TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east
Share
Latest News
Kò sí ọ̀rọ̀ tó seé gbàgbọ́ nípa ọ̀rọ̀ tó sọ pé Amẹ́ríkà kọlu Burkina Faso pẹ̀lú ohun ìjà olóró
No evidence sey US strike Burkina Faso with missiles
Babu wata hujjar Amurka ta jefa makamai masu linzami Burkina Faso
Ò nwéghị íhé ákáébe gósị́rị́ nà US tụ̀rụ̀ Burkina Faso bọ́mbụ̀
FACT CHECK: No evidence US struck Burkina Faso with missiles
FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020
FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀
Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

Claire Mom
By Claire Mom Published August 7, 2025 3 Min Read
Share

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey break into residential apartment hapun for south-east.

On July 26, Uche Nworah, one Facebook user, reference di video to complain about how di “culture of violence” dey hapun wella for di south-east “under di name of fighting insecurity”.

“We don create culture of violent, opportunistic behaviour for Southeast ontop fighting insecurity. Any armed, hooded and untrained individual, accompanied by im mates wey don probably take drugs fit enta your house do different acts of aggression, as we see for dis video wey no get date,” na so im write for di video.

“No proper protocols dey dis place, and dem no dey respect human rights. When dis terror go end? Imagine sey children bin dey live for di house.”

Screenshot of di Facebook post

Di post gada over 200 comments, 400 likes, and 48 shares.

Di Facebook user publish di video as insecurity dey rise for some parts of di south-east.

WETIN WE CHECK

CableCheck analysed keyframes of di video wey Nworah post for Google Lens. Di results show sey di video first comot for internet sake of one X user identified as @MichealFrosh32, on July 25.

Di X user claim sey police officers under di codename “operation flush” for Ado Ekiti bin forcefully break into one apartment for Adebayo street for di Ekiti state capital.

Screenshot of di X post

“As of today, Operation Flush for Ado-Ekiti attempt daylight robbery for one apartment for Adebayo, Ado-Ekiti, by forcefully attacking di premises. No be dia first time, but today we get evidence to stand up for our rights. #saveUs #NANSAdoekiti #PoliceProtest,” na so di X user write.

For di video, one of di armed men wear one black outfit wey get di writing: “special force”.

Di post comot different reactions for di microblogging platform as e catch police attention.

Twenty-four hours afta di video appear online, di Ekiti police command release statement wey tok sey dem no get unit codenamed “operation flush” as di viral X post claim.

For di statement, Abutu Sunday, di command chief informate, tok sey Joseph Eribo, di state police commissioner, don order one investigation into di incident.

“Di Police no dey operate any unit called Operation Flush,” na so Sunday bin tok.

FINAL TOK

Di incident for di viral video no hapun for di south-east.

TAGGED: break in, Ekiti state, News in pidgin, Security operatives, south-east

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 7, 2025 August 7, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Kò sí ọ̀rọ̀ tó seé gbàgbọ́ nípa ọ̀rọ̀ tó sọ pé Amẹ́ríkà kọlu Burkina Faso pẹ̀lú ohun ìjà olóró

Ẹnì kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ orí ayélujára tí sọ pé…

August 28, 2025

No evidence sey US strike Burkina Faso with missiles

One social media user don claim sey United States missiles hit Burkina Faso, causing Ibrahim…

August 28, 2025

Babu wata hujjar Amurka ta jefa makamai masu linzami Burkina Faso

Wani mai amfani da shafukan sada zumunta ya yi ikirarin cewa makamai masu linzami da…

August 28, 2025

Ò nwéghị íhé ákáébe gósị́rị́ nà US tụ̀rụ̀ Burkina Faso bọ́mbụ̀

Ótù onye na soshal midia ekwuola na a tụrụ ngwa agha US n'obodo Burkina Faso…

August 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Kò sí ọ̀rọ̀ tó seé gbàgbọ́ nípa ọ̀rọ̀ tó sọ pé Amẹ́ríkà kọlu Burkina Faso pẹ̀lú ohun ìjà olóró

Ẹnì kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ orí ayélujára tí sọ pé orílẹ̀ èdè Amẹ́ríkà ti kọlu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 28, 2025

No evidence sey US strike Burkina Faso with missiles

One social media user don claim sey United States missiles hit Burkina Faso, causing Ibrahim Traoré, army presido, to revenge.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 28, 2025

Babu wata hujjar Amurka ta jefa makamai masu linzami Burkina Faso

Wani mai amfani da shafukan sada zumunta ya yi ikirarin cewa makamai masu linzami da Amurka ta harba a Burkina…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 28, 2025

Ò nwéghị íhé ákáébe gósị́rị́ nà US tụ̀rụ̀ Burkina Faso bọ́mbụ̀

Ótù onye na soshal midia ekwuola na a tụrụ ngwa agha US n'obodo Burkina Faso nke mere ka onye ndu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?