One viral video don allegedly show di time wey terrorists kill Musa Uba, one brigadier general, for Borno state.
Islamic State West Africa Province (ISWAP) fighters bin allegedlykill Uba afta dem ambush soldiers and operatives of di Civilian Joint Task Force (CJTF) for Borno on Friday.
Afta di ambush, reports begin comot sey dem kidnap Uba.
Howeva, Onyechi Anele, di army chief informate, deny di reports on Saturday, sey di brigadier general battle di “insurgents’ ambush wit beta gun,” force dem scata run.
Uba bin also reportedly release video statement to confam sey im still tanda gidigba.
ISWAP tok sey Anele informate na lie, sey dem kpai di military general afta dem capture am.
On Thursday, President Bola Tinubu later confam sey Uba die.
Afta ISWAP tok sey dem kill di brigadier general, one video begin waka for social media as im alleged last moments.
For di video, di officer dey sidan for ground before dem shoot am for head.
Howeva, CableCheck notice some tins wey resemble artificial intelligence (AI) manipulation.
For di video, afta dem fire di gun, di general no fall down immediately. Instead, small time pass before im fall. Dat kain fall no normal for pesin wey dem stand close shoot.
“You fit see sey im even start to fall before di bullet touch am,” Timothy Avele, one security expert, tell CableCheck.
Also, impact no dey from di supposed bullet. After dem fire di shot, e no shake bodi, blood no comot, or any oda sign wen bullet touch im head. Di physical reaction no be di same wit real gunshot.
If dem shoot pesin for head, blood dey flow immediately, but im head remain di same and di ground wey im fall for clean.
Im cap sef no shift. Real bullet for knock am comot or at least shift am.
We bin also run di video for DOT (Deepfake Offensive Toolkit), one programmable deepfake offensive and detection software solution.
Di results show sey di video na AI.