TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Viral post wey claim sey dem don pass ‘Cybercrimes Act 2025’ no correct
Share
Latest News
Anambra guber: Offences that can get you arrested during elections in Nigeria
Charly Boy yayi da’awar karya kan cewa Dan Nnamdi Kanu yaci gasar ‘kwakwalwa ta Duniya’
Charly Boy no tok true sey Nnamdi Kanu son win ‘international brain competition’
Irọ́ ni Charly Boy pa pé ọmọ Nnamdi Kanu ọkùnrin ṣàṣeyọrí nínú ìdíje àwọn ọlọ́pọlọ pípé ní àgbáyé
FACT CHECK: Report claiming police rescued 300 people in Kaduna building is from 2019
No be true. Ikpeazu no collect death sentence by hanging sake of ‘N1trn fraud’
Irọ́ ni. Wọn kò dá ẹjọ́ ikú fún Ikpeazu nítorí pé ‘ó kó triliọnu kan náírà owó ìjọba sí àpò ara rẹ̀’
Karya. Ba a yanke wa Ikpeazu hukuncin kisa ta hanyar rataya ba saboda zamba na N1trn
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Viral post wey claim sey dem don pass ‘Cybercrimes Act 2025’ no correct

Claire Mom
By Claire Mom Published August 30, 2025 3 Min Read
Share

One post for social media platforms claim sey di national assembly don pass di “Cybercrimes Act 2025” into law.

Dem mostly di post for X, WhatsApp, and Facebook.

Di post also claim sey di provision of di alleged law “now dey fully binding and enforceable across Nigeria”.

“Di new Cybercrimes Act 2025 don officially become law by di National Assembly under Senate President Godswill Akpabio. Dis mean sey evri provision for di Cybercrimes (Prohibition, Prevention, etc.) Act now dey fully binding and enforceable across Nigeria,” na so part of di post read.

“If you be online user, content creator, or admin of any digital platform (WhatsApp, Facebook, Telegram, etc.), you must know wetin dis law dey tok — because ignorance no go be excuse.”

Di viral post claim sey one of di provisions of di alleged law be sey anybodi wey access anoda pesin phone without permission fit get “punishment of up to 5 years for prison”.

Screenshot of di viral post

Multiple X users folo publish di post in almost di same style, along wit foto of Akpabio, di senate president.

Daddy Freeze, one popular Nigerian media personality, post screenshot of di blogspot wey publish di viral post for Facebook come write: “Beta Work Senator Akpabio; Wow Dey Careful wit wetin you dey post for Social Media. Wetin You Think About Dis Law”.

Screenshot of di post wit foto of Senate President Godswill Akpabio

One X user — @emmaikumeh — publish di viral post togeda wit warning, “as I see for WhatsApp”. Di post, wey comot on August 23, don gada over 200 reposts, 30 quotes, and 400 likes so far.

Some of di posts dey saved here and here.

WETIN WE CHECK

CableCheck observe sey Nigeria no get any law as: “Cybercrimes Act 2025”. Di law wey di kontri get ontop cybercrimes mata na di “Cybercrimes (Prohibition, prevention, etc.) (Amendment) Act 2024”.

President Bola Tinubu pass di law on February 28, 2024. Di 2024 legislation bin correct some parts of di Cybercrimes (Prohibition, Prevention, etc.) Act 2015.

CableCheck also notice sey di post start to dey trend for social media in early August – di period wey jam wit di yearly holiday of di national assembly.

On July 23, di senate go dia holiday and dem suppose resume September 23.

Di house of representatives folo go dia yearly holiday on July 27. Dem no fit pass di alleged law wen both chambers of di national assembly dey holiday.

Di tins wey di viral post no align wit di provisions for di Cybercrimes Act 2024.

FINAL TOK

Di viral post wey claim sey di senate don pass alleged Cybercrimes Act 2025 no correct.

TAGGED: Cybercrimes act 2025, misinformation, National Assembly, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 30, 2025 August 30, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Anambra guber: Offences that can get you arrested during elections in Nigeria

The Independent National Electoral Commission (INEC) has continually warned against vote-buying, ballot box snatching, underage…

October 9, 2025

Charly Boy yayi da’awar karya kan cewa Dan Nnamdi Kanu yaci gasar ‘kwakwalwa ta Duniya’

Charly Boy, mawakin Najeriya, ya yi ikirarin cewa dan Nnamdi Kanu, shugaban kungiyar masu fafutukar…

October 7, 2025

Charly Boy no tok true sey Nnamdi Kanu son win ‘international brain competition’

Charly Boy, chief Nigerian musician, don claim sey di son of Nnamdi Kanu, leader of…

October 7, 2025

Irọ́ ni Charly Boy pa pé ọmọ Nnamdi Kanu ọkùnrin ṣàṣeyọrí nínú ìdíje àwọn ọlọ́pọlọ pípé ní àgbáyé

Charly Boy, gbajúgbajà ọmọ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà, ti sọ pé ọmọkùnrin kan tó jẹ́ ọmọ…

October 7, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Charly Boy yayi da’awar karya kan cewa Dan Nnamdi Kanu yaci gasar ‘kwakwalwa ta Duniya’

Charly Boy, mawakin Najeriya, ya yi ikirarin cewa dan Nnamdi Kanu, shugaban kungiyar masu fafutukar kafa kasar Biafra (IPOB), yaci…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 7, 2025

Charly Boy no tok true sey Nnamdi Kanu son win ‘international brain competition’

Charly Boy, chief Nigerian musician, don claim sey di son of Nnamdi Kanu, leader of di proscribed Indigenous People of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 7, 2025

Irọ́ ni Charly Boy pa pé ọmọ Nnamdi Kanu ọkùnrin ṣàṣeyọrí nínú ìdíje àwọn ọlọ́pọlọ pípé ní àgbáyé

Charly Boy, gbajúgbajà ọmọ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà, ti sọ pé ọmọkùnrin kan tó jẹ́ ọmọ Nnamdi Kanu, olórí Indigenous People…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 7, 2025

No be true. Ikpeazu no collect death sentence by hanging sake of ‘N1trn fraud’

One viral post claim sey Okezie Ikpeazu, former govnor of Abia, collect death sentence by hanging sake of sey im…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 6, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?