TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Share
Latest News
Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east
Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east
Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà
Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne
FACT CHECK: Video attributed to ‘security operatives’ breaking into apartment isn’t from south-east
FAKE NEWS ALERT: WAEC denies viral list showing schools affected by results cancellation
Ḿbà, Nwifuru àkwụ́sịghị́ ńdị́ kọ̀mị́shọnà ya ọ́rụ́ màkà nà há ábịaghị ńchètá ọ̀mụ́mụ́ nwá ya
No, Nwifuru no suspend officials becos dem no gree attend im pikin birthday party
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 18, 2025 4 Min Read
Share

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by stopping one alleged mineral deal between di two kontris.

For di 21-minute video wey dem post on July 2, Dabreezy Comedy, one Facebook account, claim sey Nigeria do US back by blocking di deal wey involve di said mineral.

Di video don gada 102k views, 3.3k likes, and 265 comments.

Di clip begin wit one small part from Firstpost Africa, one news outlet wey dey Durban, South Africa.

Firstpost Africa claim to bring stories from across di world through di eyes of Africa.

For di first few seconds, Alyson le Grange, di news anchor, bin dey present one report wit di headline: Nigeria warn sey di US fit lose access to African minerals.

Di rest of di video bin dey accompanied by one man voice, wey claim sey Nigeria scrap di minerals deal with di US sake of di visa restrictions.

Di man voice bin sound like artificially intelligent (AI) generated tone.

WETIN HAPUN BEFORE

On June 4, US President Donald Trump sign one executive order wey knack full travel ban ontop nationals of 12 kontris.

Nationals from seven oda kontris bin collect partial travel restrictions to di US.

Di 12 countries bin include Afghanistan, Chad, Congo, Yemen, Eritrea, Haiti, Iran, Sudan, Myanmar, Somalia, Libya, and Equatorial Guinea.
Di ones wey collect heightened restrictions na Burundi, Cuba, Laos, Sierra Leone, Togo, Turkmenistan, and Venezuela.

On June 18, one leaked US state department internal memo show sey Trump bin dey consider knack anoda travel ban ontop plenti kontris, mostly from Africa, including Nigeria.

Yusuf Tuggar, Nigerian minister of foreign affairs, toc sey di decision go dey unfortunate because West Africa dey ready to do deals wit di US.

On July 8, di US announce di visa restrictions ontop Nigeria and oda kontris.

Di US bin first tok sey di decision na becos Nigeria no dey return dia visa reciprocity, but TheCable report sey na becos Nigeria no gree collect asylum seekers from di US naim folo cause di visa restrictions.

Later, di US come tok sey di decision na sake of security concerns.

WETIN WE CHECK

In response, Nigeria tok sey di decision wey di US take no resemble di principles of reciprocity, equity, and mutual respect wey suppose guide bilateral engagements between friendly nations.

Di foreign ministry urge di US to reconsider im decision in di spirit of partnership, cooperation, and shared global responsibilities.

Separately, Tuggar tok dem dey engage wit di US to clarify di issue.

Howeva, im tok sey di US bin dey pressure some kontris to receive Venezuelan deportees — some of dem be prisoners — and im stress sey Nigeria no go be dumping ground for undocumented migrants.

Keyword search of di alleged mineral deal between di US and Nigeria no produce results.

Tuggar, di foreign ministry, di office of di president, or di US embassy sey neva tok about any alleged mineral deal wey don block.

As dis kain matter dey hapun, e for dey public.

FINAL TOK

Evidence no dey to support di claim wey tok sey Nigeria stop mineral deal with di US as revenge against di imposed visa restrictions.

TAGGED: mineral deal, News in pidgin, Nigeria and US, US visa restrictions for Nigerians

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 18, 2025 July 18, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey…

August 7, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east

Ótù onye na Facebook ekwuola na ihe ngosị ebe mmadụ na-agbaka ụlọ obibi mmadụ mere…

August 7, 2025

Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára sọ pé fídíò…

August 7, 2025

Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa wani faifan bidiyo da ke…

August 7, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey break into residential apartment hapun…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east

Ótù onye na Facebook ekwuola na ihe ngosị ebe mmadụ na-agbaka ụlọ obibi mmadụ mere na south-east. N'ụbọchị iri abụọ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára sọ pé fídíò tí ó se afihan àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa wani faifan bidiyo da ke nuna jami’an tsaro dauke da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?