TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Sanusi don tok di koko why Obi, Tinubu, Atiku wan be presido?
Share
Latest News
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Shin Tinubu ya halarci makaranta daya da Alexander Zingman? Ga abin da muka sani
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Sanusi don tok di koko why Obi, Tinubu, Atiku wan be presido?

Claire Mom
By Claire Mom Published June 21, 2022 3 Min Read
Share

One tori wey dey tok wetin dey di mind of di three presidential candidates for 2023 presidential elections don comot for social media.

Di tori tok say nobody for inside di candidates dey contest for money. Pipu yarn say na Sanusi Lamido Sanusi, former govnor for  central bank of Nigeria (CBN), write am.

Di first part of di post say, “One funny tin be say none of dis 3 pipu dey find money for dis president title.”

Di tori follow tok say Atiku Abubakar, presidential candidate for Peoples Democratic Party (PDP) don chop di country “well well”. Di tori tok say Atiku just wan make dem call am “president” by faya by force. 

E come tok say Bola Tinubu, presidential candidate for diAll Progressives Congress (APC), just wan become president because e don dey hungry am since im enter politics. Di tori say, “Di main tin be say im just wan show us pepper wit corruption.”

Ontop Peter Obi, di presidential candidate for Labour Party, di post say di former govnor of Anambra na man wey notin dey enter im eye. Obi just wan save Nigeria from di big wahala wey dey come, di post tok again say na why im wan be president be dat.

Since June 19 wey di post comot, plenty pipu don share am for Twitter, Facebook and oda social media platforms.

CeleSylv Updates, one Facebook page wey get 70,000 followers share am on June 19. Di post get more dan 3,000 shares, 1,800 likes and 1,400 comments.

One Twitter user, Fame Kid, post di tweet at for 2:29pm dat same day and e come get pass 2,000 likes and 1,301 retweets.

Today being #June19 Sanusi the former CBN Governor describes the three Presidential candidates in his own word 👇👇#WorldSickleCellDay #ASUU kirikiri Obi's VP Consent Ruger Ckay Rufai Airtel #PeterObiForPresident2023 pic.twitter.com/ahXne7OZA5

— FÄMËKīīD🇳🇬⚕️ (@famekiid_) June 19, 2022

Max Vayshia, anoda user wey post di tori, get pass 1, 300 likes, 873 retweets and 57 comments.

Listen, there has been NO better description of the 3 Presidential aspirants than this. I promise you, you won't be getting a better description of Peter Obi, Jagaban and Atiku. Sanusi is SPOT ON on this. READ👇🏾 pic.twitter.com/ILLUu34otH

— Maxvayshia™ (@maxvayshia) June 19, 2022

I just saw this flying around, Have you read the way Mohammad Sanusi described the three presidential candidates!
Atiku | tinubu | Peter Obi

I can see some comments online backlashing the post. Whichever way the post is 100% truth.

It is left for us to make our own decisions. pic.twitter.com/0C9TY0xbYG

— Hauwa (@hauwaladisanusi) June 19, 2022

https://twitter.com/austine_okpegwa/status/1538592999638171653?ref_src=twsrc%5Etfw%7Ctwcamp%5Etweetembed%7Ctwterm%5E1538592999638171653%7Ctwgr%5E%7Ctwcon%5Es1_&ref_url=https%3A%2F%2Fwww.thecable.ng%2Ffact-check-did-sanusi-author-viral-write-up-on-atiku-tinubu-and-obi

Di comments show say plenti social media users believe di story sotey dem even praise di pesin wey write am.

 

 

Wetin we check

As TheCable check, we see say no beta media platform post di tori wey pipu claim say na di former CBN govnor write.

We con askSanusi weda na him write am, he say no. “No be me write dat tori, na fake news,” na so Sanusi tell TheCable.

Final Tok

Di post wey dey tok about di real reason why Atiku, Tinubu and Obi wan be president no be true. No be Sanusi Lamido Sanusi write am.

 

 

TAGGED: asiwaju bola tinubu, atiku abubakar, former CBN governor Sanusi Lamido Sanusi, peter obi

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 June 21, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?