TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show ‘bandits’ wit bundles of moni no be from Nigeria
Share
Latest News
HOAX ALERT: Cross River disowns viral Cally Air ‘boobs safety’ assurance advert
Seven ways to detect an AI-generated video
BLIND SPOT: Nigeria’s shortcomings in the age of AI scams
The rise of deepfakes and the fight for digital truth
DISINFO ALERT: Health ministry debunks AI video claiming free nationwide diabetes treatment
Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east
Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east
Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show ‘bandits’ wit bundles of moni no be from Nigeria

Claire Mom
By Claire Mom Published May 22, 2025 4 Min Read
Share

One video wey dey waka for social media dey allegedly show as bandits dey share bundles of moni for Nigeria.

For di nearly two-minute video, one woman dey criticise Nigerian leaders ontop sey dem dey allegedly enable di mata.

“Nigeria don finish,” na so di woman tok.

“Who be di pipu wey dey sponsor these bandits?”

Di woman also claim sey di bandits dey enjoy rights pass oda citizens, wey dey allow dem commit crime without consequences.

“Nigerian govment, wetin dey hapun? Tinubu govment wetin dey hapun?” na so she ask.

Di video waka wella for WhatsApp.

CableCheck see sey di folo comot for YouTube on May 2.

“Where be dis?” na so di social media user ask.

Most of di 23 comments suggest Nigeria and dem ask weda Department of State Services (DSS) sabi wetin dey hapun.

So far, di video don gada 3,772 views and 55 likes.

For separate Instagram post on May 5, Olamisharp, one Nigerian blogger, post di video, come criticise di govment for dia slow action.

“Na di kontri wey oppressors dey show diasef be dis…” na so im write for di video for im 22.4k followers.

Di video don gada pass 600 views.

But na for Nigeria dem bin record di video?

WETIN WE CHECK

CableCheck analysed plenti screenshots of di viral clip using reverse image search and we find one earlier version wey bin dey Facebook on December 16, 2024.

For di video, one male narrator dey tok for Arabic. CableCheck translate di caption wit Google Translate.

“Watch dis video wey dey show as Al-Dagalo militia dey tiff moni from banks and markets,” na so di caption wey dem write for Arabic togeda wit di video tok.

“We bin dey tok sey Al-Dagalo militia na militia wey dey specialize for theft, looting and destruction of resources.”

Di video get 5.6k views.

For di clip, men wey wear camouflage dey show off bundles of moni for bags and trucks, some ontop ground.

CableCheck notice sey di moni for di video no be naira.

According to di narrator, di video show members of Sudan’s Rapid Support Forces (RSF), a paramilitary group, wey no hapi sake of di kontri decision to change dia currency.

Di RSF, led by Mohamed Dagalo, don dey struggle power wit di national army for state control. Di situation don leave hundreds of thousands dead and thousands displaced.

Since di war start, di RSF don get plenti looting accusations.

Last November, Sudan Central Bank announce di introduction of new banknotes.

Di bank tok sey di aim na to force pipu make dem open bank accounts so dat pipu no go too dey tiff dia moni.

Di RSF criticise di move and dem bin start claims of hidden political agenda.

FINAL TOK

Di video wey dey show as men dey display bundles of moni no be from Nigeria. Dem bin record am for Sudan.

TAGGED: bandits, bandits with cash, DRC, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom May 22, 2025 May 22, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

HOAX ALERT: Cross River disowns viral Cally Air ‘boobs safety’ assurance advert

The Cross River state government has disowned a viral image of a purported Cally Air…

August 15, 2025

Seven ways to detect an AI-generated video

A video announcing the launch of a free nationwide diabetes treatment recently went viral across Nigerian…

August 13, 2025

BLIND SPOT: Nigeria’s shortcomings in the age of AI scams

It sounded exactly like her, but it was not. Adeola Fayehun was thousands of miles…

August 12, 2025

The rise of deepfakes and the fight for digital truth

BY PRUDENCE OKEOGHENE EMUDIANUGHE On May 30, 2025, a 49-minute video surfaced on a YouTube…

August 12, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey break into residential apartment hapun…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east

Ótù onye na Facebook ekwuola na ihe ngosị ebe mmadụ na-agbaka ụlọ obibi mmadụ mere na south-east. N'ụbọchị iri abụọ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára sọ pé fídíò tí ó se afihan àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa wani faifan bidiyo da ke nuna jami’an tsaro dauke da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?