TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Ruto na di first African leader wey US invite in 20 years?
Share
Latest News
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?
FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?
FACT CHECK: Viral image depicting ‘Obasanjo prostrating for Ladoja’ photoshopped
Wike tụ̀rụ̀ àsị́. Peter Obi mèrè ńtụ̀líáká ọ̀chị́chị́ ḿpághárá m̀gbè ọ́ bụ̀ gọ́vánọ̀ Anambra
Irọ́ ni Wike pa. Peter Obi ṣètò ìdìbò ìjọba ìbílẹ̀ nígbà tí ó jẹ́ gómìnà Ìpínlẹ̀ Anambra
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Ruto na di first African leader wey US invite in 20 years?

Claire Mom
By Claire Mom Published March 18, 2024 4 Min Read
Share

E neva tey wey William Ruto of Kenya tok sey na im bi di first African president in 20 years wey di United States president go invite come state visit.

Ruto make di claim for di mega crusade of Benny Hinn, di televangelist, wey hapun for Nairobi, Kenya, on February 24 and 25.

“Di USA president don invite di president of Kenya for state visit. One of a kind in 20 years, no African president don get state visit for di USA,” na so im sweet im belle as e tok.

Di video wey im make di tok, wey Citizen TV publish, don gada pass 239,000 views inside 11 days ontop YouTube channel wey get more dan 4.6 million subscribers.

Di claim wey Ruto make comot different reactions from some Kenyans ontop X(former Twitter), as some dey repost di president comments and odas dey celebrate di alleged achievement.

As X user Sirengo Maurice tok sey Ruto go soon “put Kenya ontop di  global map wit history-making” state visit, anoda user dey quarrel sey why di presido go dey tok state visit mata for religious crusade.

WETIN BE STATE VISIT?

State visit na formal visit by di head of state of one kontri to di head of state of anoda kontri. Usually, na di pesin wey di head of state go meet naim make di invitation.

Osita Agbu, professor of international relations for Baze University for Nigeria, tok sey state visits dey “extremely important” and “holistic”, as dem dey provide opportunity for di leaders of di kontris to discuss different important issues.

Di United States dey look state visit as di highest expression of friendly bilateral relations between di kontri and anoda foreign state. E dey usually last for four days and e dey get some official public ceremonies.

Di events dey include White House dinner, state department luncheon, and invitation to stay for Blair House, di confam place wey several foreign dignitaries wey dey visit Washington DC dey stay. Blair House na place wey dem dey also call di president’s guesthouse.

Typically, state visits no be to discuss or argue policies. Dem be celebration wey dey focus on how dem fit strengthen di relationship between di leaders of both kontries.

WETIN WE CHECK

To check whether Ruto claim correct or not, TheCable check di records of di earliest and most recent state visits to di US by African presidents.

President Edwin Barclay of Liberia naim be di first leader of an African nation to travel to di US for state visit in 1943 during di administration of Franklin Roosevelt, di 32nd US president.

Meanwhile, for 2008 — sixteen years ago — George Bush, di 43rd president of the US, host John Kuffour, forma president of Ghana, and im wife  for di White House.

Bush thank Kuffour and im delegation sey dem honour di visit and im praise di Ghanaian president for im “compassion and effort in building  thriving democracy”.

Before Kuffor visited di US in 2008, Mwai Kibaki, di third president of Kenya, bin also do state visit sake of Bush in October 2003.

FINAL TOK

Di claim wey President Ruto make no correct. Although na im bi di first Kenyan president wey di US for state visit in over two decades, im no be di first African president to receive state visit invitation from a US president in 20 years. 

TAGGED: state visit, William Ruto

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 8, 2024 March 18, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị…

July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé…

July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by…

July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani…

July 18, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị nkwekọrịta azụmahịa akụ ọnatarachi dị…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé orílẹ̀ èdè Nàìjíríà hùwà sí…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by stopping one alleged mineral deal…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani ne kan takunkumin da Amurka…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?