TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Viral video wey show as Ibrahim Traore dey ‘cancel taxes’ for Burkina Faso na AI
Share
Latest News
Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school
Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria
Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya
Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà
FACT CHECK: Video of Ghanaian school fire incident falsely described as razed Nigerian church
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Viral video wey show as Ibrahim Traore dey ‘cancel taxes’ for Burkina Faso na AI

Claire Mom
By Claire Mom Published April 17, 2025 4 Min Read
Share

One TikTok account — @panafrica069 — don publish one video wey claims sey Ibrahim Traore, head of di military junta for Burkina Faso, declare sey govment go stop to dey collect taxes from individuals and businesses for di West African kontri.

Di TikTok video wey comot April 1 get voiceover wey claim sey Traore make history by turning Burkina Faso into di first African tax-free kontri.

“Ibrahim Traore declare Burkina Faso as tax-free nation” na so di caption of di video tok. Pipu don share am pass 7,000 times wit ova 29,000 likes and 2,000 comments.

For di video, one AI-generated newscaster dey read one fake script while  voiceover dey play underground with oda background videos.

Di voiceover also claim sey Elon Musk, di CEO of microblogging platform X, dey consider move im businesses go Burkina Faso sake of di policy.

Di voiceover also claim sey Western kontris dey consider sanctions against Burkina Faso to stop di tax policy.

Di TikTok account also post oda videos wey show policies and initiatives wey di Traore-led military govment no start.

Since Traore take ova office in September 2022, plenti AI-generated multimedia content don wash di internet to paint Traore military regime for good light.

Policies wey Traore no start bin dey wrongly attached to di military junta for Burkina Faso. Analysts don attribute dis activities to di Russian elements wey dey di Sahel region

WETIN WE CHECK

One of di clips for di TikTok video show as Traore dey tok for event. Using Google Lens to conduct reverse image search ontop di screenshots, CableCheck find one news article from di Africa24TV website.

Di video show as Traore dey tok for di 2024 Academic Excellence Day for Burkina Faso, wey hapun on August 23, 2024, and e bin dey attached to di news report.

A screenshot of the TikTok video

Di video clip from Traore speech for di Academic Excellence Day event bin dey falsely used to show sey di military leader declare tax-free regime for diWest African kontri.

A screenshot of Traore on the Academic Excellence Day event

CableCheck also check Burkina Faso’s newspapers and di official social media accounts of di govment but evidence no dey to show sey Traore declare tax-free policy for businesses and individuals for di kontro.

In December 2024, di transitional parliament for Burkina Faso approve the 2025 Finance Act. For di legislation, dem amend some tax policies and amendments. One of di new provisions for di law be sey from January 2025, pipu wey dey sell goods and provide services ontop e-commerce platforms go pay taxes.

FINAL TOK

Di video wey claim sey Traore don declared sey pipu no go pay tax for Burkina Faso na AI-generated.

TAGGED: News in pidgin, taxes in Burkina Faso, Traore

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 17, 2025 April 17, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school

One TikTok user claim sey jihadists burn church for di northern part of Nigeria. One…

December 12, 2025

Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria

Ótú onye na TikTok ekwuola na ndị jihad a gbaala ụlọ ụka ọkụ na mpaghara…

December 12, 2025

Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya

Wani mai amfani da TikTok ya yi ikirarin cewa mayakan jihadi sun lalata wata Coci…

December 12, 2025

Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà

Ẹnì kan tó ń lo TikTok, ibì kan lórí ayélujára tí áwọn ènìyàn ti máa…

December 12, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school

One TikTok user claim sey jihadists burn church for di northern part of Nigeria. One TikTok user — @WakaWakaplanet —…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria

Ótú onye na TikTok ekwuola na ndị jihad a gbaala ụlọ ụka ọkụ na mpaghara ụ́gwụ́ nke Naịjiria. @WakaWakaplanet jiri…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya

Wani mai amfani da TikTok ya yi ikirarin cewa mayakan jihadi sun lalata wata Coci a yankin arewacin Najeriya. Wani…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà

Ẹnì kan tó ń lo TikTok, ibì kan lórí ayélujára tí áwọn ènìyàn ti máa ń fi àwòrán tàbí fídíò…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?