TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Scent leaf dey clean kidney?
Share
Latest News
Kò sí ẹ̀rí tó sàfihàn pé Trump halẹ̀ pé òhun yóò ‘mu’ Tinubu láàárín wákàtí mẹrinlelogun
Evidence no dey sey Trump threaten to ‘capture’ Tinubu in 24 hours
Babu wata shaida da Trump ya yi barazanar ‘kama’ Tinubu a cikin sa’o’i 24
FACT CHECK: No evidence Trump threatened to ‘capture’ Tinubu in 24 hours
Anambra guber: Six misconceptions about BVAS, IREV voters should know
FACT CHECK: How true is ADC’s claim that FG is misleading Nigerians on reduced food prices?
Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?
Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Scent leaf dey clean kidney?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 5, 2022 4 Min Read
Share

One post wey pipu share for Facebook and Whatsapp claim sey scent leaf dey clean kidney without pain.

“As years dey pass, our kidney dey clean blood, comot salt, poison and anything wey dey spoil our body,” na so one old post wey dem share for Facebook tok. 

Di post claim sey as time dey pass, salt dey gada for kidney, na why pipu suppose clean am.

To clean am well, di post tell social media users sey make dem dey boil scent leaf, come filter am drink for tea.

“Drink one cup everyday, you go see say all the salt and poison wey gada for your kidney go comot as you dey piss. Na di ogbonge cleaning treatment for kidney be dis, and e dey natural,” na so di post explain.

Di name wey science pipu give di scent leaf na Ocimum gratissimum. Di oda oyibo name na wild basil or tree basil.

For yoruba, di name na Ewe Efinrin, for Igbo na Nchuanwu in Igbo, and for Hausa na Daidoya.

As dem post am for Whatsapp, di post even advise pipu make dem share am reach dia friends and family.

Kidney na one of di most important tins for body. Di shape dey like beans and e dey two places by di side of di spine, under di ribs.

Di kidney work na to clean blood, comot dotty and to control water for body.

Wetin we check

TheCable follow pipu wey bi ogbonge for medicine tok, to check weda scent leaf dey clean kidney.

Theophilus Umeizudike, nephrologist for di Lagos State University Teaching Hospital tok sey, “science no support say scent leaves fit clean kidney”. 

He advise Nigerians sey make dey shine eye for social media, especially if no be from ogbonge source.

“As pipu dey read tins online, make dem sure say na from place wey get beta name. Make dem confam say science support di medicine,”  na so im tok.

Caring for di kidney

TheCable still folo Awofeso Opeyemi, research fellow for di Harvard Medical School and Dana-Farber Cancer Institute for Massachusetts, USA, tok.

She sey notin dey like dat for science wey gree for scent leaf as kidney cleaning treatment. 

“Kidney health no need plenti tin, just dey drink water. Di way our body dey, if pesin dey drink enof water (12 cups for adult), e go hard to catch kidney disease. You no need add anything,” na so she tok.

According to Awofeso, make di kidney for dey work well, pesin go dey put only small salt for food, drink plent water, and treat hypertension early.

She tok say if person no treat hypertension quick, kidney fit spoil.

“Hypertension na for life, if you dey take di medicine wey doctor give you everyday, your kidney go dey ok, if not ,dem fit comot am,” na so she tok.

“Make I tell you somtin, hypertension no dey give symptoms quick, na till kidney spoil. 

Sometimes, some pipu for dia 20s or 30s go meet doctor, doctor go tell dem say dem get hypertension come give dem drugs. After small time dem go stop to dey take di medicine because dem tink say dem don well. Na later wen dem old na im wahala go start.”

Final tok

Di claim wey tok say scent leaf dey clean kidney no be true. Science no tok anytin like dat.

TheCable ng · Pidgin: Scent leaf dey clean kidney?
TAGGED: health Fact-Check, hypertension, kidney treatment, scent leaf, Water

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 5, 2022 July 5, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Kò sí ẹ̀rí tó sàfihàn pé Trump halẹ̀ pé òhun yóò ‘mu’ Tinubu láàárín wákàtí mẹrinlelogun

Ọ̀rọ̀ kan sọ pé Donald Trump, ààrẹ orílẹ̀ èdè Amẹ́ríkà ti dúnkokò pé òhun yóò…

November 14, 2025

Evidence no dey sey Trump threaten to ‘capture’ Tinubu in 24 hours

One report don claim sey US President Donald Trump threaten to capture President Bola Tinubu…

November 14, 2025

Babu wata shaida da Trump ya yi barazanar ‘kama’ Tinubu a cikin sa’o’i 24

Wani rahoto ya bayyana cewa shugaban kasar Amurka Donald Trump ya yi barazanar kama shugaban…

November 14, 2025

FACT CHECK: No evidence Trump threatened to ‘capture’ Tinubu in 24 hours

A report claims that US President Donald Trump threatened to capture President Bola Tinubu within…

November 13, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Kò sí ẹ̀rí tó sàfihàn pé Trump halẹ̀ pé òhun yóò ‘mu’ Tinubu láàárín wákàtí mẹrinlelogun

Ọ̀rọ̀ kan sọ pé Donald Trump, ààrẹ orílẹ̀ èdè Amẹ́ríkà ti dúnkokò pé òhun yóò mú Bọ́lá Tinubu, ààrẹ orílẹ̀…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 14, 2025

Evidence no dey sey Trump threaten to ‘capture’ Tinubu in 24 hours

One report don claim sey US President Donald Trump threaten to capture President Bola Tinubu inside 24 hours and im…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 14, 2025

Babu wata shaida da Trump ya yi barazanar ‘kama’ Tinubu a cikin sa’o’i 24

Wani rahoto ya bayyana cewa shugaban kasar Amurka Donald Trump ya yi barazanar kama shugaban Bola Tinubu cikin sa’o’i 24…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 14, 2025

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn àwòrán lórí àwọn ohun ìgbàlódé…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?