TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show as Thomas Partey dey blame ‘rape’ case on racism na fake
Share
Latest News
FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020
FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀
Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok
Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC
È nwélá ọ́nwụ́ ńdị́ ụ́kà nà Naijiria n’áfọ̀ 2025 kárị́á ọ́nụ́ ọ́gụ́gụ́ ndị́ Palestinian é gbụ́rụ́ na Gaza?
Na true sey dem kill Christians for Nigeria dis year pass Palestinians for Gaza?
Ǹjẹ́ àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́ tí wọ́n pa ní Nàìjíríà ju àwọn ọmọ Palestine tí wọ́n pa ní Gaza lọ ní 2025?
Yi Kiristoci da aka kashe a Nijeriya a 2025 sunfi na faltunawan dake Gaza?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show as Thomas Partey dey blame ‘rape’ case on racism na fake

Claire Mom
By Claire Mom Published July 11, 2025 3 Min Read
Share

One video wey show as Thomas Partey, Ghanaian midfielder and former Arsenal player, allegedly blame im rape charges on racism dey trend for social media.

For di video, di lay di background voice ontop Partey’s image wey sey im rape allegation get connection wit im refusal to sign new contract for Arsenal.

“I no do am. Dem dey always wan accuse me of rape but na wetin dey wen you black and no gree renew contract for big clubs like Arsenal,” na so di background voice tok.

“But I don ready. I go rather go jail dan to play for Arsenal again.”

Di video dey X, Facebook, and TikTok. CableCheck notice sey di version of di video wey go viral bin comot from one TikTok account, @sserona12.

Di TikTok handle, wey get over 150,000 followers, post di video on Saturday come write: “Dem dey accuse Thomas Partey of rape”. Di video don gada pass 5 million views to date.

Screenshot of di video for TikTok. 

Dem post di video here and here.

Di video also appear online afta dem charge Partey wit five counts of rape and one count of sexual assault for di United Kingdom.

According to di UK Metropolitan Police, di offences bin allegedly hapun between 2021 and 2022.

Di allegations involve three different women wey claim sey di suspect rape and sexually assault dem.

Partey go appear for Westminster Magistrates Court on August 5.

Partey contract wit Arsenal bin expire on June 30, 2025.

Some rumours bin dey fly around sey contract renewal between di player and di North London club reportedly collapse. Dis mean sey Partey na free-agent player and im no dey currently tied to contract with any club.

WETIN WE CHECK

CableCheck notice sey di mouth area of Partey for di video bin dey blurred, which suggest sey e no fit bi im voice wey de di video.

To check for di location of di original video, CableCheck analyse keyframes of di video for Google Lens.

The results show sey dem post di original video for Instagram on October 8, 2020, shortly afta di Ghanaian midfielder complete one £45 million transfer to Arsenal from Spanish club Atletico Madrid.

A screenshot of di original video on Instagram

For di original video, Partey bin dey tell Arsenal fans sey im fit wait to join di team as new player, as im dey appreciate di fans.

Some news websites also publish di video.

Searches also reveal sey Partey neva make any comment about di rape accusations for im official social media handles.

FINAL TOK

Di viral video wey show as Partey dey blame im rape allegations on racism dey digitally modified.

TAGGED: News in pidgin, Thomas Partey

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 11, 2025 July 11, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020

Ngalaba Federal Road Safety Corps (FRSC) akọwala n'ihe ngosi ebe onye ọ̀kwà ụgbọala ụkwụ atọ…

August 22, 2025

FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀

Àjọ tó ń rí sí ààbò àwọn awakọ̀, àwọn tí wọ́n ń rìn lójú ọ̀nà…

August 22, 2025

Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok

The Federal Road Safety Corps (FRSC) don describe one viral video wey show as keke…

August 22, 2025

Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC

Hukumar kiyaye hadurra ta kasa (FRSC) ta bayyana wani faifan bidiyo da ke nuna wani…

August 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020

Ngalaba Federal Road Safety Corps (FRSC) akọwala n'ihe ngosi ebe onye ọ̀kwà ụgbọala ụkwụ atọ na ndị ọrụ ya na-enwe…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀

Àjọ tó ń rí sí ààbò àwọn awakọ̀, àwọn tí wọ́n ń rìn lójú ọ̀nà tí ọkọ̀ ń rìn àti…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok

The Federal Road Safety Corps (FRSC) don describe one viral video wey show as keke rider dey open eye for…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC

Hukumar kiyaye hadurra ta kasa (FRSC) ta bayyana wani faifan bidiyo da ke nuna wani direban babur mai uku yana…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?