TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, ICC no issue arrest warrant for Akpabio
Share
Latest News
Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east
Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east
Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà
Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne
FACT CHECK: Video attributed to ‘security operatives’ breaking into apartment isn’t from south-east
FAKE NEWS ALERT: WAEC denies viral list showing schools affected by results cancellation
Ḿbà, Nwifuru àkwụ́sịghị́ ńdị́ kọ̀mị́shọnà ya ọ́rụ́ màkà nà há ábịaghị ńchètá ọ̀mụ́mụ́ nwá ya
No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, ICC no issue arrest warrant for Akpabio

Claire Mom
By Claire Mom Published April 5, 2025 3 Min Read
Share

One social media user claim sey di International Criminal Court (ICC) issue arrest warrant for Senate President Godswill Akpabio.

Di claim, wey comot for Facebook by @VoiceUpNaija, don gada pass 140 likes, 92 comments, and 62 shares.

Accounts for Facebook and LinkedIn folo share di claim.

“BREAKING: ICC issue international arrest warrant for Nigerian Senate President sake of sexual harassment allegations,” na so di post tok.

“Di International Criminal Court (ICC) don reportedly place Nigerian Senate President, Godswill Akpabio, for international sanctions list, ordering im immediate arrest if dem sight am for any kontri.”

Di claim follow di recent kasala between Akpabio and Natasha Akpoti-Uduaghan, senator representing Kogi central, sake of seat allocation for di upper legislative chamber.

As di tin dey hapun, di senate refer Akpoti-Uduaghan give di committee on ethics, privileges, and public petitions for disciplinary review.

On February 28, Akpoti-Uduaghan accuse di senate presido of making sexual advances towards her for im office and im house for Akwa Ibom.

Dem suspend her on March 6 sake of di seat reallocation wahala for six months.

On March 11, di Kogi senator report Akpabio give di Inter-Parliamentary Union (IPU).

NA TRUE SEY ICC ORDER ARREST WARRANT FOR AKPABIO?

ICC na global criminal court wey dem establish to investigate and prosecute individuals wey dey accused of serious crimes of concern to di international community.

To confam di claim, CableCheck look di ICC website to check weda dem publish di arrest order but di tori no dey. 

We also notice sey no beta media platform report di arrest.

Cablecheck also folo Fadi El-Abdallah, ICC chief informate, tok am, im tok sey dem no issue any arrest warrant for Akpabio or anybody from Nigeria.

El-Abdallah tok sey di ICC suppose announce di opening of any investigation for dia platform before dem issues any arrest warrant for any suspect.

“E no get any arrest warrants wey dey related to Nigeria, where di Prosecutor neva announce di opening of an investigation, necessary step before di stage of delivering arrest warrants,” El-Abdallah tell CableCheck via email.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey ICC issue arrest warrant for Akpabio no correct.

TAGGED: ICC, ICC arrest warrant for Akpabio, Natasha Akpoti-Uduaghan, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 5, 2025 April 5, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey…

August 7, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east

Ótù onye na Facebook ekwuola na ihe ngosị ebe mmadụ na-agbaka ụlọ obibi mmadụ mere…

August 7, 2025

Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára sọ pé fídíò…

August 7, 2025

Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa wani faifan bidiyo da ke…

August 7, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey break into residential apartment hapun…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east

Ótù onye na Facebook ekwuola na ihe ngosị ebe mmadụ na-agbaka ụlọ obibi mmadụ mere na south-east. N'ụbọchị iri abụọ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára sọ pé fídíò tí ó se afihan àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa wani faifan bidiyo da ke nuna jami’an tsaro dauke da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?