latest News
Ḿbà, Nwifuru àkwụ́sịghị́ ńdị́ kọ̀mị́shọnà ya ọ́rụ́ màkà nà há ábịaghị ńchètá ọ̀mụ́mụ́ nwá ya
No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party
Nwifuru kò dá àwọn òṣìṣẹ́ dúró lẹ́nu iṣẹ́ nítorí pé wọ́n kò wá sí ibi ayẹyẹ ọjọ́ ìbí ọmọ rẹ̀
A’a, Nwifuru bai dakatar da jami’ai ba saboda rashin halartar bikin ranar haihuwar yaro
Video wey show as ‘bridge collapse for Nasarawa’ na AI
AI ni wọ́n fi se fídíò afárá ti wọ́n ní ó wó ní Nasarawa
Íhé ńgósị́ ébé àkwà ḿmíri nà-ádà bụ̀ ǹkè é jìrì AI wòghárị́á
Bidiyon da ke nuna ‘gada ta rushe a Nasarawa’ AI ce ta samar
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Wike make mistake. Peter Obi conduct LG election as Anambra governor

Claire Mom
By Claire Mom Published July 11, 2025 4 Min Read
Share

Nyesom Wike, minister of di Federal Capital Territory (FCT), tok sey Peter Obi, forma govnor of Anambra and 2023 Labour Party presidential candidate, bin no conduct LG elections during im tenure as govnor.

Wike tok am for Abuja on Sunday for St. James Anglican Church inside Asokoro during one thanksgiving service wey dem organise for di “successful completion of inaugurated projects” for FCT.

Di way di minister tok am be like sey im dey yab di opposition figures, sey dem too dey selfish.

“You tok sey Peter Obi go be president. President where? Some of una go dey support pipu wey you no sabi, just because of wetin you feel,” na so Wike tok.

“E do governor for eight years. Im no conduct local government elections — never. Nigerians no vex. E sweet Nigerians sey im no gree conduct local government elections. Eight good years, im be governor. And you call dat one democracy? Only one man be governor of di whole state and all di local governments.”

Di tin wey Wike tok come some days after opposition parties join demselves inside di African Democratic Congress (ADC) to challenge President Bola Tinubu for 2027.

Wike tok restart debate weda Peter Obi conduct local government elections during di time wey im be governor of Anambra.

WETIN HAPUN BEFORE

Before di landmark ruling wey di Supreme Court give ontop local government autonomy in July 2024, state governors bin get full control over local councils.

E bin dey normal for state governments to hold LG money come install caretaker committees instead of elections.

Di apex court bin rule sey make di moni wey di federation account suppose give local governments reach dem directly, instead of to go through di states so dat democratic governance go fit strong for di grassroots.

Peter Obi bin serve as governor of Anambra from March 2006 to March 2014, with some interruptions sake of court rulings and impeachment.

WETIN WE CHECK

CableCheck discova sey on January 11, 2014, just two months before di end of Peter Obi’s tenure, dem bin conduct local government elections aross all 21 LGAs for Anambra.

Na di first local government election wey di state bin take eye see since 1998, breaking di 16-year cycle of caretaker administrations.

At dat time, di All Progressives Grand Alliance (APGA), di ruling party for di state, win 20 out of 21 local government chairmanship seats and 304 of the 326 (327) councillorship positions.

On January 13, 2014, three days after di elections, Obi swear in di newly elected council chairpersons and im tell dem sey make dem work with Willie Obiano, di governor-elect of di state dat time.

CableCheck also discova sey dis claim don dey fact-checked before afta Reno Omokri, former presidential aide, tok di same tin on July 12, 2024.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey Peter Obi no conduct local government elections for Anambra no correct.

TAGGED: Anambra, Anambra LG elections, News in pidgin, Nyesom Wike, peter obi

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 11, 2025 July 11, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Ḿbà, Nwifuru àkwụ́sịghị́ ńdị́ kọ̀mị́shọnà ya ọ́rụ́ màkà nà há ábịaghị ńchètá ọ̀mụ́mụ́ nwá ya

Ótù ozi na shoshal midia ekwuola na Francis Nwifuru, gọvanọ Ebonyi steeti, kwụsịrị ndị komịshọna…

August 1, 2025

No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party

One social media post claim sey Francis Nwifuru, govnor of Ebonyi, suspend 25 commissioners and…

August 1, 2025

Nwifuru kò dá àwọn òṣìṣẹ́ dúró lẹ́nu iṣẹ́ nítorí pé wọ́n kò wá sí ibi ayẹyẹ ọjọ́ ìbí ọmọ rẹ̀

Ọ̀rọ̀ kan lórí ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé Francis Nwifuru, gómìnà Ìpínlẹ̀ Ebonyi…

August 1, 2025

A’a, Nwifuru bai dakatar da jami’ai ba saboda rashin halartar bikin ranar haihuwar yaro

Wani rubutu da aka wallafa a dandalin sada zumunta ya yi ikirarin cewa Francis Nwifuru,…

August 1, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ḿbà, Nwifuru àkwụ́sịghị́ ńdị́ kọ̀mị́shọnà ya ọ́rụ́ màkà nà há ábịaghị ńchètá ọ̀mụ́mụ́ nwá ya

Ótù ozi na shoshal midia ekwuola na Francis Nwifuru, gọvanọ Ebonyi steeti, kwụsịrị ndị komịshọna iri abụọ n'ise (25 commissioners)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 1, 2025

No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party

One social media post claim sey Francis Nwifuru, govnor of Ebonyi, suspend 25 commissioners and oda appointees becos dem no…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 1, 2025

Nwifuru kò dá àwọn òṣìṣẹ́ dúró lẹ́nu iṣẹ́ nítorí pé wọ́n kò wá sí ibi ayẹyẹ ọjọ́ ìbí ọmọ rẹ̀

Ọ̀rọ̀ kan lórí ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé Francis Nwifuru, gómìnà Ìpínlẹ̀ Ebonyi dá àwọn kọmisọnna marundinlọgbọn àti…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 1, 2025

A’a, Nwifuru bai dakatar da jami’ai ba saboda rashin halartar bikin ranar haihuwar yaro

Wani rubutu da aka wallafa a dandalin sada zumunta ya yi ikirarin cewa Francis Nwifuru, gwamnan Ebonyi, ya dakatar da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 1, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?