TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Protesters no burn Nyanya police station
Share
Latest News
MISINFO ALERT: No evidence Shettima said ‘N8,000 can change the life of a youth’
Ụ́zọ̀ àsáà é jì àmátá íhé ńgósị́ é jìrì AI nwòghárị́á
Ọ̀nà méje tí ó lè fi mọ fídíò tí wọ́n fi AI se
Hanyoyi bakwai don gano bidiyon da AI ya samar
Seven ways you fit confam AI video
FACT CHECK: Have more Christians been killed in Nigeria in 2025 than Palestinians in Gaza?
HOAX ALERT: Cross River disowns viral Cally Air ‘boobs safety’ assurance advert
Seven ways to detect an AI-generated video
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Protesters no burn Nyanya police station

Claire Mom
By Claire Mom Published August 6, 2024 3 Min Read
Share

One video wey dem share for social media claim sey protesters burn Nyanya police station during di August 1 demonstration.

Di 43-second video, wey doh go viral since, show as some young boys bin dey destroy properties for one checkpoint ontop di busy Abuja-Keffi expressway. 

One voice for di video claim sey angry youths wey dey protest di economic hardship for di kontri burn di Nyanya police station, wey dey outskirts of Abuja.

Di video wey one  one Okezie Atani post for X via im verified handle, @Onsogbu, don gada pass 18,000 views, 151 likes and 115 reposts.

Dem also post di video for Facebook and e folo enta WhatsApp.

DI #ENDBADGOVERNANCE PROTEST

On Thursday, youths across Nigeria bin enta streets to protest food inflation, increase for petrol price, insecurity and high governance costs, among oda issues.

Di federal govment bin appeal to di protest organisers sey make dem pack di planned demonstrations go one side, and sey make dem dey patient.

Di police bin also ask di protesters to identify themselves to prevent thugs wey wan hijack di planned action.

For Abuja, dem tok sey make di protest only hapun for MKO Abiola Stadium — but some anti-government protesters wey gada around around Eagle Square, Unity Fountain and oda location no gree.

HOW WE CHECK DI CLAIM

To check weda dem burn Nyanya police station true true, TheCable cari small eye look Google Maps and Google Earth.

Google Maps show sey di Nyanya police station na 2.1km — about five minutes drive — from di checkpoint where di incident hapun.

Google Earth on di other hand show sey no police station dey di reported location.

Google Map photo showing the distance between Nyanya police station and the checkpointGoogle Earth image: There’s no police station in the vicinity

TheCable bin folo contact Josephine Adeh, FCT police spokesperson, wey tok sey protesters bin no burn di police station.

Di FCT police command tok sey di na di “traffic control container compartment” for di Nyanya checkpoint wey dem bin burn.

“Contrary to di tori wey bin dey travel sey violent protesters burn di Nyanya division, di FCT police command wan clarify sey no be di police division wey dem burn instead na di police container compartment for Nyanya checkpoint wey dem burn,” na so di statement tok.

“Some four (4) suspects bin try destroy di Tipper garage Police post, Mathias Jude 29 ‘m’ of Nyanya Area D, Mohammad Ahmed (23), Abba Jibril (18) and Mohammad Haruna (18), wey police don arrest.”

FINAL TOK

Di claim wey tok sey na di Nyanya police station wey protesters burn no correct. Di hoodlums bin only destroy di police container compartment for traffic controllers ontop checkpoint for Nyanya.

 

TAGGED: Fact check in pidgin, Nyanya police station, protests

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 6, 2024 August 6, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

MISINFO ALERT: No evidence Shettima said ‘N8,000 can change the life of a youth’

A viral post claiming that Vice-President Kashim Shettima said “N8,000 can change the life of…

August 19, 2025

Ụ́zọ̀ àsáà é jì àmátá íhé ńgósị́ é jìrì AI nwòghárị́á

Íhé ngosị na-ekwupụta nkesa ọgwụ na-agwọ ọrịa diabetes pụtara ìhè na soshal midia Naịjiria. Íhé…

August 19, 2025

Ọ̀nà méje tí ó lè fi mọ fídíò tí wọ́n fi AI se

Fídíò kan tí ó ń se ìkéde ìtọ́jú aarun suga káàkiri orílẹ̀ èdè Nàìjíríà ti…

August 19, 2025

Hanyoyi bakwai don gano bidiyon da AI ya samar

A kwanakin baya ne wani faifan bidiyo da ke sanar da kaddamar da maganin ciwon…

August 19, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ụ́zọ̀ àsáà é jì àmátá íhé ńgósị́ é jìrì AI nwòghárị́á

Íhé ngosị na-ekwupụta nkesa ọgwụ na-agwọ ọrịa diabetes pụtara ìhè na soshal midia Naịjiria. Íhé ńgósị́ ahụ kwuru na Ali…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 19, 2025

Ọ̀nà méje tí ó lè fi mọ fídíò tí wọ́n fi AI se

Fídíò kan tí ó ń se ìkéde ìtọ́jú aarun suga káàkiri orílẹ̀ èdè Nàìjíríà ti káàkiri orí ohun ìgbàlódé íbaraẹnise…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 19, 2025

Hanyoyi bakwai don gano bidiyon da AI ya samar

A kwanakin baya ne wani faifan bidiyo da ke sanar da kaddamar da maganin ciwon suga na kyauta ya yadu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 19, 2025

Seven ways you fit confam AI video

One video wey announce di launch of free nationwide diabetes treatment recently go viral for Nigerian social media platforms. Di…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 19, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?