TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Protesters no burn Nyanya police station
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Protesters no burn Nyanya police station

Claire Mom
By Claire Mom Published August 6, 2024 3 Min Read
Share

One video wey dem share for social media claim sey protesters burn Nyanya police station during di August 1 demonstration.

Di 43-second video, wey doh go viral since, show as some young boys bin dey destroy properties for one checkpoint ontop di busy Abuja-Keffi expressway. 

One voice for di video claim sey angry youths wey dey protest di economic hardship for di kontri burn di Nyanya police station, wey dey outskirts of Abuja.

Di video wey one  one Okezie Atani post for X via im verified handle, @Onsogbu, don gada pass 18,000 views, 151 likes and 115 reposts.

Dem also post di video for Facebook and e folo enta WhatsApp.

DI #ENDBADGOVERNANCE PROTEST

On Thursday, youths across Nigeria bin enta streets to protest food inflation, increase for petrol price, insecurity and high governance costs, among oda issues.

Di federal govment bin appeal to di protest organisers sey make dem pack di planned demonstrations go one side, and sey make dem dey patient.

Di police bin also ask di protesters to identify themselves to prevent thugs wey wan hijack di planned action.

For Abuja, dem tok sey make di protest only hapun for MKO Abiola Stadium — but some anti-government protesters wey gada around around Eagle Square, Unity Fountain and oda location no gree.

HOW WE CHECK DI CLAIM

To check weda dem burn Nyanya police station true true, TheCable cari small eye look Google Maps and Google Earth.

Google Maps show sey di Nyanya police station na 2.1km — about five minutes drive — from di checkpoint where di incident hapun.

Google Earth on di other hand show sey no police station dey di reported location.

Google Map photo showing the distance between Nyanya police station and the checkpointGoogle Earth image: There’s no police station in the vicinity

TheCable bin folo contact Josephine Adeh, FCT police spokesperson, wey tok sey protesters bin no burn di police station.

Di FCT police command tok sey di na di “traffic control container compartment” for di Nyanya checkpoint wey dem bin burn.

“Contrary to di tori wey bin dey travel sey violent protesters burn di Nyanya division, di FCT police command wan clarify sey no be di police division wey dem burn instead na di police container compartment for Nyanya checkpoint wey dem burn,” na so di statement tok.

“Some four (4) suspects bin try destroy di Tipper garage Police post, Mathias Jude 29 ‘m’ of Nyanya Area D, Mohammad Ahmed (23), Abba Jibril (18) and Mohammad Haruna (18), wey police don arrest.”

FINAL TOK

Di claim wey tok sey na di Nyanya police station wey protesters burn no correct. Di hoodlums bin only destroy di police container compartment for traffic controllers ontop checkpoint for Nyanya.

 

TAGGED: Fact check in pidgin, Nyanya police station, protests

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 6, 2024 August 6, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?