One social media user don claim sey United States missiles hit Burkina Faso, causing Ibrahim Traoré, army presido, to revenge.
Edwuadotv, one Facebook account, make di post on August 22.
“Wen US missiles strike one guard post for northern Burkina Faso, many pipu expect sey dem no go tok. But Ibrahim Traoré no fear. Instead, di young leader turn di attack into rallying cry for African resistance,”na so di post tok.
Di 15-minute video don gada 32k views, 1.3k likes, and 409 comments since e comot.
According to di pesin wey dey tell di tori, di US authorise di strike from dia military base for Niger Republic as “counterterrorism operation”.
“Two precision guided missiles strike one rural communications post. Di explosion destroy di entire signal tower, swallow di facility wit faya and kill three lives—two soldiers and one civilian technician. Seven odas collect injury,” na so di pesin wey dey tell di tori claim.
Di narrator add sey “reactions spread quickly across di continent”.
Di claim also appear for YouTube via Bright Africa, one page wit 3.5k subscribers, and don gada at least 18,359 views since dem post am on August 21.
More posts of di claim for YouTube dey here, here, and here.
But these repeated claims get head so?
WETIN WE CHECK
CableCheck conduct advanced search query ontop US strikes for Burkina Faso and notin notin important comot.
Though di narrator no specify di date of di alleged strike, CableCheck narrow di queries from August 1 to August 26, 2025, while we exclude all misinformation-related terms so dat reliability for di results go strong.
Still, no evidence or confam reports of US missile strike for Burkina Faso comot.
Dat kain mata for make headlines. One similar US strike for Iran bin make headlines all ova di world.
Also, di pesin wey dey tell di tori, wey im voice resemble artificial-intelligence (AI), claim sey di US strikes bin comot from dia military base for neighbouring Niger.
Di US no get any active military base for Niger again.
Last September, di US Department of Defense bin withdraw dia army from di Sahelian country, ending dia cooperation wit di Niger military junta.
FINAL TOK
No credible evidence to support di claims sey US strike Burkina Faso.