TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Share
Latest News
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?
FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?
FACT CHECK: Viral image depicting ‘Obasanjo prostrating for Ladoja’ photoshopped
Wike tụ̀rụ̀ àsị́. Peter Obi mèrè ńtụ̀líáká ọ̀chị́chị́ ḿpághárá m̀gbè ọ́ bụ̀ gọ́vánọ̀ Anambra
Irọ́ ni Wike pa. Peter Obi ṣètò ìdìbò ìjọba ìbílẹ̀ nígbà tí ó jẹ́ gómìnà Ìpínlẹ̀ Anambra
Wike yayi kuskure. Peter Obi ya gudanar da zaben LG a matsayin gwamnan Anambra
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 18, 2025 4 Min Read
Share

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by stopping one alleged mineral deal between di two kontris.

For di 21-minute video wey dem post on July 2, Dabreezy Comedy, one Facebook account, claim sey Nigeria do US back by blocking di deal wey involve di said mineral.

Di video don gada 102k views, 3.3k likes, and 265 comments.

Di clip begin wit one small part from Firstpost Africa, one news outlet wey dey Durban, South Africa.

Firstpost Africa claim to bring stories from across di world through di eyes of Africa.

For di first few seconds, Alyson le Grange, di news anchor, bin dey present one report wit di headline: Nigeria warn sey di US fit lose access to African minerals.

Di rest of di video bin dey accompanied by one man voice, wey claim sey Nigeria scrap di minerals deal with di US sake of di visa restrictions.

Di man voice bin sound like artificially intelligent (AI) generated tone.

WETIN HAPUN BEFORE

On June 4, US President Donald Trump sign one executive order wey knack full travel ban ontop nationals of 12 kontris.

Nationals from seven oda kontris bin collect partial travel restrictions to di US.

Di 12 countries bin include Afghanistan, Chad, Congo, Yemen, Eritrea, Haiti, Iran, Sudan, Myanmar, Somalia, Libya, and Equatorial Guinea.
Di ones wey collect heightened restrictions na Burundi, Cuba, Laos, Sierra Leone, Togo, Turkmenistan, and Venezuela.

On June 18, one leaked US state department internal memo show sey Trump bin dey consider knack anoda travel ban ontop plenti kontris, mostly from Africa, including Nigeria.

Yusuf Tuggar, Nigerian minister of foreign affairs, toc sey di decision go dey unfortunate because West Africa dey ready to do deals wit di US.

On July 8, di US announce di visa restrictions ontop Nigeria and oda kontris.

Di US bin first tok sey di decision na becos Nigeria no dey return dia visa reciprocity, but TheCable report sey na becos Nigeria no gree collect asylum seekers from di US naim folo cause di visa restrictions.

Later, di US come tok sey di decision na sake of security concerns.

WETIN WE CHECK

In response, Nigeria tok sey di decision wey di US take no resemble di principles of reciprocity, equity, and mutual respect wey suppose guide bilateral engagements between friendly nations.

Di foreign ministry urge di US to reconsider im decision in di spirit of partnership, cooperation, and shared global responsibilities.

Separately, Tuggar tok dem dey engage wit di US to clarify di issue.

Howeva, im tok sey di US bin dey pressure some kontris to receive Venezuelan deportees — some of dem be prisoners — and im stress sey Nigeria no go be dumping ground for undocumented migrants.

Keyword search of di alleged mineral deal between di US and Nigeria no produce results.

Tuggar, di foreign ministry, di office of di president, or di US embassy sey neva tok about any alleged mineral deal wey don block.

As dis kain matter dey hapun, e for dey public.

FINAL TOK

Evidence no dey to support di claim wey tok sey Nigeria stop mineral deal with di US as revenge against di imposed visa restrictions.

TAGGED: mineral deal, News in pidgin, Nigeria and US, US visa restrictions for Nigerians

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 18, 2025 July 18, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị…

July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé…

July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani…

July 18, 2025

FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?

A Facebook user has claimed that Nigeria retaliated against the recent United States visa restrictions…

July 15, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị nkwekọrịta azụmahịa akụ ọnatarachi dị…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé orílẹ̀ èdè Nàìjíríà hùwà sí…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani ne kan takunkumin da Amurka…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?

A Facebook user has claimed that Nigeria retaliated against the recent United States visa restrictions by halting an alleged mineral…

Fact Check
July 15, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?