TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video wey show as ‘bridge collapse for Nasarawa’ na AI
Share
Latest News
FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020
FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀
Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok
Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC
È nwélá ọ́nwụ́ ńdị́ ụ́kà nà Naijiria n’áfọ̀ 2025 kárị́á ọ́nụ́ ọ́gụ́gụ́ ndị́ Palestinian é gbụ́rụ́ na Gaza?
Na true sey dem kill Christians for Nigeria dis year pass Palestinians for Gaza?
Ǹjẹ́ àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́ tí wọ́n pa ní Nàìjíríà ju àwọn ọmọ Palestine tí wọ́n pa ní Gaza lọ ní 2025?
Yi Kiristoci da aka kashe a Nijeriya a 2025 sunfi na faltunawan dake Gaza?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video wey show as ‘bridge collapse for Nasarawa’ na AI

Claire Mom
By Claire Mom Published July 29, 2025 4 Min Read
Share

One video wey show as bridge dey collapse dey waka for social media, especially Facebook.

For di five-second video, di overhead bridge collapse as vehicles dey pass under and pipu dey run from di area.

Some Nigerian social media users post di video with captions wey suggest sey di incident hapun for di kontri.

One Facebook user identified as Goodluck Pyagbara with over 7,000 followers post di video write sey: “How APC 10billion bridge collapse”.

Screenshot of di Facebook post

Anoda Facebook user, Eze Ferdinand, post di video write sey: “Look as di flyover bridge just collapse. Wetin dey cause dis collapse?”.

On Wednesday, anoda Facebook user identified as Abass Tom post screenshots of di video and im claim sey di bridge dey Lafia, Nasarawa state.

Screenshot of di Facebook post

Di Facebook user claim sey di bridge collapse “three weeks” afta commissioning and sey dem spend “10billion” to construct di bridge.

“Breaking News JUST IN Flyover collapse afta 3 weeks of commissioning for Lafia, Nassarawa State. Dem spend 10 Billion ontop dis project,” na so di Facebook user write.

Some hours afta, di Facebook user edit di caption claim sey di tin hapun for Bihar, India.

“Flyover collapse afta 3 weeks of commissioning for di Khagaria-Aguwani bridge collapse for Bihar. Pictures show as part of di bridge collapse (Source: India Today). Dem spend 10 Billion ontop dis project,” di user come write.

Again, di user change di caption make e show sey di incident no hapun for Nigeria.

CableCheck discover di changes afta we look di edit history.

Screenshot of di edit history

One Facebook account — Dee Elegantz — wey get ova 11,000 followers also share screenshots of di video join am wit di Lafia, Nasarawa claim.

Screenshot of the post

One Indian X user @ManishCEO post di video, tok sey e hapun for Bihar, one state for India.

Screenshot of di X post

Anoda X user also claim sey e hapun for Bihar.

WETIN WE CHECK

First of all, CableCheck notice sey di pipu for di right side of di bridge dey run towards di side wey bin dey collapse instead of away from di incident. No be so human beings dey do wen kasala bust.

Second, di SUV for di video just dey move go di spot of di collapse, and di part of di road wey di SUV bin dey go no show any cracks.

Di trees for both sides of di road no clear, and di time wey one of di bridge pillars fall go di right side of di road, e look like sey tree no dey di location.

More search show one Facebook page wey dey usually post AI videos. Di page bin post clearer version of di video on July 14.

Di page write sey “dem use AI make” di video

Screenshot of di post wey tok sey dem use AI make di video.FINAL TOK

Dem use AI make di viral video.

TAGGED: AI-generated videos, Nasarawa bridge collapse, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 29, 2025 July 29, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020

Ngalaba Federal Road Safety Corps (FRSC) akọwala n'ihe ngosi ebe onye ọ̀kwà ụgbọala ụkwụ atọ…

August 22, 2025

FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀

Àjọ tó ń rí sí ààbò àwọn awakọ̀, àwọn tí wọ́n ń rìn lójú ọ̀nà…

August 22, 2025

Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok

The Federal Road Safety Corps (FRSC) don describe one viral video wey show as keke…

August 22, 2025

Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC

Hukumar kiyaye hadurra ta kasa (FRSC) ta bayyana wani faifan bidiyo da ke nuna wani…

August 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020

Ngalaba Federal Road Safety Corps (FRSC) akọwala n'ihe ngosi ebe onye ọ̀kwà ụgbọala ụkwụ atọ na ndị ọrụ ya na-enwe…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀

Àjọ tó ń rí sí ààbò àwọn awakọ̀, àwọn tí wọ́n ń rìn lójú ọ̀nà tí ọkọ̀ ń rìn àti…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok

The Federal Road Safety Corps (FRSC) don describe one viral video wey show as keke rider dey open eye for…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC

Hukumar kiyaye hadurra ta kasa (FRSC) ta bayyana wani faifan bidiyo da ke nuna wani direban babur mai uku yana…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?