TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, Nigeria no send peace support mission go Israel
Share
Latest News
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?
FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?
FACT CHECK: Viral image depicting ‘Obasanjo prostrating for Ladoja’ photoshopped
Wike tụ̀rụ̀ àsị́. Peter Obi mèrè ńtụ̀líáká ọ̀chị́chị́ ḿpághárá m̀gbè ọ́ bụ̀ gọ́vánọ̀ Anambra
Irọ́ ni Wike pa. Peter Obi ṣètò ìdìbò ìjọba ìbílẹ̀ nígbà tí ó jẹ́ gómìnà Ìpínlẹ̀ Anambra
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

Claire Mom
By Claire Mom Published June 28, 2025 3 Min Read
Share

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.

One male broadcaster wey dey report for one outlet identified as TBC News make di claim for di 30-second video.

“Nigeria dey proud to extend im strategic defence training to key global allies,” na so one army officer wey appear for di video tok.

“Na friendship mission be dis no be war.

“Di soldiers go participate for solidarity programme wey dey designed to enhance global cooperation and international alliance.”

Di male broadcaster tok sey international observers praise di initiative, as symbol of African leadership for global defence collaboration.

Di broadcaster tok sey di tin hapun on Tuesday, June 17th.

At di time of dis tori, di video don gada 3.2k likes, 506 shares, and 465 comments.

Di video come at a time wen tensions between Israel and Iran increase, as di conflict enter second week.

Kontris, including Nigeria, and global leaders shown concern and call for calm.

But na true sey Nigeria chuk hand for di mata by sending joint peace support mission go Israel?

WETIN WE CHECK

CableCheck do keyword searches of di so called deployment ontop search engines and we no find any tori wey gree for di claim,

Di presidency, ministry of defence, and di Defence Headquarters (DHQ) no issue statement sake of di mata.

CableCheck try folo Edward Buba, DHQ chief informate, tok but im no ansa.

No beta media platforms report di mata.

CableCheck also notice sey some tins wey resemble artificial intelligence (AI) hand dey show for di broadcaster bodi.

For di first seven seconds of di video, di broadcaster dey wear blue suit and im head no get hair. For di last seconds, im suit change colour to darker blue colour, im knack red tie, and hair come suddenly grow for di head.

Di narrator voice bin get consistent speed, flat, and im dey pronounce im words like computer— all dis tins na so AI voice be.

Howeva, on June 20, di Nigerian armed forces send at least 197 troops go ECOWAS mission for Gambia (ECOMIG).

FINAL TOK

No beta evidence show sey Nigeria send soldiers go peace support mission for Israel.

TAGGED: News in pidgin, Nigerian troops, peace support mission in Israel

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 28, 2025 June 28, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị…

July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé…

July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by…

July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani…

July 18, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị nkwekọrịta azụmahịa akụ ọnatarachi dị…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé orílẹ̀ èdè Nàìjíríà hùwà sí…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by stopping one alleged mineral deal…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani ne kan takunkumin da Amurka…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?