One social media post don join some individuals wey wear camouflage wit Boko Haram militants wey dey celebrate dia victory in Nigeria.
@K3lv1nB0b0, on X account, make di claim for video wey nearly enta two minutes on Sunday.
“Boko Haram don take over many Nigerian Military barracks & dem dey Celebrate dia victory,” na so im write for di post.
Di video show as some trucks dey cari heavily armed men across big land.
Gunfire dey sound for di video as di men dey speak foreign language, some dey celebrate wit loud voice.
One of di men wey make di video, dey turn di camera face himself before im go face am give di surroundings.
Di claim wey tok sey na Boko Haram militants wey dey reportedly celebrate afta dem take over “many” Nigerian military barracks don gada one million views since dem post am.
E don also gada 3.9k likes, 2.9k reposts, 1.3k bookmarks, and 1.1k comments.
But di claim get truth inside?
WETIN WE CHECK
CableCheck conduct reverse image search of di video and we discover sey dem post di video for Facebook in September.
Na one Sudanese account bin post am, according to di Facebook page informate.
“Check in, morale up, victory from God,” na so di post wey Facebook translate from Arabic tok.
One clearer version of di video wey dem post for YouTube on October 1 bin add more informate.
CableCheck notice sey di trucks wey cari di armed men bin get Arabic writings.
Di camouflage wey di men folo wear bin get Sudanese flag.
Sudan dey currently fight civil war wey start April 2023 between two opposition of di military govment.
Di war involve di Sudanese armed forces, led by Abdel Fattah al-Burhan, and di paramilitary Rapid Support Forces, commanded by Mohamed Hamdan Dagalo.
FINAL TOK
Di claim wey tok sey di men for di video na Boko Haram militants no correct. Dem no record di video for Nigeria.