TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Video of #EndBadGovernanace protest for Edo no hapun for Ibadan as viral posts claim
Share
Latest News
FACT CHECK: Video of Ghanaian school fire incident falsely described as razed Nigerian church
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Video of #EndBadGovernanace protest for Edo no hapun for Ibadan as viral posts claim

Claire Mom
By Claire Mom Published October 23, 2024 3 Min Read
Share

On Tuesday, some social media users claim sey protesters for Ibadan, di Oyo state capital, ask di Nigerian military to collect power from President Bola Tinubu.

For di one-minute video, one pickup truck wey cari some soldiers dey move slowly for road as some pipu dey protest for front.

One man voice come dey shout: “Tinubu must go. We want make di Nigerian army take over. I no know why dem dey fear.”

Dem share di video wella for Facebook, Twitter, and WhatsApp.

One X user, @SabinaNkiru, wit ova 11,000 followers, post di video come write sey: “Protesters for Ibadan block Nigerian Army vehicles, dey ask dem why dem dey fear to collect govment from Tinubu”.

Di post, saved here, don gada pass 1,700 views and 18 requotes.

Anoda X user, @PrinceUjay, wit ova 45,000 followers, post di same video wit di caption: “Situation dey hot for Ibadan as Protesters block Nigerian Army Vehicles dey tell dem sey make dem take ova di govment, sey di suffering under President Tinubu don pass power.”

Di post don gada pass 2,000 views wit 27 requotes. Saved here.

Oda versions of di post dey saved for here and here.

WETIN WE CHECK

A close look at di video show sey na from one TikTok user @mikkyforlife0 e comot.

Searches ontop di TikTok page of di user show sey dem bin releade di video on August 2, 2024, during di nationwide #EndBadGovernance protest.

Di protest against du economic hardship bin hapun for many parts of di kontri between August 1 and 10, 2024.

Also, one campaign banner of Asue Ighodalo, Edo governorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), bin sidan ontop one advertising board for road.

Di protesters bin march past di two-lane road in front of TotalEnergies lorry park filling station for Benin City.

Di filling station dey along Upper Mission Road, Benin, di Edo state capital.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey protesters for Ibadan ask di Nigerian army to collect power from di democratic government no correct as di video bin hapun for Benin during di August nationwide protest.

TAGGED: #EndBadGovernanace protest, Edo, Ibadan, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom October 23, 2024 October 23, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video of Ghanaian school fire incident falsely described as razed Nigerian church

A TikTok user claims that jihadists have razed a church in the northern part of Nigeria. The…

December 11, 2025

RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12

RoundCheck, a fact-checking organisation, is set to host a youth-focused poetry festival on media and…

December 8, 2025

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?