TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show as ‘bridge collapse for Nasarawa’ na AI
Share
Latest News
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show as ‘bridge collapse for Nasarawa’ na AI

Claire Mom
By Claire Mom Published July 29, 2025 4 Min Read
Share

One video wey show as bridge dey collapse dey waka for social media, especially Facebook.

For di five-second video, di overhead bridge collapse as vehicles dey pass under and pipu dey run from di area.

Some Nigerian social media users post di video with captions wey suggest sey di incident hapun for di kontri.

One Facebook user identified as Goodluck Pyagbara with over 7,000 followers post di video write sey: “How APC 10billion bridge collapse”.

Screenshot of di Facebook post

Anoda Facebook user, Eze Ferdinand, post di video write sey: “Look as di flyover bridge just collapse. Wetin dey cause dis collapse?”.

On Wednesday, anoda Facebook user identified as Abass Tom post screenshots of di video and im claim sey di bridge dey Lafia, Nasarawa state.

Screenshot of di Facebook post

Di Facebook user claim sey di bridge collapse “three weeks” afta commissioning and sey dem spend “10billion” to construct di bridge.

“Breaking News JUST IN Flyover collapse afta 3 weeks of commissioning for Lafia, Nassarawa State. Dem spend 10 Billion ontop dis project,” na so di Facebook user write.

Some hours afta, di Facebook user edit di caption claim sey di tin hapun for Bihar, India.

“Flyover collapse afta 3 weeks of commissioning for di Khagaria-Aguwani bridge collapse for Bihar. Pictures show as part of di bridge collapse (Source: India Today). Dem spend 10 Billion ontop dis project,” di user come write.

Again, di user change di caption make e show sey di incident no hapun for Nigeria.

CableCheck discover di changes afta we look di edit history.

Screenshot of di edit history

One Facebook account — Dee Elegantz — wey get ova 11,000 followers also share screenshots of di video join am wit di Lafia, Nasarawa claim.

Screenshot of the post

One Indian X user @ManishCEO post di video, tok sey e hapun for Bihar, one state for India.

Screenshot of di X post

Anoda X user also claim sey e hapun for Bihar.

WETIN WE CHECK

First of all, CableCheck notice sey di pipu for di right side of di bridge dey run towards di side wey bin dey collapse instead of away from di incident. No be so human beings dey do wen kasala bust.

Second, di SUV for di video just dey move go di spot of di collapse, and di part of di road wey di SUV bin dey go no show any cracks.

Di trees for both sides of di road no clear, and di time wey one of di bridge pillars fall go di right side of di road, e look like sey tree no dey di location.

More search show one Facebook page wey dey usually post AI videos. Di page bin post clearer version of di video on July 14.

Di page write sey “dem use AI make” di video

Screenshot of di post wey tok sey dem use AI make di video.FINAL TOK

Dem use AI make di viral video.

TAGGED: AI-generated videos, Nasarawa bridge collapse, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 29, 2025 July 29, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12

RoundCheck, a fact-checking organisation, is set to host a youth-focused poetry festival on media and…

December 8, 2025

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?