TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, dis viral video no show army revenge for Okuama
Share
Latest News
Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?
Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?
Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?
Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́
Tinubu speech ontop Trump tariff dey misrepresented as recent comment ontop US watchlist
Maganan Tinubu akan sharhi na baya-bayan nan akan jerin sa ido na Amurka
FACT CHECK: Did Nigerian army use old pictures for recent rescue operation?
FACT CHECK: Tinubu’s speech on Trump’s tariff misrepresented as recent comment on US watchlist
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, dis viral video no show army revenge for Okuama

Claire Mom
By Claire Mom Published March 31, 2024 3 Min Read
Share
Screenshot

One social media post claim sey officers of di Nigerian Army do revenge attack for Okuama community, Delta, afta 16 soldiers die for di state.

Na one viral video naim dem dey use as evidence of di alleged revenge.

On March 14, youths kill some army personnel —including one lieutenant colonel, two majors, one captain, and 12 soldiers — as dem go assignment for Okuama.

Di death of di soldiers cause serious anger for di kontri — togeda wit different allegations. One example of di allegation tok sey soldiers burn down di community as revenge.

“Okuama for Delta state dey burn finish dis morning sake of Nigerian Soldiers wey dey vex. Nigerian Army don declare war for dat region,” @EmekaGift100, one X user tweet as im share di video in question.

The X user tok sey im bi human rights activist and “image maker” for di Indigenous People of Biafra (IPOB), di outlawed separatist group.

Di tweet, wey comot on March 18, don gada over 97,200 views, 706 retweets, 581 likes, and 181 comments.

For di 54-second video, you fit see as fire dey burn different boats ontop water while thick smoke dey rise enta air.

“Dis kain tin good?” na so one man wey dey tok inside video just dey tok for Pidgin as explosions dey sound from di fire.

“Enof fuel dey here dey catch. Na wetin we dey face every year be dis but pipu no know, dem think sey we dey enjoy. We no dey happy o.”

According to @EmekaGift100, na di army set up di fire to burn “helpless children, women, old” alive.

Somto Okonokwo, anoda X user, make similar claim, and im add sey di military dey unfairly target southerners while dem dey protect Nigerians for north.

For di last count, di post don gada 133, 600 views, 1,400 retweets, 1,200 likes, 256 comments, and 86 bookmarks.

WETIN WE CHECK

TheCable check screenshots of di video for reverse image search see sey di same clip bin dey uploaded to TikTok for late January — nearly two months before di killing of army personnel for Delta.

Di time wen dem first post am, dem attribute di video to one fire outbreak for Nembe Waterside, one jetty for Port Harcourt, Rivers state capital.

“Anoda fire outbreak for Nembe waterside near creek road for Port Harcourt,” na so di video caption tok.

Di video folo get di same background tok and surrounding features as di same one wey dem share evriwhere for Twitter afta dem kill army personnel for Delta.

Extensive keyword search comot news reports wey show sey di video na from one January 2024 fire incident wey destroy goods and property for Rivers state.

FINAL TOK

Di video no show di burning of Okuama community for Delta state.

TAGGED: Okuama community, Okuama killings, Pidgin news

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 8, 2024 March 31, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn…

November 5, 2025

Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?

On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official…

November 5, 2025

Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?

A ranar Litinin din da ta gabata ne rundunar sojin Najeriya ta fitar da sanarwa…

November 5, 2025

Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́

Ní ọjọ́ ìsinmi, Politics Nigeria, wẹbusaiti kan fi fídíò tí kò pé ìṣẹ́jú kan síta…

November 5, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn àwòrán lórí àwọn ohun ìgbàlódé…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?

On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official social media platform to announce…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?

A ranar Litinin din da ta gabata ne rundunar sojin Najeriya ta fitar da sanarwa tare da wasu hotuna a…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́

Ní ọjọ́ ìsinmi, Politics Nigeria, wẹbusaiti kan fi fídíò tí kò pé ìṣẹ́jú kan síta lórí Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?