TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, ICC no issue arrest warrant for Akpabio
Share
Latest News
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?
FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?
FACT CHECK: Viral image depicting ‘Obasanjo prostrating for Ladoja’ photoshopped
Wike tụ̀rụ̀ àsị́. Peter Obi mèrè ńtụ̀líáká ọ̀chị́chị́ ḿpághárá m̀gbè ọ́ bụ̀ gọ́vánọ̀ Anambra
Irọ́ ni Wike pa. Peter Obi ṣètò ìdìbò ìjọba ìbílẹ̀ nígbà tí ó jẹ́ gómìnà Ìpínlẹ̀ Anambra
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, ICC no issue arrest warrant for Akpabio

Claire Mom
By Claire Mom Published April 5, 2025 3 Min Read
Share

One social media user claim sey di International Criminal Court (ICC) issue arrest warrant for Senate President Godswill Akpabio.

Di claim, wey comot for Facebook by @VoiceUpNaija, don gada pass 140 likes, 92 comments, and 62 shares.

Accounts for Facebook and LinkedIn folo share di claim.

“BREAKING: ICC issue international arrest warrant for Nigerian Senate President sake of sexual harassment allegations,” na so di post tok.

“Di International Criminal Court (ICC) don reportedly place Nigerian Senate President, Godswill Akpabio, for international sanctions list, ordering im immediate arrest if dem sight am for any kontri.”

Di claim follow di recent kasala between Akpabio and Natasha Akpoti-Uduaghan, senator representing Kogi central, sake of seat allocation for di upper legislative chamber.

As di tin dey hapun, di senate refer Akpoti-Uduaghan give di committee on ethics, privileges, and public petitions for disciplinary review.

On February 28, Akpoti-Uduaghan accuse di senate presido of making sexual advances towards her for im office and im house for Akwa Ibom.

Dem suspend her on March 6 sake of di seat reallocation wahala for six months.

On March 11, di Kogi senator report Akpabio give di Inter-Parliamentary Union (IPU).

NA TRUE SEY ICC ORDER ARREST WARRANT FOR AKPABIO?

ICC na global criminal court wey dem establish to investigate and prosecute individuals wey dey accused of serious crimes of concern to di international community.

To confam di claim, CableCheck look di ICC website to check weda dem publish di arrest order but di tori no dey. 

We also notice sey no beta media platform report di arrest.

Cablecheck also folo Fadi El-Abdallah, ICC chief informate, tok am, im tok sey dem no issue any arrest warrant for Akpabio or anybody from Nigeria.

El-Abdallah tok sey di ICC suppose announce di opening of any investigation for dia platform before dem issues any arrest warrant for any suspect.

“E no get any arrest warrants wey dey related to Nigeria, where di Prosecutor neva announce di opening of an investigation, necessary step before di stage of delivering arrest warrants,” El-Abdallah tell CableCheck via email.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey ICC issue arrest warrant for Akpabio no correct.

TAGGED: ICC, ICC arrest warrant for Akpabio, Natasha Akpoti-Uduaghan, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 5, 2025 April 5, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị…

July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé…

July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by…

July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani…

July 18, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị nkwekọrịta azụmahịa akụ ọnatarachi dị…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé orílẹ̀ èdè Nàìjíríà hùwà sí…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by stopping one alleged mineral deal…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani ne kan takunkumin da Amurka…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?