TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, Pope Leo no beg Tinubu to release Nnamdi Kanu
Share
Latest News
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Shin Tinubu ya halarci makaranta daya da Alexander Zingman? Ga abin da muka sani
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, Pope Leo no beg Tinubu to release Nnamdi Kanu

Claire Mom
By Claire Mom Published June 10, 2025 3 Min Read
Share

One Facebook user claim sey Pope Leo XVI and oda bishops join mouth beg President Bola Tinubu to release Nnamdi Kalu, di detained leader of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB), from jail.

@NgoziCommedy wey post di claim folo post video wey show as Tinubu dey yarn wit some bishops.

Di two-minute, 29-second video don gada 5.9k views, 60 reactions, 13 comments, and 16 shares.

“Pope Leo XVI and oda bishops in Rome beg President Bola Ahmed Tinubu to release Nnamdi Kanu make peace come back south east,” na so di post tok.

Anoda account folo post di same claim, @United Nations Mission for Referendum in Biafra Land, wey claim sey Pope Leo beg di Nigerian federal govment to release Nnamdi Kanu for di sake of peace for Nigeria and across Africa.

Kanu bin first chop arrest in 2015 ontop charges of treason but im later collect bail in 2017.

Im run comot for di kontri shortly after, but dem later re-arrest am in 2021 under some funny circumstances.

Im prolonged time for cell don spark legal battles, as many pipu dey call for im release.

WETIN WE CHECK

CableCheck analyse di frames from di video using Google Lens and we discova sey dem shoot am during Pope Leo inauguration.

The event on May 8 hapun as Pope Francis die on April 21 after long sickness.

President Tinubu bin dey among several world leaders and dignitaries wey attend di inauguration.

On di sidelines of di ceremony, Tinubu meet wit some bishops wey bin dey part of di Nigerian delegation to di Vatican.

For di original video, di bishops dey thank di president for di arrangement wey im make for dia sake to visit Vatican and for im time to attend di event in person.

Di pope bin no dey room di time wey Tinubu meet wit di bishops, and dem no request Nnamdi Kanu release at any time.

We also observe sey di users wey post di claims na pro-Biafra accounts.

Also, no confam media platform report di news.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey Pope Leo XVI and oda bishops beg Tinubu to release Nnamdi Kanu no correct.

TAGGED: News in pidgin, Nnamdi Kanu, Tinubu and Pope Leo

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 10, 2025 June 10, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?