TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Viral video wey show plenti dead bodi for grave no be from Nigeria
Share
Latest News
FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?
FACT CHECK: Viral image depicting ‘Obasanjo prostrating for Ladoja’ photoshopped
Wike tụ̀rụ̀ àsị́. Peter Obi mèrè ńtụ̀líáká ọ̀chị́chị́ ḿpághárá m̀gbè ọ́ bụ̀ gọ́vánọ̀ Anambra
Irọ́ ni Wike pa. Peter Obi ṣètò ìdìbò ìjọba ìbílẹ̀ nígbà tí ó jẹ́ gómìnà Ìpínlẹ̀ Anambra
Wike yayi kuskure. Peter Obi ya gudanar da zaben LG a matsayin gwamnan Anambra
Wike make mistake. Peter Obi conduct LG election as Anambra governor
Video wey show as Thomas Partey dey blame ‘rape’ case on racism na fake
Bidiyon da ke nuna Partey yana zargin shari’ar ‘fyade’ akan wariyar launin fata da aka gyara ta hanyar lambobi
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Viral video wey show plenti dead bodi for grave no be from Nigeria

Claire Mom
By Claire Mom Published September 11, 2024 4 Min Read
Share

One viral video wey show as dem mount dead bodi for wetin resemble mass grave be like e hapun for Nigeria.

On August 30, one X account wit di handle @emmasocket post video wey show as men inside camouflage dey shoot pipu wey dey run.

Di account cari di picture of Simon Ekpa, self-acclaimed disciple of Nnamdi Kanu, detained leader of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB).

For di scata scata video wey be like sey dem shoot am for dry land, dem dump plenti dead bodi for inside shallow ground. 

“Make di world sabi di secret war wey dey hapun for di land of Biafra,” na so di X user tweet.

“We no fit take am again, and di only solution to di madness for di zoo wey dem dey call Nigeria na make di kontri scata. BIAFRAN all ova di world @simon_ekpa and di entire cabinet members dey for us.”

As of di time wey dis tori comot, di tweet don gada pass 1k views, 76 likes, and 60 retweets.

On August 31, @AmadiohaOd3671, one X account wey get bigger following, repost di video and e claim sey “dia main plan no be islamisation but na land grabbling and total control of Nigeria by Fulani and Western interest.”

Although di account no specify who dem troway di accusations give, previous claims in di past don suggest sey di same religious status of di president and vice president na attempt to Islamise di kontri.

So far, di post don gada 48.3k views, 819 retweets, 627 comments, and ova 100 likes and bookmarks each.

Di killings happen for Nigeria?

WETIN WE CHECK

To check weda di video don comot before, TheCable cari plenti screenshots of di video check for Google reverse image search.

Results from di search show sey di earliest version of di video comot on August 26.

According to di post wey folo am, na di Jama’at Nusrat al-Islam wal Muslimeen (JNIM), Al Qaeda-linked militant group, cause di killings for Burkina Faso.

Di post tok sey JNIM kill ova 200 and wound 140 as villagers bin dey assist security forces to dig pit wey dem for use build defend outposts.

Some bots bin folo repost di video wit di same tori.

On August 28, War Noir, one independent weapons and conflicts researcher, post di video, add sey di incident happen for di Burkinabe town of Barsalogho.

Media reports confam sey di attack happen on August 24 wit women and children among di victims.

The United Nations (UN) describe di attack as horrific and dem urge di Burkina Faso transition authorities sey make dem make sure sey those pipu wey dey responsible go face punishment.

In addition, Edward Buba, director, of defence media operations, release statement wey tok sey di incident no hapun for Nigeria.

“Make evribody know sey di incident no hapun for Nigeria. Rather, e sadly hapun for nearby African countrywey dey face terrorism,” na so Buba tok.

“On di whole, we dey urge di public to shine eye read tori wey terrorists fit dey spread to cause misinformation, disinformation, and fake news as part of dia war propaganda effort. These situations no be new tin for war,” na so im add.

FINAL TOK

Claims wey tok sey di attack inside di viral video wey show as plenti dead bodi ful grave hapun for Nigeria no correct. Di attack happen for Burkina Faso.

TAGGED: Burkina Faso, Fact check in pidgin, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom September 11, 2024 September 11, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?

A Facebook user has claimed that Nigeria retaliated against the recent United States visa restrictions…

July 15, 2025

FACT CHECK: Viral image depicting ‘Obasanjo prostrating for Ladoja’ photoshopped

An image showing a person prostrating for Rashidi Ladoja, the Olubadan-in-waiting and former governor of…

July 11, 2025

Wike tụ̀rụ̀ àsị́. Peter Obi mèrè ńtụ̀líáká ọ̀chị́chị́ ḿpághárá m̀gbè ọ́ bụ̀ gọ́vánọ̀ Anambra

Nyesom Wike, onye minista nke isi obodo Naijiria bụ FCT, kwuru na Peter Obi, onye…

July 11, 2025

Irọ́ ni Wike pa. Peter Obi ṣètò ìdìbò ìjọba ìbílẹ̀ nígbà tí ó jẹ́ gómìnà Ìpínlẹ̀ Anambra

Nyesom Wike, minisita fún Federal Capital Territory (FCT), Abuja, olú ìlú orílẹ̀ èdè Nàìjíríà, sọ…

July 11, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Wike make mistake. Peter Obi conduct LG election as Anambra governor

Nyesom Wike, minister of di Federal Capital Territory (FCT), tok sey Peter Obi, forma govnor of Anambra and 2023 Labour…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 11, 2025

Video wey show as Thomas Partey dey blame ‘rape’ case on racism na fake

One video wey show as Thomas Partey, Ghanaian midfielder and former Arsenal player, allegedly blame im rape charges on racism…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 11, 2025

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?