One viral video for TikTok show one large crowd of protesters as Nigerians wey dey demand di release of Nnamdi Kanu, detained leader of di Indigenous People of Biafra (IPOB), for Abuja.
The video bin comot on Monday as activists assemble for different locations for Abuja sake of di #FreeNnamdiKanuNow protest.
Na Omoyele Sowore, publisher of Sahara Reporters and ex-presidential candidate, wey don dey mount campaign for Kanu release since dis year start naim start di protest.
Since dem re-arrest am in June 2021, Kanu don dey custody of di Department of State Services (DSS), where he im dey face ongoing trial for di federal high court for Abuja.
“Happening live for Abuja,” na so di TikTok video caption tok.
E don gada 840k views, 57.3k likes and ova 5,000 shares.
Dem also crest di video wit di same caption togeda wit one strong foto of Kanu as im dey pose wit hand for air, wit Biafran flag by di side.
One large crowd of protesters march through di streets with landmarks wey no dey Abuja.
CableCheck notice sey di protesters bin dey wave Nepalese flags.
Reverse image searches show sey dem bin post di videos in September as violent youth-led protests bin dey hapun for Nepal.
Di protests bin hapun because di govment ban 26 social media platforms.
Dem later lift di ban as di protests intensified.
FINAL TOK
Di protest video na from NEPAL, no be protesters wey dey call for Kanu release for Abuja.