TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show as helicopter fall no be from Israel-Hamas war
Share
Latest News
Kò sí ẹ̀rí tó sàfihàn pé Trump halẹ̀ pé òhun yóò ‘mu’ Tinubu láàárín wákàtí mẹrinlelogun
Evidence no dey sey Trump threaten to ‘capture’ Tinubu in 24 hours
Babu wata shaida da Trump ya yi barazanar ‘kama’ Tinubu a cikin sa’o’i 24
FACT CHECK: No evidence Trump threatened to ‘capture’ Tinubu in 24 hours
Anambra guber: Six misconceptions about BVAS, IREV voters should know
FACT CHECK: How true is ADC’s claim that FG is misleading Nigerians on reduced food prices?
Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?
Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show as helicopter fall no be from Israel-Hamas war

Claire Mom
By Claire Mom Published November 16, 2023 5 Min Read
Share

One viral video for social media show as dem shoot down helicopters for sky wit rockets.

Claims wey folo di video tok sey na Israeli helicopters bin fall down and sey na Hamas, di Palestinian militant group, naim down am for di war wey dem dey fight.

“See as dem down Israeli helicopters,” na so @Sentletse, confam X user tweet give im 273k followers on October 8.

Israeli helicopters getting smashed 💥 pic.twitter.com/po5AL4PRoo

— Sentletse 🇷🇺🇿🇦🇵🇸 (@Sentletse) October 8, 2023

For di video, two helicopters, one ontop di oda, bin dey fly for one place wey resemble village till rocket come down dem, na so di helicopters catch fire. 

As of di time wen dis tori comot, di post gada 10.6m views, over 8k likes, 3k comments, 1k comments and bookmarks.

#HamasTerrorists
Two helicopters of Israel Shot down by Hamas#IsraelUnderAttack #Gaza #Sderot #Israël #Palestine #Israel #Hamas #War #AlMayadeen #Palestine #AlAqsaFlood #طوفان_الأقصى #IsraelUnderAttack #mosad #IndiaWithIsrael #TelAviv #KuShiv #IStandWithIsrael #savas pic.twitter.com/ryeisXoax0

— Arun Gangwar (@AG_Journalist) October 7, 2023

On October 7, Arun Gangwar, one journalist wey tok sey e don work wit some Indian news companies including India Daily Live, folo post di video, come support Israel wit im hashtags.

“#HamasTerrorists Hamas shoot two Israel helicopters,” na so Gangwar tweet.

As of dis time, di post don gada more dan 214k views, 489 likes, 150 comments, 95 retweets, and 25 bookmarks.

“Hamas fighter shoot two more Israel helicopters for Gaza Palestine,” na so anoda X post from @its_ishaq_khan tok.

Di post gada 27k views, 20 comments, 22 likes, and 14 retweets.

WETIN HAPUN BEFORE

On October 7, di Hamas militant group enta Israel from Gaza through di air, land and sea, to open anoda chapter for di complicated war wey Israel and Palestine don dey fight since di world begin. 

After di attack, about 1,400 people, mostly innocent pipu, die. Dem come kidnap nearly 200 pipu.

Gaza, wey dey controlled by di militant group, na small land wey dey squeezed in between Israel and the Mediterranean Sea, but e get short southern border wit Egypt.

Hamas call di attack “Operation Al-Aqsa Storm”, come claim sey dem plan am for two years.

According to Hamas ogas, dem don fire pass 5,000 rockets enta Israel as revenge for di “rubbish” wey dem do di Al-Aqsa Mosque for Jerusalem and di hundreds of Palestinians wey dem don kpai.

As reply, Israel, through di mouth of Benjamin Netanyahu, prime minister, swear sey dem go destroy di Hamas militant group. Israel come warn di pipu wey dey live for Gaza sey make dem run comot becos di Israeli Defence Forces (IDF) go use force run di city.

But di videos wey dey waka evriwhere for social media get anything to do wit di Israel and Hamas kasala? 

VERIFICATION

One keyword search for X show sey di videos begin dey go viral from October 7, di day wey Hamas do di surprise attack, and dem don dey waka for internet since den. Dem share di latest one on October 10.

Reverse image search come show sey one earlier version of di video bin dey internet on October 3 for YouTube ontop Kazinka Warrior, one video game community page.

“No bi real life situation be dis na just computer acting” na so dem describe di video.

As we cari eye look di page, we see sey oda game videos specifically from Arma 3, one military computer game wey dem act as future war for 2035.

In 2022, Bohemia Interactive, di pipu wey develop Arma 3, bin release statement sey pipu dey falsely connect some viral videos from dia game wit di war for Ukraine.

If pesin wan differentiate game video from real life fight, Bohemia Interactive sey make dem check for signs like low-quality video, particles wey no dey natural like clouds wey no too pure, shaky camera, and human beings wey no resemble real life pesin especially wit dia walking step. 

FINAL TOK

Di viral video wey show as two helicopters fall from sky sake of sey dem shoot am with rocket no dey connected wit d ongoing Israel-Hamas war. Di video na from Arma 3, a military computer game.

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 November 16, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Kò sí ẹ̀rí tó sàfihàn pé Trump halẹ̀ pé òhun yóò ‘mu’ Tinubu láàárín wákàtí mẹrinlelogun

Ọ̀rọ̀ kan sọ pé Donald Trump, ààrẹ orílẹ̀ èdè Amẹ́ríkà ti dúnkokò pé òhun yóò…

November 14, 2025

Evidence no dey sey Trump threaten to ‘capture’ Tinubu in 24 hours

One report don claim sey US President Donald Trump threaten to capture President Bola Tinubu…

November 14, 2025

Babu wata shaida da Trump ya yi barazanar ‘kama’ Tinubu a cikin sa’o’i 24

Wani rahoto ya bayyana cewa shugaban kasar Amurka Donald Trump ya yi barazanar kama shugaban…

November 14, 2025

FACT CHECK: No evidence Trump threatened to ‘capture’ Tinubu in 24 hours

A report claims that US President Donald Trump threatened to capture President Bola Tinubu within…

November 13, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Kò sí ẹ̀rí tó sàfihàn pé Trump halẹ̀ pé òhun yóò ‘mu’ Tinubu láàárín wákàtí mẹrinlelogun

Ọ̀rọ̀ kan sọ pé Donald Trump, ààrẹ orílẹ̀ èdè Amẹ́ríkà ti dúnkokò pé òhun yóò mú Bọ́lá Tinubu, ààrẹ orílẹ̀…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 14, 2025

Evidence no dey sey Trump threaten to ‘capture’ Tinubu in 24 hours

One report don claim sey US President Donald Trump threaten to capture President Bola Tinubu inside 24 hours and im…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 14, 2025

Babu wata shaida da Trump ya yi barazanar ‘kama’ Tinubu a cikin sa’o’i 24

Wani rahoto ya bayyana cewa shugaban kasar Amurka Donald Trump ya yi barazanar kama shugaban Bola Tinubu cikin sa’o’i 24…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 14, 2025

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn àwòrán lórí àwọn ohun ìgbàlódé…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?