TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Nigeria be di sixth kontri for di world wit highest suicide rates?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Nigeria be di sixth kontri for di world wit highest suicide rates?

Claire Mom
By Claire Mom Published December 23, 2024 4 Min Read
Share

Adesanmi Akinsulore, one professor and consultant psychiatrist for Awolowo University and di Obafemi Awolowo University Teaching Hospital, Ile-Ife, tok sey Nigeria na nomba six among all di kontris for di world wit di highest suicide rates.

According to PUNCH, Akinsulore make di claim during lecture for one event wey The Still Waters Mental Health Foundation organise for Ladoke Akintola University of Technology Ogbomoso, Oyo state.

Im tok sey urgent need dey for collaborative efforts to address di issue, especially among students.

“One suicide dey hapun for every 25 attempts. In 2021, na suicide be di third leading cause of death among 15 to 29-year-olds around di world,” na so dem quote im tok.

“To dey address dis wahala na evribodi work. We must work togeda to create supportive and inclusive environment wey promote student well-being and resilience.”

WETIN HAPUN BEFORE 

According to di World Health Organisation (WHO), suicide dey kpai more dan 700,000 people evri year wit an estimated 20 suicide attempts for each suicide.

Di organisation tok sey suicide na di fourth leading cause of death among 15–29-year-olds (for both sexes) globally, sey 73 percent of all suicides hapun for low- and middle-income countries.

Di risk factors wey fit cause suicide include depression, alcohol use disorders, loss, loneliness, discrimination, relationship disputes, financial problems, chronic pain and illness, violence, abuse, and conflict or oda humanitarian emergencies.

Even for Nigeria, reports of suicide don comot recently.

In October, Omolayo Bamidele, one 58-year-old man, reportedly commit suicide for Igburowo town, Odigbo LGA of Ondo.

Residents of di community tok sey dem find Bamidele bodi for dusty road wit bottle of chemical substance wey dem suspect to be “Sniper” beside am.

In September, Gabriel Magaji, one 38-year-old resident of Masaka for Karu LGA of Nasarawa, commit suicide sake of alleged infidelity by im wife.

NIGERIA NA DI SIXTH KONTRI FOR DI WORLD WIT HIGHEST SUICIDE RATES?

TheCable folo Akinsulore tok but im no gree share di place where im see di informate wey im use make di claim.

Howeva, di CableCheck discover sey according to WHO informate on suicide mortality rate wey di organisation  last update on January 8, 2024, Nigeria bin rank 157th for di list wit 3.5 suicides per 100,000 people.

Di top 10 kontris by ranking na Lesotho (72.4 suicides per 100,000 pipu), Guyana (40.3 suicides per 100,000 pipu), Eswatini (29.4 suicides per 100,000 pipu), Republic of Korea (28.6 suicides per 100,000 pipu), Kiribati (28.3 suicides per 100,000 pipu), and Micronesia (28.2 suicides per 100,000 pipu).

Odas na Lithuania (26.1 suicides per 100,000 pipu), Suriname (25.4 suicides per 100,000 pipu), Russian Federation (25.1 suicides per 100,000 pipu), and South Africa (23.5 suicides per 100,000 pipu).

Dis informate show sey na Micronesia be di sixth kontri for di world wit di highest suicide rates.

FINAL TOK

Nigeria no be di sixth kontri for di world wit di highest suicide rates.

TAGGED: News in pidgin, nigeria, Suicide

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 23, 2024 December 23, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?