TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Viral video wey show as Ibrahim Traore dey ‘cancel taxes’ for Burkina Faso na AI
Share
Latest News
FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020
FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀
Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok
Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC
È nwélá ọ́nwụ́ ńdị́ ụ́kà nà Naijiria n’áfọ̀ 2025 kárị́á ọ́nụ́ ọ́gụ́gụ́ ndị́ Palestinian é gbụ́rụ́ na Gaza?
Na true sey dem kill Christians for Nigeria dis year pass Palestinians for Gaza?
Ǹjẹ́ àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́ tí wọ́n pa ní Nàìjíríà ju àwọn ọmọ Palestine tí wọ́n pa ní Gaza lọ ní 2025?
Yi Kiristoci da aka kashe a Nijeriya a 2025 sunfi na faltunawan dake Gaza?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Viral video wey show as Ibrahim Traore dey ‘cancel taxes’ for Burkina Faso na AI

Claire Mom
By Claire Mom Published April 17, 2025 4 Min Read
Share

One TikTok account — @panafrica069 — don publish one video wey claims sey Ibrahim Traore, head of di military junta for Burkina Faso, declare sey govment go stop to dey collect taxes from individuals and businesses for di West African kontri.

Di TikTok video wey comot April 1 get voiceover wey claim sey Traore make history by turning Burkina Faso into di first African tax-free kontri.

“Ibrahim Traore declare Burkina Faso as tax-free nation” na so di caption of di video tok. Pipu don share am pass 7,000 times wit ova 29,000 likes and 2,000 comments.

For di video, one AI-generated newscaster dey read one fake script while  voiceover dey play underground with oda background videos.

Di voiceover also claim sey Elon Musk, di CEO of microblogging platform X, dey consider move im businesses go Burkina Faso sake of di policy.

Di voiceover also claim sey Western kontris dey consider sanctions against Burkina Faso to stop di tax policy.

Di TikTok account also post oda videos wey show policies and initiatives wey di Traore-led military govment no start.

Since Traore take ova office in September 2022, plenti AI-generated multimedia content don wash di internet to paint Traore military regime for good light.

Policies wey Traore no start bin dey wrongly attached to di military junta for Burkina Faso. Analysts don attribute dis activities to di Russian elements wey dey di Sahel region

WETIN WE CHECK

One of di clips for di TikTok video show as Traore dey tok for event. Using Google Lens to conduct reverse image search ontop di screenshots, CableCheck find one news article from di Africa24TV website.

Di video show as Traore dey tok for di 2024 Academic Excellence Day for Burkina Faso, wey hapun on August 23, 2024, and e bin dey attached to di news report.

A screenshot of the TikTok video

Di video clip from Traore speech for di Academic Excellence Day event bin dey falsely used to show sey di military leader declare tax-free regime for diWest African kontri.

A screenshot of Traore on the Academic Excellence Day event

CableCheck also check Burkina Faso’s newspapers and di official social media accounts of di govment but evidence no dey to show sey Traore declare tax-free policy for businesses and individuals for di kontro.

In December 2024, di transitional parliament for Burkina Faso approve the 2025 Finance Act. For di legislation, dem amend some tax policies and amendments. One of di new provisions for di law be sey from January 2025, pipu wey dey sell goods and provide services ontop e-commerce platforms go pay taxes.

FINAL TOK

Di video wey claim sey Traore don declared sey pipu no go pay tax for Burkina Faso na AI-generated.

TAGGED: News in pidgin, taxes in Burkina Faso, Traore

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 17, 2025 April 17, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020

Ngalaba Federal Road Safety Corps (FRSC) akọwala n'ihe ngosi ebe onye ọ̀kwà ụgbọala ụkwụ atọ…

August 22, 2025

FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀

Àjọ tó ń rí sí ààbò àwọn awakọ̀, àwọn tí wọ́n ń rìn lójú ọ̀nà…

August 22, 2025

Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok

The Federal Road Safety Corps (FRSC) don describe one viral video wey show as keke…

August 22, 2025

Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC

Hukumar kiyaye hadurra ta kasa (FRSC) ta bayyana wani faifan bidiyo da ke nuna wani…

August 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020

Ngalaba Federal Road Safety Corps (FRSC) akọwala n'ihe ngosi ebe onye ọ̀kwà ụgbọala ụkwụ atọ na ndị ọrụ ya na-enwe…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀

Àjọ tó ń rí sí ààbò àwọn awakọ̀, àwọn tí wọ́n ń rìn lójú ọ̀nà tí ọkọ̀ ń rìn àti…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok

The Federal Road Safety Corps (FRSC) don describe one viral video wey show as keke rider dey open eye for…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC

Hukumar kiyaye hadurra ta kasa (FRSC) ta bayyana wani faifan bidiyo da ke nuna wani direban babur mai uku yana…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?