TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, Pope Leo no beg Tinubu to release Nnamdi Kanu
Share
Latest News
HOAX ALERT: Cross River disowns viral Cally Air ‘boobs safety’ assurance advert
Seven ways to detect an AI-generated video
BLIND SPOT: Nigeria’s shortcomings in the age of AI scams
The rise of deepfakes and the fight for digital truth
DISINFO ALERT: Health ministry debunks AI video claiming free nationwide diabetes treatment
Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east
Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east
Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, Pope Leo no beg Tinubu to release Nnamdi Kanu

Claire Mom
By Claire Mom Published June 10, 2025 3 Min Read
Share

One Facebook user claim sey Pope Leo XVI and oda bishops join mouth beg President Bola Tinubu to release Nnamdi Kalu, di detained leader of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB), from jail.

@NgoziCommedy wey post di claim folo post video wey show as Tinubu dey yarn wit some bishops.

Di two-minute, 29-second video don gada 5.9k views, 60 reactions, 13 comments, and 16 shares.

“Pope Leo XVI and oda bishops in Rome beg President Bola Ahmed Tinubu to release Nnamdi Kanu make peace come back south east,” na so di post tok.

Anoda account folo post di same claim, @United Nations Mission for Referendum in Biafra Land, wey claim sey Pope Leo beg di Nigerian federal govment to release Nnamdi Kanu for di sake of peace for Nigeria and across Africa.

Kanu bin first chop arrest in 2015 ontop charges of treason but im later collect bail in 2017.

Im run comot for di kontri shortly after, but dem later re-arrest am in 2021 under some funny circumstances.

Im prolonged time for cell don spark legal battles, as many pipu dey call for im release.

WETIN WE CHECK

CableCheck analyse di frames from di video using Google Lens and we discova sey dem shoot am during Pope Leo inauguration.

The event on May 8 hapun as Pope Francis die on April 21 after long sickness.

President Tinubu bin dey among several world leaders and dignitaries wey attend di inauguration.

On di sidelines of di ceremony, Tinubu meet wit some bishops wey bin dey part of di Nigerian delegation to di Vatican.

For di original video, di bishops dey thank di president for di arrangement wey im make for dia sake to visit Vatican and for im time to attend di event in person.

Di pope bin no dey room di time wey Tinubu meet wit di bishops, and dem no request Nnamdi Kanu release at any time.

We also observe sey di users wey post di claims na pro-Biafra accounts.

Also, no confam media platform report di news.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey Pope Leo XVI and oda bishops beg Tinubu to release Nnamdi Kanu no correct.

TAGGED: News in pidgin, Nnamdi Kanu, Tinubu and Pope Leo

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 10, 2025 June 10, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

HOAX ALERT: Cross River disowns viral Cally Air ‘boobs safety’ assurance advert

The Cross River state government has disowned a viral image of a purported Cally Air…

August 15, 2025

Seven ways to detect an AI-generated video

A video announcing the launch of a free nationwide diabetes treatment recently went viral across Nigerian…

August 13, 2025

BLIND SPOT: Nigeria’s shortcomings in the age of AI scams

It sounded exactly like her, but it was not. Adeola Fayehun was thousands of miles…

August 12, 2025

The rise of deepfakes and the fight for digital truth

BY PRUDENCE OKEOGHENE EMUDIANUGHE On May 30, 2025, a 49-minute video surfaced on a YouTube…

August 12, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey break into residential apartment hapun…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east

Ótù onye na Facebook ekwuola na ihe ngosị ebe mmadụ na-agbaka ụlọ obibi mmadụ mere na south-east. N'ụbọchị iri abụọ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára sọ pé fídíò tí ó se afihan àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa wani faifan bidiyo da ke nuna jami’an tsaro dauke da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?