TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show as Thomas Partey dey blame ‘rape’ case on racism na fake
Share
Latest News
Ḿbà, Nwifuru àkwụ́sịghị́ ńdị́ kọ̀mị́shọnà ya ọ́rụ́ màkà nà há ábịaghị ńchètá ọ̀mụ́mụ́ nwá ya
No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party
Nwifuru kò dá àwọn òṣìṣẹ́ dúró lẹ́nu iṣẹ́ nítorí pé wọ́n kò wá sí ibi ayẹyẹ ọjọ́ ìbí ọmọ rẹ̀
A’a, Nwifuru bai dakatar da jami’ai ba saboda rashin halartar bikin ranar haihuwar yaro
Video wey show as ‘bridge collapse for Nasarawa’ na AI
AI ni wọ́n fi se fídíò afárá ti wọ́n ní ó wó ní Nasarawa
Íhé ńgósị́ ébé àkwà ḿmíri nà-ádà bụ̀ ǹkè é jìrì AI wòghárị́á
Bidiyon da ke nuna ‘gada ta rushe a Nasarawa’ AI ce ta samar
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show as Thomas Partey dey blame ‘rape’ case on racism na fake

Claire Mom
By Claire Mom Published July 11, 2025 3 Min Read
Share

One video wey show as Thomas Partey, Ghanaian midfielder and former Arsenal player, allegedly blame im rape charges on racism dey trend for social media.

For di video, di lay di background voice ontop Partey’s image wey sey im rape allegation get connection wit im refusal to sign new contract for Arsenal.

“I no do am. Dem dey always wan accuse me of rape but na wetin dey wen you black and no gree renew contract for big clubs like Arsenal,” na so di background voice tok.

“But I don ready. I go rather go jail dan to play for Arsenal again.”

Di video dey X, Facebook, and TikTok. CableCheck notice sey di version of di video wey go viral bin comot from one TikTok account, @sserona12.

Di TikTok handle, wey get over 150,000 followers, post di video on Saturday come write: “Dem dey accuse Thomas Partey of rape”. Di video don gada pass 5 million views to date.

Screenshot of di video for TikTok. 

Dem post di video here and here.

Di video also appear online afta dem charge Partey wit five counts of rape and one count of sexual assault for di United Kingdom.

According to di UK Metropolitan Police, di offences bin allegedly hapun between 2021 and 2022.

Di allegations involve three different women wey claim sey di suspect rape and sexually assault dem.

Partey go appear for Westminster Magistrates Court on August 5.

Partey contract wit Arsenal bin expire on June 30, 2025.

Some rumours bin dey fly around sey contract renewal between di player and di North London club reportedly collapse. Dis mean sey Partey na free-agent player and im no dey currently tied to contract with any club.

WETIN WE CHECK

CableCheck notice sey di mouth area of Partey for di video bin dey blurred, which suggest sey e no fit bi im voice wey de di video.

To check for di location of di original video, CableCheck analyse keyframes of di video for Google Lens.

The results show sey dem post di original video for Instagram on October 8, 2020, shortly afta di Ghanaian midfielder complete one £45 million transfer to Arsenal from Spanish club Atletico Madrid.

A screenshot of di original video on Instagram

For di original video, Partey bin dey tell Arsenal fans sey im fit wait to join di team as new player, as im dey appreciate di fans.

Some news websites also publish di video.

Searches also reveal sey Partey neva make any comment about di rape accusations for im official social media handles.

FINAL TOK

Di viral video wey show as Partey dey blame im rape allegations on racism dey digitally modified.

TAGGED: News in pidgin, Thomas Partey

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 11, 2025 July 11, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Ḿbà, Nwifuru àkwụ́sịghị́ ńdị́ kọ̀mị́shọnà ya ọ́rụ́ màkà nà há ábịaghị ńchètá ọ̀mụ́mụ́ nwá ya

Ótù ozi na shoshal midia ekwuola na Francis Nwifuru, gọvanọ Ebonyi steeti, kwụsịrị ndị komịshọna…

August 1, 2025

No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party

One social media post claim sey Francis Nwifuru, govnor of Ebonyi, suspend 25 commissioners and…

August 1, 2025

Nwifuru kò dá àwọn òṣìṣẹ́ dúró lẹ́nu iṣẹ́ nítorí pé wọ́n kò wá sí ibi ayẹyẹ ọjọ́ ìbí ọmọ rẹ̀

Ọ̀rọ̀ kan lórí ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé Francis Nwifuru, gómìnà Ìpínlẹ̀ Ebonyi…

August 1, 2025

A’a, Nwifuru bai dakatar da jami’ai ba saboda rashin halartar bikin ranar haihuwar yaro

Wani rubutu da aka wallafa a dandalin sada zumunta ya yi ikirarin cewa Francis Nwifuru,…

August 1, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ḿbà, Nwifuru àkwụ́sịghị́ ńdị́ kọ̀mị́shọnà ya ọ́rụ́ màkà nà há ábịaghị ńchètá ọ̀mụ́mụ́ nwá ya

Ótù ozi na shoshal midia ekwuola na Francis Nwifuru, gọvanọ Ebonyi steeti, kwụsịrị ndị komịshọna iri abụọ n'ise (25 commissioners)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 1, 2025

No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party

One social media post claim sey Francis Nwifuru, govnor of Ebonyi, suspend 25 commissioners and oda appointees becos dem no…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 1, 2025

Nwifuru kò dá àwọn òṣìṣẹ́ dúró lẹ́nu iṣẹ́ nítorí pé wọ́n kò wá sí ibi ayẹyẹ ọjọ́ ìbí ọmọ rẹ̀

Ọ̀rọ̀ kan lórí ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé Francis Nwifuru, gómìnà Ìpínlẹ̀ Ebonyi dá àwọn kọmisọnna marundinlọgbọn àti…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 1, 2025

A’a, Nwifuru bai dakatar da jami’ai ba saboda rashin halartar bikin ranar haihuwar yaro

Wani rubutu da aka wallafa a dandalin sada zumunta ya yi ikirarin cewa Francis Nwifuru, gwamnan Ebonyi, ya dakatar da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 1, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?