TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, tribunal no tok sey LP candidate Pela win Delta govnorship election
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nigeria, India’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, tribunal no tok sey LP candidate Pela win Delta govnorship election

Claire Mom
By Claire Mom Published September 7, 2023 3 Min Read
Share

One video wey Hichief Sunny Odogwu, one Facebook user, post claim sey di tribunal tok sey Kennedy Pela, candidate of di Labour Party (LP), win di 2023 Delta guber election.

Im post di six-minute video on August 31.

“BREAKING: Court of Appeal Rule Sey Labour Party Govnorship Candidate, Ken Pela Win Di Delta State Govnorship Election,” na so dem write ontop di post wey don gada 70,000 views, 266 comments and 1,300 likes.

Odogwu still come ask di pipu wey don watch di video sey make dem share am give odas.

WETIN WE CHECK

E neva tey wey TheCable publish one tori wey di court of appeal for Abuja command di Delta state gubernatorial tribunal to hear di case wey Pela cari come.

Di Independent National Electoral Commission (INEC) bin announce sey na Sheriff Oborevwori, candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), win di March 18 election for di state.

Oborevwori bin gada 360,234 votes defeat Ovie Omo-Agege of di All Progressives Congress (APC) wey score 240,229.

Pela chop third position wit 48,027 votes, while Great Ogboru of di All Progressives Grand Alliance (APGA) sidan for fourth position with 11,021 votes.

Pela and im parti come file case for court to challenge di result, sey di candidates wey come first and second no dey qualified, dem chuk hand for corruption and sey dem no folo di Electoral Act.

Dem tell di tribunal sey make dem either annouce Pela as di winner of di election or make dem cancel di election do new one.

WETIN COURT TOK

During the first hearing, Damian Dodo, di main lawyer to di govnor and im deputy, argue sey di LP case bin dey abandoned.

Dodo tok sey di petitioner bin no appear for di seven-day period wey di law tok sey im suppose make case, sey Pela and LP still no come apply for anoda pre-hearing notice, therefore im no get case again.

Di main lawyer to di govnor and im deputy tok sey di pesin wey cari case come apply for pre-hearing notice on May 19 before dem close pleadings, and becos of dat, di case no get head and court suppose no look am.

C.H Ahuchaogu, di chairperson of di tribunal three-member panel, dismiss Pela case for di ruling.

Na so Pela and LP vex sake of di mata, come cari am go court of appeal.

On August 31, di appeal court come finally ansa dem and give order sey make tribunal hear dia case.

FINAL TOK

Di post wey claim sey di tribunal announce Pela as di winner of di Delta governorship election no correct.

Di court only gree sey make tribunal hear dia mata. As of di time wey dis tori comot, dem neva make any decision ontop di case.

TAGGED: Cable check, Delta state governorship election, Fact check pidgin, Kennedy Pela, Pidgin news

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom September 7, 2023 September 7, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nigeria, India’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?