TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party
Share
Latest News
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party

Claire Mom
By Claire Mom Published August 1, 2025 3 Min Read
Share
Francis Nwifuru

One social media post claim sey Francis Nwifuru, govnor of Ebonyi, suspend 25 commissioners and oda appointees becos dem no gree attend im pikin birthday party.

Di claim wey IgboHistory&Facts post for X don gada pass 117k views, 1.3k likes, 777 reposts, and 505 comments.

Dem join foto of Nwifuru, im wife and pikin wit di post. Social media users also post di claim here, here, and here.

On Tuesday, Nwifuru suspend 25 commissioners, 14 senior special assistants, 24 special assistants, and 22 permanent secretaries allegedly becos dem no gree attend important government function.

Di govnor tok sey di affected officials go serve one-month working suspension without salary and dem no go fit sign any official documents during di period.

WETIN WE CHECK

CableCheck review di governor’s Facebook page and we discover sey di foto wey dem use for di claim na from im dota birthday thanksgiving mass, on Sunday, July 27 — two days before dem announce di suspension.

We also folo Monday Uzor, chief press secretary to di Ebonyi governor, tok and im describe di claim as “mischievous”.

Uzor tok sey dem knack di officials suspension sake of sey dem no attend di basic school sports competition, wey di state Universal Basic Education Board (UBEC) organise.

According to am, di govnor bin ask Patricia Obila, im deputy, to represent am for di event and im instruct oda officials to also attend, but most of dem no go,

“Di govnor bin no dey and im bin instruct im deputy to represent am for di grand finale of di Basic School Sports competition wey di Universal Basic Education Board (UBEC) organise. Howeva, most of im commissioners and appointees no attend,” na so Uzor tell CableCheck.

“So, as di govnor hear wetin hapun, im take action, becos no be di first time wey dis tin dey hapun.

“Di pipu wey dey spread dis narrative just dey mischievous. Dem sabi di truth.

“And dat foto wey dey circulate, e no join wit di suspension. Dem bin snap am for private event wey di govnor host for July.”

We also search Obila Facebook page and discover sey di said event bin hapun on Friday, July 25 — two days before Nwifuru dota birthday.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey Nwifuru suspend im commissioners and appointees becos dem no gree attend im dota birthday no correct.

TAGGED: Francis Nwifuru, News in pidgin, Suspended Ebonyi commissioners

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 1, 2025 August 1, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12

RoundCheck, a fact-checking organisation, is set to host a youth-focused poetry festival on media and…

December 8, 2025

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?