TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Nigeria be di sixth kontri for di world wit highest suicide rates?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video wey show sey gunmen bin seize armoured vehicles na for Burkina Faso — NO BE Nigeria
FACT CHECK: Video showing people using ropes to cross river NOT from Nigeria
Burkina Faso ni ìṣẹ̀lẹ̀ nínú fídíò tó sàfihàn àwọn agbébọn pẹ̀lú ọkọ̀ ogun jíjà ti ṣẹlẹ̀ — kìí se Nàìjíríà
Íhé ńgósị́ ébé ndị́ ómékómè nà-éwèghárá ụ́gbọ́àlà ndị́ ághá sì Burkina Faso
Bidiyon da ke nuna yan ta’adda na kwace motoci masu sulke daga Burkina Faso – BA Najeriya ba
FACT CHECK: Video showing gunmen seizing armoured vehicle from Burkina Faso — NOT Nigeria
Viral post wey claim sey dem don pass ‘Cybercrimes Act 2025’ no correct
Ózí na-ekwu nà é mepụ̀tálá ìwú megidere cybercrime bụ̀ àsị́
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Nigeria be di sixth kontri for di world wit highest suicide rates?

Claire Mom
By Claire Mom Published December 23, 2024 4 Min Read
Share

Adesanmi Akinsulore, one professor and consultant psychiatrist for Awolowo University and di Obafemi Awolowo University Teaching Hospital, Ile-Ife, tok sey Nigeria na nomba six among all di kontris for di world wit di highest suicide rates.

According to PUNCH, Akinsulore make di claim during lecture for one event wey The Still Waters Mental Health Foundation organise for Ladoke Akintola University of Technology Ogbomoso, Oyo state.

Im tok sey urgent need dey for collaborative efforts to address di issue, especially among students.

“One suicide dey hapun for every 25 attempts. In 2021, na suicide be di third leading cause of death among 15 to 29-year-olds around di world,” na so dem quote im tok.

“To dey address dis wahala na evribodi work. We must work togeda to create supportive and inclusive environment wey promote student well-being and resilience.”

WETIN HAPUN BEFORE 

According to di World Health Organisation (WHO), suicide dey kpai more dan 700,000 people evri year wit an estimated 20 suicide attempts for each suicide.

Di organisation tok sey suicide na di fourth leading cause of death among 15–29-year-olds (for both sexes) globally, sey 73 percent of all suicides hapun for low- and middle-income countries.

Di risk factors wey fit cause suicide include depression, alcohol use disorders, loss, loneliness, discrimination, relationship disputes, financial problems, chronic pain and illness, violence, abuse, and conflict or oda humanitarian emergencies.

Even for Nigeria, reports of suicide don comot recently.

In October, Omolayo Bamidele, one 58-year-old man, reportedly commit suicide for Igburowo town, Odigbo LGA of Ondo.

Residents of di community tok sey dem find Bamidele bodi for dusty road wit bottle of chemical substance wey dem suspect to be “Sniper” beside am.

In September, Gabriel Magaji, one 38-year-old resident of Masaka for Karu LGA of Nasarawa, commit suicide sake of alleged infidelity by im wife.

NIGERIA NA DI SIXTH KONTRI FOR DI WORLD WIT HIGHEST SUICIDE RATES?

TheCable folo Akinsulore tok but im no gree share di place where im see di informate wey im use make di claim.

Howeva, di CableCheck discover sey according to WHO informate on suicide mortality rate wey di organisation  last update on January 8, 2024, Nigeria bin rank 157th for di list wit 3.5 suicides per 100,000 people.

Di top 10 kontris by ranking na Lesotho (72.4 suicides per 100,000 pipu), Guyana (40.3 suicides per 100,000 pipu), Eswatini (29.4 suicides per 100,000 pipu), Republic of Korea (28.6 suicides per 100,000 pipu), Kiribati (28.3 suicides per 100,000 pipu), and Micronesia (28.2 suicides per 100,000 pipu).

Odas na Lithuania (26.1 suicides per 100,000 pipu), Suriname (25.4 suicides per 100,000 pipu), Russian Federation (25.1 suicides per 100,000 pipu), and South Africa (23.5 suicides per 100,000 pipu).

Dis informate show sey na Micronesia be di sixth kontri for di world wit di highest suicide rates.

FINAL TOK

Nigeria no be di sixth kontri for di world wit di highest suicide rates.

TAGGED: News in pidgin, nigeria, Suicide

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 23, 2024 December 23, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video wey show sey gunmen bin seize armoured vehicles na for Burkina Faso — NO BE Nigeria

Some pesin for social media don dey put Naija name on top one video wey…

September 3, 2025

FACT CHECK: Video showing people using ropes to cross river NOT from Nigeria

On August 9, a Facebook user identified as Asare Obed posted a video showing people…

September 3, 2025

Burkina Faso ni ìṣẹ̀lẹ̀ nínú fídíò tó sàfihàn àwọn agbébọn pẹ̀lú ọkọ̀ ogun jíjà ti ṣẹlẹ̀ — kìí se Nàìjíríà

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo ohun íbaraẹnise orí ayélujára tí sọ pé fidio…

September 2, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ndị́ ómékómè nà-éwèghárá ụ́gbọ́àlà ndị́ ághá sì Burkina Faso

Ótù ihe ngosi ebe ndị ojiegbe egbu na-ákụ̀rụ́ ụgbọala ndị agha bụ nke ndị ji…

September 2, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

FACT CHECK: Video wey show sey gunmen bin seize armoured vehicles na for Burkina Faso — NO BE Nigeria

Some pesin for social media don dey put Naija name on top one video wey show some men wey mount…

CHECK AM FOR WAZOBIA
September 3, 2025

FACT CHECK: Video showing people using ropes to cross river NOT from Nigeria

On August 9, a Facebook user identified as Asare Obed posted a video showing people using ropes to cross a…

Fact Check
September 3, 2025

Burkina Faso ni ìṣẹ̀lẹ̀ nínú fídíò tó sàfihàn àwọn agbébọn pẹ̀lú ọkọ̀ ogun jíjà ti ṣẹlẹ̀ — kìí se Nàìjíríà

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo ohun íbaraẹnise orí ayélujára tí sọ pé fidio kan tí ó sàfihàn àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
September 2, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ndị́ ómékómè nà-éwèghárá ụ́gbọ́àlà ndị́ ághá sì Burkina Faso

Ótù ihe ngosi ebe ndị ojiegbe egbu na-ákụ̀rụ́ ụgbọala ndị agha bụ nke ndị ji soshal midia ebipụta ozi sịrị…

CHECK AM FOR WAZOBIA
September 2, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?