TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Viral video wey show as skyscrapers dey collapse no be from Taiwan earthquake
Share
Latest News
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Viral video wey show as skyscrapers dey collapse no be from Taiwan earthquake

Claire Mom
By Claire Mom Published April 15, 2024 3 Min Read
Share

One viral video wey show as different high-rise buildings dey collapse don dey linked to di Taiwan earthquake.

For di video, you fit see as skyscrapers dey fall, dey raise heavy dust while pipu dey shout wit fear.

Di 13-second video wey den post for X don gada 55,000 views, 30 retweets, 67 likes, and 33 bookmarks.

“Plenti buildings don collapse afta one Pair of Massive 7.5 Earthquakes Strikes, and e cause Tsunami Warnings,” @patrickhsu0906, one X user, caption di video.

Some oda X users wey folo share di video claim sey na from di Taiwan earthquake.

“TAIWAN EARTHQUAKE EPICENTER EAST ASIA❗ Scary scene as Skyscrapers dey collapse for massive earthquake. Di earthquake, wey damage buildings & cause landslides, na di largest wey hit Taiwan in 25 years & dem also feel am for some parts of China, Philippines & Japan.

“Taipei, Taiwan, one 7.4 magnitude earthquake, followed by several strong aftershocks, strike off di east coast of Taiwan on Wednesday morning, killing 9 pipu & injuring at least 963 Pipu, according to Taiwan fire department,” anoda X user, @ZubairSpanish, post.

#BREAKING: Multiple buildings have collapsed after a Pair of Massive 7.5 Earthquakes Strikes Triggering Tsunami Warnings#Taiwan #earthquake #goddamn #landslide #地震 #大地震 #樓塌 pic.twitter.com/hs9mqXIom5

— Mindset (@patrickhsu0906) April 3, 2024

DI TAIWAN EARTHQUAKE

On Wednesday, one 7.2 magnitude earthquake strike Taiwan, cause plenti building collapse wey kill nine pipu, wound more dan 1,000.

Taiwan Central Weather Administration (CWA) tok sey na movement for di Philippine Sea plate wit di epicenter wey dey extremely shallow, come dey close to land, naim cause di earthquake.

Even doh earthquakes no be new tin for Taiwan, Wednesday earthquake don dey described as di strongest to hit di island in 25 years.

One 7.7 magnitude earthquake bin strike for 1999, causing 2,400 deaths and leaving 100,000 injured, wit thousands of buildings destroyed.

Taiwan na island for di western Pacific Ocean wey dey di line of seismic faults (ring of fire) where most of di world’s earthquakes dey hapun.

WETIN WE CHECK

TheCable check di video for reverse image search and keyframe analysis for InVID, one video verification platform, sey sey e don dey online since August 27, 2021, on The paper Yunan information platform — one Chinese news platform.

According to di platform, dem bin demolish 15 high-rise buildings under controlled supervision for Kunming, Yunnan city of China.

Dem bin demolish di buildings sake of sey dem no meet di basic requirements of modern living and market demands, and sake of sey dem don scatter finish, because of di long time of di unfinished building.

USA TODAY bin upload di video for YouTube on August 31, 2021.

FINAL TOK

Di viral video where skyscrapers dey collapse no be from di Taiwan earthquake but from one controlled demolition for China in 2021.

TAGGED: earthquake, Taiwan

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 15, 2024 April 15, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?